Lagos

Bus Conductor Allegedly Nack LASTMA Screwdriver

todayJune 30, 2026 6

Background
share close

Nor be small tin oh, say One bus conductor don go allegedly nack LASTMA official screwdriver for im head, wunjor am yangayanga for gorun for Abule-Egba, along Lagos-Abeokuta Expressway.

LASTMA tuk,tuk, Adebayo Taofiq, na him bin sorosoke dis mata inside statement wey dem wrap like akara on Monday.

Im explain dat di LASTMA official just bin dey do im job, na dis conductor wey head shake enter argument am, an na from dia play, play turn to hit and go oh.

Taofiq say dem say gbab di suspect, wey name na Lekan, and they don hand am over to police people for proper investigation and prosecution.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds