Lagos

785 Results / Page 68 of 88

Background

Lagos

Lagos Government Don Launch “Trash For Cash” Program To Boost Recycling

Di Lagos State Government don launch new program wey dem call “Trash for Cash” to encourage residents to turn dia waste to money by exchanging recyclable items like plastic, cans, and bottles for cash. Dis initiative na part of government plan to promote cleaner and greener Lagos. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce am for him X handle on Monday, say through LAWMA, dem don begin sensitisation […]

todayOctober 20, 2025 39

Lagos

Sanwo-Olu Confirm Say Lagos Still Dey Ground For Sustainable Growth Ahead 2025 Climate Change Summit

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, on Sunday confirm say Lagos dey committed to push sustainable growth through new ideas and better investment for resilience as e go host the 2025 International Climate Change Summit. Di summit wey go happen for Lagos Continental Hotel from November 6 to 7, 2025, go gather big leaders, investors, climate scientists, and policy makers from all over di world. According to statement from Commissioner for […]

todayOctober 20, 2025 18

Lagos

LASG Join Hand Wit AFD and Others to Launch €360m Waterways Transport System

Lagos State Government join hand with French Development Agency (AFD), European Union (EU), and European Investment Bank (EIB) to launch big project wey dem call Omi Eko Project. Dis project go upgrade Lagos waterways transport with modern speed boats wey get better technology. Di plan na to make ferry system for Lagos organised, cheap, and better so dat e go connect places well and make life easy for Lagos people. […]

todayOctober 20, 2025 14

Lagos

Insecurity: People Wey Dey Dopemu Area For Lagos Dey Cry Out For Help

People wey dey Dopemu for Agege Local Government Area, Lagos State, don dey cry out to state government make dem help stop the yawa wey area boys dey cause for dia streets. Di boys dey always show for street every evening, especially for places wey get shops, dey carry cutlasses, axes and other dangerous weapons to dey attack traders and people wey dey return from work. Eyewitness talk say di […]

todayOctober 20, 2025 45

Lagos

Nigerians Must Fast, Pray To Avoid Wahala Wey Dey Come — Former Lagos Deputy Gov Ojikutu

Former Lagos State Deputy Governor, Alhaja Sinatu Ojikutu don announce say October 23, 2025, di day wey she go turn 80, go dey observed as day of fasting, prayer, and sobriety. She call make people from all over join body dey pray for survival and better life as hardship dey come. Ojikutu also talk say di day suppose be time to show love and help poor people wey no get […]

todayOctober 20, 2025 26

Lagos

Govt Dey Okay As Dem Dey Remove Illegal Structures For Safety Sake

Group wey concern for Lagos don show strong support for state govt as dem dey remove illegal structures for different areas of Lagos. Di group talk say dem no gree with 30-day ultimatum wey Igbo National Union Worldwide (INU-W) give Lagos govt, say make dem stop di removal. Dem call di ultimatum one way to bring back old wahala like di 1952 NCNC palava for Lagos. Di group talk say […]

todayOctober 20, 2025 16

Lagos

Gunmen Shoot Butcher Dead Inside Lagos Barracks Market

Serious gbege burst early Saturday morning as unknown gunmen storm Mammy Market inside military barracks for Ojo LGA, Lagos, come shoot one butcher wey dem call Ridwan. Di attack happen around 8am as traders just dey open shop. About four gunmen wey wear mask enter di market, fire shot into air scatter everywhere, come go straight to Ridwan meat stall shoot am multiple times. According to eyewitness dem, di gunmen […]

todayOctober 20, 2025 14

Lagos

Driver Don Enter Cell As Two People Die For Lagos Road Crash

Two people don kpai for two separate road accidents wey happen for LASU-Igando road and Osborne Expressway for Lagos State. One of di accidents involve truck wey brake fail, lose control and jam pedestrian wey dey waka for roadside. According to LASTMA Public Affairs Director, Adebayo Taofiq, di accident happen for Simpson Street, Osborne Expressway, near Traffic Light Junction. Di truck wey dey speed wella get sudden brake failure, and […]

todayOctober 20, 2025 29

Lagos

Lagos Seal Proposed Cemetery Site After Surulere People Para

Lagos State govment don seal one proposed cemetery construction site for Bode Thomas area inside Surulere after residents of Natufe/Animashaun community protest say dem no want burial ground near dia houses. Di people vex say if dem build cemetery for dat area, e go pollute dia borehole water wey na wetin dem dey drink since dem no get pipe-borne water. Even as rain dey fall on Saturday, residents still come […]

todayOctober 20, 2025 25 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds