Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Northern Elders cut chain For Tinubu, say make im do state of emergency

By : Jolayemi Olajide Northern elders under NEF banner don cut chain dey drag we oga Presido, Bola Tinubu body say make im declare national security emergency before everyia scarra. Di group tuk, tuk, Abubakar Jiddere, naim drop one hot statement about security mata for inside country, say e red. According to Abubakar everybody dey shake because wetin dis jaguda boys dey do. NEF make am clear say no country […]

todayJune 10, 2026 11

Sport Yarns

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome, Vow 2030 Come Back

By : Shalom Ovie Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite the rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more than […]

todayJune 10, 2026 14

obodo oyinbo

Gunmen Kpai 12 For south africa, Police Launch Investigation

By : Shalom Ovie Nor be small jogolo for south Africa, say Twelve pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter  different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi,  say di suspects escape, while investigators begin touch light  wetin really play for di area.

todayJune 10, 2026 10

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo Go Corner dey Demand N5bn

By : Shalom Ovie Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public. According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra […]

todayJune 10, 2026 14

south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

By : Shalom Ovie Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live […]

todayJune 10, 2026 9

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Blow Whistle On Top Peter Obi Head

Popular Nollywoord Actor, Kenneth Okonkwo don come out clear marras say, he get duty to report any crime against di state wey come to him knowledge and that South-East pipo don too suffer. He yarn dis one for him X social media page on Wednesday say, no person suppose still dey take dem or any Nigerian citizen play or carry out wayo wayo without challenge. He say, Obunike na just […]

todayJune 10, 2026 17 2

Economics

IMF Raise Alarm Say Nigeria External Debt Fit Reach $72.6bn Before 2027 Election

International Monetary Fund (IMF) don warn say Nigeria public external debt fit jump by over $20 billion reach $72.6 billion by 2027. Dem talk say election year spending pressure fit make borrowing even worse. For dia 2026 Article IV report wey dem release on Tuesday, IMF show say Nigeria external debt go rise from $51.9bn for 2025, go $66.5bn for 2026, before e finally reach $72.6bn for 2027, that one […]

todayJune 10, 2026 22

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and […]

todayJune 10, 2026 8

Sports

Ebola Scare Shake Dr Congo World Cup Prep

By: Esther Ayoola Democratic Republic of Congo dey fall hand oh, losing 2–1 to Chile for friendly match wey dem play for France on Tuesday, put am for Ebola head Di match suppose hapun for southern Spain, but di mayornor gree based on Ebola concern, naim make dem con move go France, and now dem con lose World Health Organization don declare international health emergency over di Ebola outbreak wey […]

todayJune 10, 2026 9

National

Abure Point Finger To Obi, Otti Say Na Dem Scata Labour Party

By: Esther Ayoola Former Labour Party Chairman Julius Abure don accuse Peter Obi and Abia State Governor Alex Otti of causing di leadership crisis wey dey shake di party. Abure, wey tuk for TV sit down tuk on Tuesday, say Labour Party dey peaceful until Obi and Otti carry dia problem come, create caretaker committee for Umuahia. According to am, na dat decision scata di party stability and start di […]

todayJune 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds