Oyo State Police Command don gbab one 23-year-old guy wey dem catch with pikin head for Ibadan.
Police tuk tuk , Ayanlade Olayinka, yarn on Sunday say di matter happen on Saturday, April 11, for Adigun Village, Olorunda Ogunsola area inside Ona-Ara Local Government Area.
According to am, police move sharp-sharp after dem receive informate say some pipo kpai one small girl con cut her head.
Olayinka talk say dem allegedly see di head for hand of one Sodiq Akorede for Olorunda Ogunsola area, and police quickly arrest am.