Blog sidebar

Background

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and […]

todayDecember 2, 2025 12

National

Tinubu Pick Ex-Cds Musa As New Defence Minister After Badaru Quit

By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don drop fresh nomination as e pick former Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, to take over Defence Ministry after Mohammed Badaru step down on Monday. Na through letter wey presdo send give Senate Presdo Godswill Akpabio for Abuja, dem take announce di new pick and confirm say Musa na di man to run Defence waka next. General Musa,wey be 58 years old, […]

todayDecember 2, 2025 31 1

National

Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops

Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat […]

todayDecember 2, 2025 15

Entertainment

PORTABLE VEX – DRAG JUMA JUX FOR SECRET NAIJA COLLABO!

By: Alice Iduh Portable don fire shot for social media as e call out Tanzanian singer Juma Jux for enter Naija coded and drop song with Ekunrawo without even hail am. Na for him Instagram page, the controversial street singer para troway, demand say dem must create space for am on the new track “Halima.” Portable talk say Juma Jux sneak enter the country and e no dey okay say […]

todayDecember 2, 2025 16

Business

Minister Keyamo: Aviation Tax Removal No Be My Decision Alone

By: Esther Ayoola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, talk say to remove tax for aviation sector no be wetin one person fit decide. E yarn say any policy like that need government collective approval and go through legislative review. Keyamo yarn this one for Abuja on Monday as dem dey celebrate 100 years of aviation for Nigeria. E clear say, even though industry dey complain say too […]

todayDecember 2, 2025 17

Lagos

Man Don Jailed 21 Months For Stealing N50 Million Under Fake Pretence

By: Esther Ayoola For stealing and collecting money under false pretence, Justice Rahman Oshodi of Lagos Special Offences Court for Ikeja don find Chukwudole Chinedu guilty and sentence am to 21 months plus 18 days. EFCC charge am say e collect N50 million from Ezeh Paul Chukwudi, dey tell am say e get $70,000 to sell at N720, wey no true. Chinedu bin face two counts wey concern obtaining money […]

todayDecember 2, 2025 13

Lagos

Six Lagos Real Estate Marketers Don Kidnapped For Ogun State

By: Esther Ayoola Some jaguda boys again don gbab six real estate marketers for Lagos, while dem dey go inspect their company land for Oyebola village, Obafemi-Owode Local Government Area, Ogun State. Tori people carry say the victims waka go the land for inspection before the attackers strike. Police Commissioner, Lanre Ogunlow sef, don confirmate the development give news wakawaka that the incident happen on Friday.  And that like this […]

todayDecember 2, 2025 11

National

Oluremi Tinubu Don Share 10,000 Sanitary Pads Give Jigawa School Girls

By: Esther Ayoola Oga presido wife, Lolo Oluremi Tinubu, don share 10,000 sanitary pads give girl students for Jigawa State. Di gesture come at di time wey stakeholders and UNICEF dey shout make girls take care of themselves during menstruation. According to aproko, this move dey twin with Jigawa State Government ongoing support for women health, as dem dey join hand fight poverty for di region. As she dey talk […]

todayDecember 2, 2025 9

National

Tinubu Aide Abubakar Resigns on Health Grounds, President Accepts Letter

By: Esther Ayoola Minister of Defence, Mohammed Badaru, don resign from him post with immediate effect, say e no do again and that him no dey feel fine. E write letter give President Tinubu wey carry the resignation and e date am December 1. Special Adviser to the President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, yan this one to TV sidon talk on Monday. Presidential spokesman talk say Abubakar resign […]

todayDecember 2, 2025 17

Entertainment

Kaka Igbokwe Confirms 2Baba’s London Arrest After Airport Clash With Wife

By: Esther Ayoola Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true. Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance […]

todayDecember 2, 2025 44

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds