Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Explain Why Im Sign Di New Electoral Act

Wi Oga Presido Bola Tinubu don describe imself as “die-hard democrat” as e urge Nigerian politicians make dem respect democratic values and obey rule of law no matter di cost. Tinubu talk dis one on Wednesday for interfaith breakfast wey happen for State House with executives of All Progressives Congress (APC), members of di National Working Committee and Inter-Party Advisory Council (IPAC). According to di president, im and some other […]

todayMarch 12, 2026 15

Sports

Quadri Aruna Remain Winless As Félix Lebrun Beat Am 3–0 For WTT

Nigeria table tennis star, Quadri Aruna, never fit win any WTT match 2026, again don go lose 3–0 to France player Félix Lebrun for WTT Champions Chongqing on Tuesday. Lebrun, wey dey 19 years old, hammer Aruna 11–5, 11–6, 11–3 for round of 32. Dis one make Aruna still dey wait for im first WTT win since September 2025, wen e beat China player Huang Youzheng. Na dia fourth time […]

todayMarch 11, 2026 17 1

Uncategorized

Naija Clubs To Collect N559m Each As CAF Raise Prize Money

Say Four Naija clubs, Rivers United, Remo Stars, Kwara United, and Abia Warriors, wey  play for dis season CAF Champions League and Confederation Cup go collect N559m each from CAF. CAF Presido, Dr Patrice Motsepe, don raise prize money for both competitions. Champions League winners go chop $6m now, while Confederation Cup winners go get $4m. Even clubs wey comot for early stages go still collect $100,000, so Naija clubs […]

todayMarch 11, 2026 11

Sports

Galatasaray Beat Liverpool 1 kondo For UCL

Victor Osimhen give correct assist as Galatasaray knack Liverpool 1-0 for RAMs Park on Tuesday night champions league. Im deliver beta pass give Gabonish,  Mario Lemina, to score di only goal for di seventh minute. Dis na Osimhen third assist for dis UEFA Champions League season, with seven goals.

todayMarch 11, 2026 11

obodo oyinbo

Qatar Say Make Iran and US Settle Marras

Qatar foreign minister Mohammed bin Abdulaziz al-Khulaifi tok for Doha say make Middle East calm down and say Iran and US suppose reason and settle demselves soon. Di minister say Iran attacking dia neighbours nor get any good, say e dey pain dem but dem gat reply U.S. Iran fire missile and drone after US and Israel bombard dem for almost two weeks, wey cause kasala and damage important place […]

todayMarch 11, 2026 11

obodo oyinbo

Israel Fire Hezbollah, Iran Fire Back; US Sink Iranian Ship

Israel don fire more missile for Lebanon and Iran on Tuesday, di Israeli military talk say dem dey target Hezbollah base for south Beirut. Iran reply with missile strike against Israel and US base for Middle East, officials say na revenge. However, Israel PM Benjamin Netanyahu give update for  X, telling pipo of Iran to remove Ayatollah regime to remove Islam for dia politics to gain freedom, as dem dey […]

todayMarch 11, 2026 6

obodo oyinbo

Iran Show Report Card say , Israel, US Dey Strike, Civilians

Big kaboom dey hapun for Tehran as Iran show report card, say US and Israeli forces don attack almost 10,000 civilian places, kpai more than 1,300 people since  di war start 11 days ago. US military tuk say dem don destroy 16 old Iranian mine ships after President Donald Trump warn say di worse go hapun if Iran stop  oil flow for Strait of Hormuz. Hezbollah and Israeli soldiers still […]

todayMarch 11, 2026 8 1

OBODO NAIJA

Interior And Information Ministries Join To Promote New Government Reforms.

Federal Ministry of Interior don join hand with Federal Ministry of Information and National Orientation to make sure say Nigerians understand di new gornment reforms on passport service, border security, identity management and national safety. Dis discussion hapun when Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, carry high-level delegation visit di Ministry of Interior for Abuja, where Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo welcome am. Tunji-Ojo  say, strong communication between […]

todayMarch 11, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Launch Ogbonge Project To Boost Food Security

Wi Federal Gornment don launch new project wey dem call Sustainable Power and Irrigation for Nigeria, SPIN, to hellep steady farming and food production. Di project get support from World Bank with about $500 million financing to improve farming and boost food security. Minister of Water Resources and Sanitation, Joseph Utsev,  na im carry dis mata dey tuk for di flag of for Abuja, say di project go strengthen food […]

todayMarch 11, 2026 7

OBODO NAIJA

INEC, Air Force Join Hands For Safe And Smooth 2027 Election

Chairmo of  di Independent National Electoral Commission, INEC, Professor Joash Amupitan, say di commission go need continue to work together with Nigerian Air Force to make sure say election for 2027 and future ones dey free, safe and well organized. Amupitan tuk dis one when Chief of di Air Staff, Air Marshal Sunday Aneke, visit di commission headquarters for Abuja with im delegation. According to am, di visit na to […]

todayMarch 11, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app