Blog sidebar

Background

Sport Yarns

Tobi Amusan Finish Third For Shanghai Diamond League Hurdles

By: Esther Ayoola Nigerian world record holder, Tobi Amusan, don sti go finish third for women 100m hurdles as 2026 Diamond League season open for Shanghai on Saturday. Amusan, wey just win gold for African Senior Athletics Championships for Ghana few days before, run season best of 12.41s. Di race na Olympic champion Masai Russell from USA win am, with meeting record time of 12.25s, while Bahamian athlete Devynne Charlton […]

todayMay 18, 2026 7

Sport Yarns

Lookman Shine Again, As Atlético Madrid Beat Girona 1-0

By: Esther Ayoola Super eagles’ striker, Ademola Lookman, ogbonge  goal naim Atlético Madrid  take beat Girona 1-0 for Metropolitano Stadium on Sunday. Antoine Griezmann naim give am assist, and Lookman fire di ball enter net for di 21st minute of di game. Dem replace am for second half with Clément Lenglet inside 63rd minute. So far, di Naija star don score 4 goals for 11 league matches under Diego Simeone.

todayMay 18, 2026 7

obodo oyinbo

Trump Warn Iran Say “Clock Dey Tick” As Peace Tuk For Israel, Iran Jam Rock

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don warn Iran, say, time dey run out, as tuks to end di war jam rock. Im drop dis message for Truth Social, say if dem no hurry, dem go finish iran and dat “time dey very important.” Di message come as e meet Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu on Sunday, while tension sti dey high between Israel and Iran.

todayMay 18, 2026 9

obodo oyinbo

How Israeli Attack For Gaza Kpai 8 Pipo, Kpai Community Kitchen Workers

By: Esther Ayoola Say nor be small tin sup For Gaza on Sunday, dat Israeli attack kpai at least eight Palestinians, including three pipo wey dey work for community kitchen for Deir el-Balah. Reports tuk say di attack for Deir el-Balah, target di community kitchen workers. Hamas react say, di attack na war crime and dem accuse Israel say dem dey target civilians and groups. According to Gaza Health Ministry, […]

todayMay 18, 2026 6

National

SERAP Call INEC To Sharply Investigate APC Governors Election Funds

By: Esther Ayoola One Ogbonge human right group, Socio-Economic Rights and Accountability Project, SERAP, like dis don wire INEC Chairmo, Prof Joash Amupitan, to sharply touch light di mata of some APC governors diverting around N800 billion for political campaign. Dis one dey Inside one letter wey SERAP Deputy Director, Kolawole Oluwadare, sign, wey dem release to news pipo on Sunday. Di organization tell INEC say, dem gat force di […]

todayMay 18, 2026 6

National

Senate Promise To Fast Track State Police Creation

By: Esther Ayoola Senate don condemn di abduction of 87 students and teachers wey happen for Borno and Oyo states within 24 hours. Senate Leader Opeyemi Bamidele yarn dis one for statement wey im media office release on Sunday, say like dis Naija need strong and coordinated security to protect school childresis E tuk say di recent kidnappings show why Naija need state police quick, as National Assembly don already […]

todayMay 18, 2026 8

National

PRP Tuk Why Obi, Kwankwaso Join NDC

By: Esther Ayoola Pipos Redemption Party (PRP) don explain why, Peter Obi and Rabiu Kwankwaso no join dem, say na based on say dem nor guarantee dem presidential ticket. PRP chairmo, Hakeem Baba-Ahmed naim do explanation for TV sit down tuk, say INEC delaying dia national executive approval sef, join di badness. Obi and Kwankwaso, wey be Labour Party and NNPP 2023 presidential candidates, sha later join Naija Democratic Congress […]

todayMay 18, 2026 8

National

Atiku Drag Tinubu Gorment Say Dia Response To South Africa Xenophobia To Slow

By: Esther Ayoola Former Vice presido, Atiku Abubakar don drag wi oga presido Bola Tinubu, once again, say im nor dey try at all, di way im take respond to di news of xenophobic tension for South Africa. According to Statement from Atiku, Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, baba Seyi and im response team too slow, telling, say make dem go learn from Ghana E tuk say, […]

todayMay 18, 2026 8

south west

IGP Order Heavy Security For Oyo Forest Afta Deadly Attack

By: Esther Ayoola Senior man IGP, Olatunji Disu don order make police deploy more tactical team to guide Oriire Local Government Area, Oyo State, afta deadly attack and kidnapping wey hapun around nearby forest areas. Di incident hapun early hours of Friday, 15 May 2026 for Oriire area. Police tuk, tuk, DCP Anthony Placid, tuk say di IGP give di order during im personal visit to Oyo State because of […]

todayMay 18, 2026 10

National

Makinde PDP Branch To Screen Over 3,000 Aspirants For 2027, General Elections

By: Esther Ayoola Say confusion gadima for Oyo State, as Pipos Democratic Party (PDP) , di branch of  Oyo State Govo, Seyi Makinde,  drop update say dem wan screen 3,181 pipo wey wan run for different position for di 2027 general elections. Di Oyo state govo put dis one for Inside statement wey dem release for X on Sunday. Say, out of all di pipo wey register, 2,122 dey go […]

todayMay 18, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds