obodo oyinbo

Britain, France And 30 Countries Dem To Join Bodi On Top Strait Of Hormuz Marras

todayMarch 25, 2026 4

Background
share close

Britain and France wan hold meeting dis week for Europe with about 30 countries to hellep reopen di Strait of Hormuz.

According to Britain defence official rob mind with tori pipo,  di join bodi doings go include top officials from Britain, France, Germany, Italy, Japan and Netherlands and 24 other countries.

Say Britain top military oga, Richard Knighton, don already meet di first six countries plus Canada on Sunday for London.

Dem say, di door sti open for ground for other countries to join as dem plan follow-up military-to-military meeting later dis week to protect passage of oil from di strait of Hormuz.

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app