Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Give ICPC 30 Days To Investigate Fake PFIPC

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don order Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission, wey dem dey call ICPC, say make dem touch light every as e take concernĀ  Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) and di ogbonge agency wey don dey cause jogolo for weeks now. Presido say make ICPC finish di investigation and submit full report give am within 30 days. According to Special […]

todayJuly 8, 2026 12 1

Lagos

Federal Gornment To Scatta Tins To Build Gutters For Lagos Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters. Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say,Ā  dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes. He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause […]

todayJuly 8, 2026 11 1

Articles

KONFAM FM DO JOINBODY COLLABO WITH MINISTRY OF HOUSING

One ogbonge proverb yarn say, House wey dem no finish, fit become hideout for wahala or Jaguda boys" and na di same message Lagos State Ministry of Housing carry come today as Konfam FM 89.5 pay dem courtesy visit for Alausa, Ikeja. For di meeting, di permanent secetary of di ministry Engr. Abdulhafis Gbolahan Toriola call on Konfam FM make e join hand with government to educate Lagos residents on […]

todayJuly 7, 2026 17

Local

Delta Commissioner of Police Punish Two Police Officers

By: Yusuf Abuh Two police officers don chop beta koboko for Delta State, don lose dia rank after dem find dem guilty of extortion and other misconduct ontop one viral video. For di viral video di police dey collect kpaje with POS from motorist through POS Delta Police tuk, tuk, SP Bright Edafe, konfam dis development say Commissioner of Police, CP Yemi Oyeniyi, approve di punishment after orderly room trial. […]

todayJuly 7, 2026 10

Sport Yarns

CAF Confirm Rangers, Rivers United for Champions League Qualifier

By : Jolayemi Olajide Confederation of African Football (CAF) don confirm say Enugu Rangers and Rivers United go represent Nigeria for di qualifying rounds of di 2026/27 CAF Champions League. According to di list wey CAF release on Monday, 24 clubs from 12 African countries go compete, with each country providing two teams. Defending champions Mamelodi Sundowns of South Africa, Zamalek, Pyramids, TP Mazembe, Orlando Pirates, Esperance and oda top […]

todayJuly 7, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Warn Trump Say Dem No Go Reach Agreement If Threat Continue

By : Jolayemi Olajide Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don warn Donald Trump say if dem continue dia threat, dem go stop peace talks. Im tuk dis one give tori pipo on Monday, after report say, Trump America Ā dey plan force di peace Ā agreement with Iran. Iran dey insist say, nor be everything dem go use force, but if US insit dem go give dem hot, hot.

todayJuly 7, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Wan Bring back more Nigerians Back from South Africa Over Xenophobic AttackĀ 

By : Jolayemi Olajide Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week. Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month. She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay […]

todayJuly 7, 2026 11

Lagos

Lagos Police Burst one jaguda boys Ama, gbabĀ 150 Suspects

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police Ā command ehn, don do dia normal James Born doings Ā gbab 150 suspectedĀ  jaguda boys, say dem lap di Ā ama wey dey inside dumpsite for Boolar area near Okofilling Bus Stop, Igando. Na police oga Tijani Fatai naim use im yamchop mouth konfamate this mata for police headquartersĀ  for im monthly tuk, tuk doings. Di senior man Police oga ehn,Ā  konfam oh, say during […]

todayJuly 7, 2026 11

Lagos

Sanwo-Olu, Umahi do monitoring Spirit for Lagos-Calabar Coastal Road, explain di flood mata

By : Jolayemi Olajide Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, and wi Minister of Works, David Umahi, do small ibeji movings porporlyĀ  all di social media post aboutĀ  Lagos-Calabar Coastal Road, say nor be di road di cause flood anything. Di Two both of demĀ  tuk dis one when Umahi and some members of the National Assembly visit di govo. Sanwo-Olu welcome ogaĀ  minister and di lawmakers, and praise di Federal […]

todayJuly 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds