Blog sidebar

Background

International

TikTok Lock Night LIVE For Naija

By: Rilwan Agbomeji TikTok don announce say dem go block Nigerians to dey use  LIVE late-night as from Sunday midnight, and na part of one serious safety investigation wey dem dey run. Plenty creators see in-app notice wey tell dem sharp-sharp say from 11pm reach 5am, LIVE don waka disappear and anybody wey try enter go just meet “No Access.” Di move shock users because even LIVE shows from other […]

todayDecember 8, 2025 12

Sports

Guardiola Ginger Im Boys To Stay Gallant Against Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Pep Guardiola don warn im Man City boys ahead of Wednesday Champions League clash with Real Madrid, say Bernabeu no be playground. E talk dis one afta City beat Sunderland 3–0 for Premier League, remind everybody say Madrid no be team you dey joke with. Even though Madrid just chop 2–0 to Celta Vigo, Guardiola yarn say Bernabeu fit humble any big team wey no shine eye. […]

todayDecember 8, 2025 6

National

Tinubu Wife Remi Warn Say She Fit Off Gov Adeleke Mic As Im Dey Sing

Nigerian First Lady Oluremi Tinubu don threaten to off Gov Adeleke mic as im dey sing for her installation as Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua on Sunday. Video wey trend show say Adeleke dey sing worship songs while dey give speech, but Remi waka go stage warn am make e stop or she go cut mic. She mouth say, I give you five minutes to conclude your speech, enough with […]

todayDecember 8, 2025 39

National

Court Reject Nnamdi Kanu Plan To Comot Sokoto Prison

Federal High Court Abuja on Monday block Nnamdi Kanu ex-parte request to move am from Sokoto prison go another centre. Kanu, wey dey serve terrorism conviction, say e want shift go Suleja or Keffi so e fit follow up im appeal well well. But Justice James Omotosho talk say dis kain request no fit pass without hearing from Federal Goment and Correctional Service. Di judge order say make dem get […]

todayDecember 8, 2025 10

National

Federal Goment Release N50m Free Money Package For Tertiary Students

Federal Goment don open ground for Abuja on Monday as dem launch one N50m Student Venture Capital Grant wey go ginger innovation, research and entrepreneurship for all for all tertiary schools across Naija. Education Minister Dr. Tunji Alausa talk say dis S-VCG no be any normal grant at all, na big national investment wey align with Tinubu Renewed Hope Agenda, and e go fish sharp brain ideas from campus, boost […]

todayDecember 8, 2025 8

National

Jaguda Boys Enter Church With Bad Character Kill Priest Wife For Anambra

By: Esther Ayoola Some armed Jaguda boys, based on rugged movement, don carry their bad character enter St. Andrews Anglican Church for Isiokwe, Lilu, Ihiala, Anambra State early Sunday, burn priest house and  kill two people. According to Eye wey see,   one of di persons wey kpai, na di wife of di priest, as them scatter  vehicles and properties scatter for the church compound. Di whole wahala happen early Sunday,  […]

todayDecember 8, 2025 5

National

Oga Presido Tinubu, Macron Align Marras On Naija Security

By: Rilwan Agbomeji Presido Tinubu and France oga patapata, Emmanuel Macron don reason for phone on Sunday on top di security gbege wey dey shake Naija. Di phone call happen for di same time when one US delegation and dia big big officials land Abuja go meet Nuhu Ribadu to reason di tori on top Christian persecution and killings.  Macron later yarn for X say France ready to stand gidigba […]

todayDecember 8, 2025 13

National

President Tinubu Salute Naija Army For Protecting Democracy

By: Alice Iduh Wi Oga Presido Bola Tinubu,  based on doings don cut cap  for  Nigeria armed forces for di way dem rush  help Republic of Benin stop coup wey scarra the country Sunday. According to di President, wey him talk through him Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, di military restore democracy after di coup plotters capture National TV and one military camp. Tinubu yan say di forces […]

todayDecember 8, 2025 10

Sports

Neymar Lead Santos To Big 3–0 Win As Dem Escape Relegation.

By: Alice Iduh Santos don pull off one big miracle escape, as dem beat third-place Cruzeiro 3–0 for the last match to hold their spot for Serie A. Neymar, wey dey emotional and still dey feel pain, still show up when e matter pass. Di 33-year-old wey just come back from long knee injury na him lead di team comeback for di end of di season.

todayDecember 8, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app