Lagos

643 Results / Page 1 of 72

Background

Lagos

Lagos Fix Streetlights For Night Movement

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis Lagos state gorment do dey install new streetlights and fix broken ones for major roads and highways to make security stand fit for beta night movement E put dis one for im Facebook page, say the work na part of the Light-Up Lagos project wey dey in progress. Di Government teams don do installation for different areas for both […]

todayMarch 9, 2026 2

Lagos

Omo Onile Demolish 50 Houses For Surulere, Lagos; Residents Cry Out

By: Esther Ayoola For Surulere, Lagos, say some suspected land grabbers wey pipo sabi as Omo Onile don demolish about 50 houses, making pipo homeless. Dat di jaguda boys just waka enter di community on Tuesday, 27 January 2026, dey demand between N15 million and N25 million from house owners. Say Pipo wey no fit pay, na dia houses dem don demolish. Founder and Chief Executive Officer of Oikus, Israel […]

todayMarch 9, 2026 1

Lagos

Woman Kpai, Six Wunjur For Gbagada Bus Askident

By: Esther Ayoola Say One woman kpai and six odas get serious wunjury inside one askident wey hapun for New Castle Bus Stop, inward Gbagada, along Oworonsoki-Apapa Expressway, Lagos. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk, tuk, Adebayo Taofiq, di askident hapun over di weekend. Say na one Volkswagen commercial bus lose control come crash against roadside culvert. Di hardness of the jamming na make di woman fly […]

todayMarch 9, 2026 1

Lagos

APC Jandor Drag Gorment To Tackle Poverty

By: Esther Ayoola APC governorship aspirant for Lagos, Olajide Adediran, wey pipo sabi as Jandor, don give promise say him go take care of poor pipo, if e win for 2027. E yarn dis one on Saturday as e dey yarn with journalists for di 8th Annual Ramadan Lecture wey hold for Ikeja. Jandor say gornment main work na to beta people life, and dat im go work hard to […]

todayMarch 9, 2026 1

Lagos

IGP Disu Give Order To Police To Stop Over Sabi Work

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Tunji Disu don order make dem reduce di number of police tactical teams wey dey operate across Naija. Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh na im relate dis mata for Abuja when police commissioners gather for meeting with di Inspector-General of Police Tunji Disu. Say, di order na part of di reforms wey di Naija Police Force dey do to improve professionalism, accountability and […]

todayMarch 9, 2026 2

Lagos

NDLEA Gbab Former-Lagos Councillor With 40kg Skunk For Ibeju-Lekki

By: Esther Ayoola Naija Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, operatives don go gbab one former councillor for Lagos State, Sadiq Olalekan, for drug mata. Tuk, tuk of NDLEA, Femi Babafemi, Say dem pick di 45-year-old man for im house for Ilado area of Ibeju-Lekki afta dem receive correct intelligence informate. According to di NDLEA tuk tuk person, when officers search di house, dem see about 40 kilograms of skunk wey […]

todayMarch 9, 2026

Lagos

Lagos State House of Assembly Finish Demolition Investigation For Waterside Communities.

Lagos State House of Assembly don finish investigation on demolitions wey hapun for three water side communities like Makoko, Sogunro, and Oko-Agbon. Oga  Chairmo of di ad hoc committee, Noheem Adams, yarn dis one on Thursday during stakeholders’ meeting for Lagos. Different community representatives tuk different things, some want compensation, while others dey push for permanent relocation. Say, di  committee go submit all di findings and dia positions to di […]

todayMarch 6, 2026 14

Lagos

Lagos State Farmers Collobi FG Support To Boost Food Security

Federal Government don empower small-small farmers for Lagos State with farm inputs to help boost food production and improve food security for Nigeria. Di empowerment programme wey Federal Ministry of Agriculture and Food Security carry out happen for Agege, Lagos on Thursday, and dem give 68 farmers cooperatives farm materials. Agriculture Minister Abubakar Kyari, wey Dr Marcus Ogunbiyi represent, talk say di programme na part of Presido Bola Ahmed Tinubu […]

todayMarch 5, 2026 7

Lagos

Alcohol Companies Nor Gree For Sahcet Alcohol Ban

Workers of alcohol companies say dem go storm di National Agency for Food and Drug Administration and Control office for Lagos today to protest Federal Government ban on sachet alcohol and PET bottles wey small pass 200ml. Di protest, wey di Distillers and Blenders Association of Nigeria  dey organise, go start by 8:30am for Oshodi as dem say dem wan show dia anger over di decision. Dis one na di […]

todayMarch 4, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app