Lagos

988 Results / Page 49 of 110

Background

Lagos

Lagos Gorment Clear Mata Of Tax Collection

By: Rilwan Agbomeji Oga Chairmo of Lagos State Internal Revenue Service (LIRS), Dr. Ayodele Subair, don clear mata say, dem nor dey debit any company account directly if dem never pay tax. E yarn dis one for tv sit don tuk, say LIRS just wan collect unpaid tax from companies to fit provide beta things for Lagos. Subair explain say, nobodi go impose tax on person or companies wey dem […]

todayJanuary 28, 2026 13

Lagos

Police Arrest Jaguda Wey Threaten To Bomb Lagos School

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Police command don arrest one man, Kosiso Chukwem-Nenyem, say n aim send di alleged bomb threat messages via WhatsApp to two schools for Lagos. Commissioner of Police, Olorundare Moshood Jimoh, talk dis one when e dey brief tori pipo for Command Headquarters, Ikeja, on recent security operations. Jimoh press tuks on di arrest wey dem  don make for past  di weeks.

todayJanuary 28, 2026 18

Lagos

Lagos Gorment, Private Sector Collabo To Boost AI Use For Nigeria

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don decide to join hand with private sector to hellep fast-track Artificial intelligence, AI, use for di obodo Nigeria. Dem say di way technologia dey waka wawawa, say, if gorment nor dey careful, say person go lose control. Commissioner for Energy and Mineral Resources, Biodun Ogunleye, yan dis one for corner coner tuks for di 2026 tecnologia conference wey dem title “AI in Action […]

todayJanuary 27, 2026 16

Lagos

Lagos Gorment Set To Hammer Drainage Spoilers For Lekki Area

By: Esther Ayoola Lagos State goment don cut chain, say dem go change am for any kain person wey go block drainage and break environmental law for Lekki, just to hellep protect di area from flooding. Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one as e dey inspect drainage work and flood areas for Ogombo, Ikate, Mobil Road and other nearby communities. Wahab say dem get correct informate, say, some pipo […]

todayJanuary 27, 2026 25

Lagos

Police, PSC Extend Recruitment Say Mehn Nor Dey Turn Up

By: Esther Ayoola Di Police Service Commission (PSC) and Nigeria Police Force for Nigeria don extend dia recruitment programme of 50,000 police constables, say dem don add two weeks based on some states, including Lagos, dey record low application. PSC Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, tuk dis one on Monday, say extension dey follow receipt of over 400,000 applications nationwide and uneven participation across states. Di online […]

todayJanuary 26, 2026 17

Lagos

Discos Comot Hand For FG Free Meter Tuk

By: Esther Ayoola Electricity Power distribution companies, don pull shirt dey laugh wi federal gorment say, di tuk wey Minister of Power, Adebayo Adelabu, yarn dat prepaid meters na free for customer, say na yeye tuk. Operators wey carry aproko wey nor  mention name because of  fear,  tell tori pipo, oga  minister just yarn for political reason and e no ask other pipo wey dey involved, like installers and meter […]

todayJanuary 26, 2026 13

Lagos

Bible Society Beg FG Not To Kill Indigenous Languages

By: Esther Ayoola Naija Bible Society don put dia voice for di ban of indigenous language use for our schools, say make wi Federal Gornment rethink, dat e go kill our own cultural tongue. Oga Bible society, CEO, Pastor Samuel Sanusi, na dey yarn dis one for tori tori sitting with aproko pipo for Lagos, say plenty Nigerian languages don dey die because of di move by wi federal gorment. […]

todayJanuary 26, 2026 16

Lagos

Drunk Driver Land Hospital After E Jam Truck For Lagos

By: Esther Ayoola One yet to be identified driver don go drive wawa go jam truck for Ebute-Ero, Apongbon, Lagos, and like dis, im  don land for hospital. Lagos State Traffic Management Authority tuk tuk, Adebayo Taofiq, konfamate dis mata,  say e be like di  driver  drink wetin nor good. Taofiq press tuks dat, Investigation show say e bin dey speed when e run enter di truck wey dey on […]

todayJanuary 26, 2026 18

Lagos

Why Dirty Full Lagos Streets, LAWMA Blame Population

By: Esther Ayoola Say Dorti don full everywia for streets for Lagos, business areas, making pipo to fear for dia lives. According to Lagos Waste Management Authority, LAWMA say di mata no be only about truck or workers, but also pipo behaviour and how residents dey handle dia waste. LAWMA boss, Dr Muyiwa Gbadegesin, Lagos get about 27 million pipo and each person dey produce about half kilo of waste […]

todayJanuary 26, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds