Lagos

988 Results / Page 46 of 110

Background

Lagos

Lagos Gorment Lock Ladipo Spare Parts Market

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don seal Ladipo Spare Parts Market for Mushin on Sunday. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, ni dey yanyanpu dis mata give tori pipo, say dem take action based on say, traders dey throway thick dirty wey dey smell for road anyhow. E also complain say, illegal street trading dey hapun for inside and around di market. Wahab tuk say, gornment […]

todayFebruary 9, 2026 25 1

Lagos

Army To Touch Light Officers For Drug Dealings For Apapa

By: Esther Ayoola 81 Division of di Nigerian Army don begin touch light doings for Apapa, after chairmo of Apapa-Iganmu LCDA, Jimoh Saliu, accuse some military officers, dat, na dem dey give drug dealers leg for di area to misbehave. Untop aproko to tori pipo, Saliu say, based on di anyhow doings, one area wey dem dey call Gidan Drama, for Marine Beach, near Tego Army Barracks, don turn hide […]

todayFebruary 9, 2026 19

Lagos

President Trump Hail Remi Tinubu For U.S. National Prayer Breakfast

By: Esther Ayoola Say every first Blur for Washington D.C., as U.S. Presido, Donald Trump scarra praises for Naija, First Lady, Senator Oluremi Tinubu, calling her “very respected woman” for National Prayer Breakfast wey sup on Thursday. Trump make dis announcement, as e dey address political and civic leaders from different parts of di world wey attend di prayer meeting. As e mention Madam Tinubu name and hail her influence, […]

todayFebruary 6, 2026 17

Lagos

Lagos Gorment Push Beta Crib For Pipo Weh Get Disability

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say, dem dey serious about inclusive housing development, and say dem dey put do correct doings for pipo wey get disability for all housing projects for state. Na Permanent Secretary for Lagos State Ministry of Housing, Abdul-Afeez Toriola, tuk dis one when officials from Lagos State Office for Disability Affairs visit dia office. Toriola say, ministry don dey include special provisions for pipo wey […]

todayFebruary 6, 2026 18

Lagos

Education Minister Explain Why Im Put 250,000 Naija Youths For Handwork

By: Esther Ayoola Minister of Education, Tunji Alausa, like dis, dey say, na handwork be di way, say over 250,000 Nigerian youths ni don already register for Federal Government Technical and Vocational Education and Training (TVET) programme. E tuk dis one on Thursday for im induction as member of Epe Club wey happen for Alausa area of Lagos State. According to am, government still dey target make one million youths […]

todayFebruary 6, 2026 13

Lagos

Sanwo-Olu Explain How Im Dey Package Lagos For International Business

By: Esther Ayoola Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don go arrange package, unveil Lagos International Financial Centre (LIFC) with plans to make Lagos economy strong. E beg both gornment and private sector make dem continue to joinbodi to make Lagos become global financial hub. Sanwo Olu say, LIFC, wey dem start plan two years ago, go bring international money, grow financial market, and create better work chance for pipo.

todayFebruary 6, 2026 16

Lagos

Lagos Go Close Apongbon Bridge For Six Weeks For Repairs

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment, don join body with Federal Ministry of Works, don announce say dem go start repairs for failed asphalt parts of ramp and service lane wey connect Inner Marina to Apongbon Bridge, plus some parts of di bridge lanes. State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, tuk say di work go start for service lane on Thursday, February 5, and e dey expect say e go […]

todayFebruary 5, 2026 21

Lagos

LAWMA Arrest Man Throwing Dirty Wey Smell Reach Gorment House LAWMA

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don arrest one man for Lagos Island early Tuesday mor mor, say im thruway dirty wey smell reach gorment house. Say dis operation na part of dia effort to stop pipo wey dey throw dia dirty anyhow for di area. According to a statement for di lagos state gorment official website, di man, wey dem identify as Muritala Suleiman, 42 years old […]

todayFebruary 4, 2026 23

Lagos

Lagos Assembly Give Order To Stop Makoko Demolitions

By: Esther Ayoola Lagos State Assembly don meet Makoko people wey demolition affect on Monday for Lagos, to address di wahala wey di demolitions dey cause. Chairmo of House Committee on Makoko Demolition, Majority Leader, Noheem Adams direct say, make all ministries and agencies stop demolition for Makoko, Oko-Afon, and Shogunro, to prevent more community stress. Adams say, moving forward, lawmakers go waka go di area to check wetin dey […]

todayFebruary 3, 2026 22 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds