Blog sidebar

Background

Lagos

FG Cut Carter Bridge Work From 36 To 24 Months

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don reduce di timeline to complete reconstruction of Carter Bridge for Lagos from 36 to 24 months, wi Minister of Works Dave Umahi announce am on Monday during inspection of di project. Umahi, alongside Minister of State for Works Mohammed Goronyo and lawmakers, inspect Carter Bridge and Iddo Bridge projects for Lagos to speed up di work. Di minister say dem shorten di reconstruction period […]

todayAugust 25, 2026 18

Sports

Chelsea Burst Fulham 3-2 as Palmer Shine

Chelsea  start dia new era with ogbolicious win beating  Fulham 3-2 for West London derby as Cole Palmer shine for di Blues wetin nor gud. Di win give new Chelsea coach Xabi Alonso winning start for im Premier League reign and make am one of only three out of di club’s last nine managers wey win dia first league match. Di defeat na Fulham coach Arbeloa first Premier League game […]

todayAugust 25, 2026 12

obodo oyinbo

Kremlin Say Britain Dey Block Ukraine Peace Talks

Kremlin don accuse Britain say di country dey block peace for Ukraine by giving Kyiv information wey fit help dem produce SCALP long-range missiles locally. Kremlin spokesman Dmitry Peskov talk on Monday say Britain dey “throw oil on di fire” and dey work against any progress for peace, as UK Prime Minister Andy Burnham promise to continue military support for Ukraine during im visit to Kyiv. Britain don say e […]

todayAugust 25, 2026 13

OBODO NAIJA

Peter Obi Say Make Gornment No Chop Subsidy Money

Di Nigeria democratic Presidential candidate, Peter Obi don distance himself for dis fuel subsidy mata say mismanagement of money by di current gorment nor mean say make Nigeria return back to subsidy. Im fire fire dis mata  during sit down tok tok inside di Nigerian Bar Association Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. Di presidential candidate of NDC say hin support removal of subsidy, but gornment suppose use […]

todayAugust 25, 2026 21

OBODO NAIJA

Lagos-Calabar Coastal Highway Na Di Best Gift To Nigerians

Minister of Works, Dave Umahi, don describe Lagos-Calabar Coastal Highway as di best gift Presido Bola Tinubu administration don give Nigerians. E make di statement on Monday for flag-off of di dualisation of Ibadan-Ijebu-Ode road along Idi Ayunre axis for Ibadan. Umahi tok say pipo for Lagos don dey feel di benefit of di road as journey from Epe to Lagos wey dey take seven to eight hours before, now […]

todayAugust 25, 2026 20

Politics

Must Read: Election Period, Hope for Some, Fear for Others

Written by: Jolayemi Olajide  For millions of Nigerians, election suppose be di time wey everybodi go join hand choose dia leaders and make way wia di country go head. But as di elders dey talk, "Water wey dem take cook beans, na im dey swallow am". Sabi pipo once tuk say, if election process start with trouble, na wahala everyone go chop. For plenty communities wey don see pepper before, […]

todayAugust 24, 2026 23

Health

Must Read: Sickle Cell No Be Death Sentence

Written by: Jolayemi Olajide  Di Load Wey Eye No Fit See: One dark night for Warri, 14-year-old Amara just wake up suddenly for her bed, hold her chest tight, begin cry, and shout: “Mama oh , I dey die oh! Di pain too much!” Her mama run enter di room, body begin shake. But when she check Amara body down to her feet, she no see any wound, she no […]

todayAugust 24, 2026 23 1

Sports

Luis Enrique Warn PSG Players Say Make Dem No Relax

By: Mariam Ajayi Paris Saint-Germain coach, Luis Enrique, don warn im players say dem must leave dia comfort zone and continue to prove themselves despite dia recent success. Enrique give di warning on Monday after PSG fight back from two goals down to draw 2-2 with Rennes for dia opening Ligue 1 match on Sunday. PSG struggle for di first half, forcing Enrique to make two changes at halftime, as […]

todayAugust 24, 2026 19

OBODO NAIJA

Veteran Yoruba Actor Taiwo Hassan ‘Ogogo’ Kpai at 66

By: Mariam Ajayi Veteran Yoruba actor, Taiwo Hassan, wey pipo sabi as Ogogo, kpai at di age of 66. Na im daughter, Kira Taiwo, Konfamate im death for Instagram Live session on Sunday. Ogogo na one of di respected faces for Yoruba movie industry, with many years of acting and contribute to Nigerian entertainment. Im death don make fans and colleagues across di entertainment industry cry wetin no good , […]

todayAugust 24, 2026 20

OBODO NAIJA

Must Read: Ogogo Burial Ceremony Go Hold Today

Respected Nollywood actor and filmmaker, Taiwo Hassan, popularly known as Ogogo, don kpai at di age of 66. Ogogo kpai on Sunday, August 23, 2026, around 3 p.m., after e battle stage-four cancer. His death come just few days after im daughters reveal say di actor dey seriously sick and dem appeal to Nigerians for medical assistance. Ogogo na one of di respected faces for Yoruba Nollywood, with career wey […]

todayAugust 24, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds