Lagos

988 Results / Page 57 of 110

Background

Lagos

Police Kramp Anthony Joshua Driver For Driving Wawa

By Ebi Oboko Ogun State Police don confamate say dem don arrest the driver of the Lexus SUV wey get accident wey kill di two frens of former boxing champion Anthony Joshua. The accident happen on Monday for Lagos-Ibadan Expressway as the vehicle jam stationary truck, kill Latif Ayodele and Sina Ghami on the spot, while Joshua and the driver get minor injuries. Police PRO Oluseyi Babaseyi talk say investigation […]

todayJanuary 2, 2026 20

Lagos

New Year Fire Scarra Four Shops for Ikotun, Lagos

By Ebi Oboko Unto 2026 new year  day  updates, Say Four electronics shops for one building wey nia Transport Company for Ikotun, Lagos, don burn down early mormor for New Year Day. According to report Everything for di shops, including washing machines, TVs and generators, don destroy. Di cause of di fire, nobodi know, but people dey suspect say na faulty electric circuit. And as the time Konfam news package […]

todayJanuary 1, 2026 17

Lagos

Lagos APC Yansay Dia Full Support For Tinubu New Year Reforms

By Ebi Oboko Lagos State All Progressives Congress, APC,  tuk tuk, Hon. Seye Oladejo, don tuk again oh, say the party dey fully support oga  Presido, Bola Tinubu New Year message and reforms. According to Oladejo, through one official statement, say because dem believe say Tinubu dey take hard but necessary decisions to fix Nigeria, dem go support am beta style. Oladejo say for Lagos, APC see signs dat economy […]

todayJanuary 1, 2026 19 1

Lagos

First Lady Oluremi drop lines Say Naija Economy Face Show

By Ebi Oboko First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don talk say 2026 come with fresh hope and assurance of God blessings for Nigeria. She talk this one for her New Year message wey she post for her official X handle on Thursday. Senator Oluremi say she full with gratitude to God as Nigerians enter di New Year with joy and big expectation for better future. Mama Tinubu greet Nigerians for […]

todayJanuary 1, 2026 25 6

Lagos

Speaker Obasa to Lagosians Say Beta Governance Dey Come For 2026

By Ebi Oboko Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don troway beta salutation  Lagosians  for dia courage and support throughout 2025. Obasa tuk this one for him New Year message wey he release for Lagos on Thursday. He say even with all di economic wahala for di country, Lagos people still stand gidigba and support government. Di Speaker assure say 2026 go bring beta governance, more achievements, […]

todayJanuary 1, 2026 18

Lagos

Lagos CP Share Update Say Coastal Road Dey Safe

By Ebi Oboko Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don assure residents and motorists say security and traffic go dey smooth for the new coastal road after police deploy officers there. Jimoh talk this one on Wednesday for Victoria Island during Show of Force, say the road open, no traffic wahala for people wey dey go Lekki and other parts of Lagos. Police quick deploy over 30 patrol teams and […]

todayJanuary 1, 2026 19 1

Lagos

Balogun Market Fire Kill Five As Another Blaze Burn Shops For Oshodi

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service tuk say fire wey gut Great Nigeria Building for Balogun Market, Lagos Island, don kill five people, after dem recover two more bodies from di rubbles on Sunday. According to di agency Controller General, Margret Adeseye, another fire break out Monday evening for Arena Market, Bolade area of Oshodi, Lagos State. She say dem receive distress call around 5:50pm and immediately […]

todayDecember 31, 2025 28

Lagos

Governor Sanwo Olu Cancel Lagos Greater Fiesta

By: Esther Ayoola Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025. Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state. Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, […]

todayDecember 31, 2025 28

Lagos

Lagos, TEC Giant Open Sanwo-Olu Mini Stadium For Sura

By: Esther Ayoola Lagos State Government join bodi with TEC giant don di ogbonge launch Sanwo-Olu Mini Stadium, eight-a-side astroturf pitch for Sura under bridge, Lagos Island. Governor Babajide Sanwo-Olu say di project na part of him plan to encourage youth and promote sports development. DG of Lagos State Sports Commission, Lekan Fatodu, thank TEC experts for dia  support and youth empowerment.

todayDecember 31, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds