Lagos

785 Results / Page 69 of 88

Background

Lagos

State Houses of Assembly Too Weak, Docile – Ikuforji, Former Lagos Speaker

Former Speaker of Lagos State House of Assembly, Adeyemi Ikuforiji don talk say Nigerians suppose hold state governors and local government chairmen responsible for governance, instead of always blaming di federal government. As e talk for him office for Lagos dis week, Ikuforiji point say state and LGs dey collect over 50% of federal allocation, yet citizens no dey hold dem to account. E say people get better access to […]

todayOctober 17, 2025 20

Lagos

Lagos Dey Redefine Agriculture As Engine For Growth, Sustainability – Sanwo-Olu

Govnor Babajide Olusola Sanwo-Olu don yan say him administration dey fully committed to turn agriculture into strong engine wey go bring growth, carry everybody along, and keep things sustainable. E talk dis one on Thursday for di 2025 World Food Day celebration wey happen for Police College, Ikeja. Di theme na “Hand in Hand for Better Foods and a Better Future.” Sanwo-Olu, wey Barrister Bimbola Salu-Hundeyin, di Secretary to di […]

todayOctober 17, 2025 27

Lagos

Commuters Dey Groan As Bad Road Don Cripple Movement For Lekki-Epe Corridor

People for Lagos Mainland dey suffer badly because roads don spoil, and now those wey dey live along Lekki–Epe Expressway dey join in di complain, dem dey waste hours inside traffic because road condition don kpeme. Even though plenty rich people and costly estates dey dat area, inner roads and main roads don remain battered. Commuters and residents dey lament say roads don bad reach level wey transport fare don […]

todayOctober 17, 2025 16

Lagos

Lagos Don Tell Residents Make Dem Collect Building Permit Before Dem Build Anything

Lagos State Government don beg residents make dem collect planning permit before dem go build any property. Dr. Oluyinka Olumide, Commissioner for Physical Planning and Urban Development, talk this one during public awareness programme wey dem hold Thursday for Ojo. Dem invite community leaders, residents, and stakeholders from areas like Ojo, Badagry, Iba, Oto‑Awori, Amuwo‑Odofin, Oriade and Olorunda. Olumide yarn say permit no na small thing, na law, e dey […]

todayOctober 17, 2025 25

Lagos

Train Crush Dispatch Rider To D£ath For Lagos (Photos)

One dispatch rider don k0mot de@th after train crush am for Lagos. The gbege happen today, October 16, for PWD Railway Level Crossing, Ikeja. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) yan say dem still dey beg people to dey careful and follow traffic rules well. The rider, wey get motorcycle number plate AGL 179 QR, try cross railway line when train dey come close. The crash happen near road wey […]

todayOctober 17, 2025 26

Lagos

Moment KAI Officials Seize Pot And Food As Actress Sarah Martins Dey Cook For Poor People For Road Median For Lagos (Video)

One video don surface online wey show di moment Lagos Environmental Sanitation Corps (LAGESC), wey people sabi as KAI (Kick Against Indiscipline), confront Nollywood actress Sarah Martins as she dey cook for road median to share food give poor people. For di video, KAI officials storm di area, begin seize her cooking utensils and food items while she still dey sit down dey cook. Sarah Martins beg dem say na […]

todayOctober 17, 2025 37

Lagos

LASG Seal 11 Facilities For Environmental Wahala

Di Lagos State Environmental Protection Agency (LASEPA) don seal 11 different establishments for Ikorodu say dem no follow environmental rules, especially noise wahala and other dirty behaviours. For statement wey dem post on X on Thursday, LASEPA talk say di enforcement happen for key areas like Agodo Gas Line, Odogunyan Industrial Layout, Ita Oluwo Junction, Haruna, Ipakodo Road, and Ebute. Di places wey chop seal include bars, lounges, hotels, and […]

todayOctober 17, 2025 20

Lagos

LASODA Support Pwds With Cash

Di Lagos State Office for Disability Affairs (LASODA) don show say dem still dey committed to di welfare of persons with disabilities (PWDs) as dem run two-day cash support programme on October 13 and 14, 2025, for dia head office for Lagos. Mr. Hezekiah Akinbule, Head of Finance and Accounts, yarn on behalf of LASODA GM, Mrs. Adenike Oyetunde-Lawal, say di N100,000 wey each beneficiary collect na Governor Babajide Sanwo-Olu […]

todayOctober 17, 2025 20

Lagos

Four Nearly Kpai As Two trailer Jam For Lagos–Abeokuta Road

Four people nearly kpai yesterday when one cement-laden truck jam another moving truck for Lagos–Abeokuta Expressway. Di accident involve two Howo trucks, one red truck with registration number T12926 LA and one ash-coloured truck with number WDL 536 XA. Di Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Corps (TRACE) spokesperson, Babatunde Akinbiyi, confirm di incident for statement wey e drop on Wednesday for Abeokuta. Akinbiyi talk say na four people dey […]

todayOctober 16, 2025 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds