Blog sidebar

Background

Politics

Toyin Abraham Says Politics No Be Her Mata

By: Kofoworola Olayinka Nollywood actress Toyin Abraham don reject the report say dem put her name for Lagos APC Campaign Council ahead of di 2027 election, saying she no dey involve for any campaign council. Abraham, wey dem reportedly list under Entertainment and Creative Economy Directorate, make di clarification for her Instagram Story and tell di public make dem disregard di report. Di actress say she dey stay away from politics, despite […]

todaySeptember 18, 2026 14

metro

Speedboat Sink for Ibaka, Police Rescue Two

By: Kofoworola Olayinka One speedboat don sink for Ibaka waterways, Mbo Local Gorment Area of Akwa Ibom State, on Thursday, September 18, 2026, as police rescue two pipu wey dey inside di boat. Di blue W23 speedboat, wey dem mark LET’S PRAY, dey travel from Oron go Cameroon with goods around 1:30 p.m. on Thursday, when di boat run into trouble for water. Akwa Ibom State Police tok-tok person, DSP […]

todaySeptember 18, 2026 11

Politics

Odii Promise To Fix Ebonyi Key Sectors

By: Kofoworola Olayinka PDP gofnorship candidate for Ebonyi State for di February 6, 2027 election, Dr Ifeanyi Odii, don promise say if e win, e go fix di state health, education and farming sectors. Odii tok say Ebonyi na pipu own, so pipu suppose get strong voice for how dem dey run di state, as e question why na only few pipu go dey decide wetin go happun to over […]

todaySeptember 18, 2026 12

Sports

Osimhen Surprise Inclusion for Super Eagles AFCON Qualifiers

By: Mariam Ajayi Super Eagles head coach, Éric Chelle, don shock plenty football fans as e include injured Victor Osimhen for Naija squad wey go play 2027 AFCON qualifiers. Osimhen don dey out since September 4 after e pick groin injury during Galatasaray match. Even with the injury, Chelle still call am up as Super Eagles prepare to face Madagascar for Uyo on September 25 and Guinea-Bissau on September 29. […]

todaySeptember 18, 2026 15 2

OBODO NAIJA

Police Beg Naija People Make Dem No Attack Policemen

By: Mariam Ajayi Cross River State Police Command don beg Nigerians make dem respect police officers wey dey do dem lawful duty. Police PPRO, ASP Sunday Eitokpah, tuk say police uniform na symbol of public authority, but pipo dey inside the uniform too. Dem dey risk dia lives every day to answer emergency calls, prevent crime, protect lives and property, and maintain peace. E warn say assault, block or resist […]

todaySeptember 18, 2026 18

OBODO NAIJA

RMAFC Reopen Oil Well Check Over 13% Benefit Mata

By: Mariam Ajayi RMAFC don reopen verification of disputed and newly drilled oil and gas wells across Naija, as oil producing states dey argue over 13 per cent benefit fund. RMAFC Chairman Mohammed Bello Shehu tuk say dem don drop di old report after states raise complaints, so new team go check well locations, maps and boundaries from 2017 reach now. Officials from RMAFC, NUPRC, National Boundary Commission and Surveyor-General […]

todaySeptember 18, 2026 12

OBODO NAIJA

Esan West Boss Tell Drivers Wear APC Cap Or Face Palava

By: Mariam Ajayi Chairman of Esan West Local Government for Edo State, Blessing Ebhodaghe, don order commercial drivers make dem wear APC-branded cap or face sanction. Ebhodaghe give di warning when e visit motor park, say di order na to support Governor Monday Okpebholo plan to help Presido Bola Tinubu secure 2.5 million votes for 2027 election. E warn drivers make dem nor wear another political party cap, say anybody […]

todaySeptember 18, 2026 12

OBODO NAIJA

NSCDC Order Probe Into Kpai Of Illegal Miners For Niger

By: Kofoworola Olayinka Naija Security and Civil Defence Corps don order investigation into di kpai of some people wey dem arrest for illegal mining operation for Niger State on September 15 and 16. NSCDC spokesman, ACC Babawale Afolabi, say dem arrest di people for M.I. Wushishi/Lukoto axis. Commandant General, Prof Ahmed Abubakar Audi, don set up special team to find out wetin really cause di kpai, including how dem dey […]

todaySeptember 18, 2026 6

OBODO NAIJA

Tinubu Fit Settle Wike, APC Gov Palava For France

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu fit intervene for di growing wahala between some All Progressives Congress governors and FCT Minister Nyesom Wike ahead of di 2027 elections. One senior presidential aide talk say Tinubu dey expected to bring di two sides together to settle dia differences. Di aide say di meeting fit happen for abroad before di end of di week, as Tinubu dey currently on vacation for France. […]

todaySeptember 18, 2026 9

Sports

Isak Say E Easy To Choose Liverpool

By: Mariam Ajayi Liverpool striker Alexander Isak say e no hard for am to choose Liverpool, even though e get wahala as e comot from Newcastle United. The Sweden player join Liverpool for September 2025 transfer deadline day for British-record £125 million. Isak tell BBC Sport for Friday say Liverpool big name, ambition and how dem fight to sign am make e know say na di right move. He say, […]

todaySeptember 18, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds