Lagos

541 Results / Page 8 of 61

Background

Lagos

Balogun Market Fire Kill Five As Another Blaze Burn Shops For Oshodi

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service tuk say fire wey gut Great Nigeria Building for Balogun Market, Lagos Island, don kill five people, after dem recover two more bodies from di rubbles on Sunday. According to di agency Controller General, Margret Adeseye, another fire break out Monday evening for Arena Market, Bolade area of Oshodi, Lagos State. She say dem receive distress call around 5:50pm and immediately […]

todayDecember 31, 2025 7

Lagos

Governor Sanwo Olu Cancel Lagos Greater Fiesta

By: Esther Ayoola Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025. Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state. Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, […]

todayDecember 31, 2025 6

Lagos

Lagos, TEC Giant Open Sanwo-Olu Mini Stadium For Sura

By: Esther Ayoola Lagos State Government join bodi with TEC giant don di ogbonge launch Sanwo-Olu Mini Stadium, eight-a-side astroturf pitch for Sura under bridge, Lagos Island. Governor Babajide Sanwo-Olu say di project na part of him plan to encourage youth and promote sports development. DG of Lagos State Sports Commission, Lekan Fatodu, thank TEC experts for dia  support and youth empowerment.

todayDecember 31, 2025 8

Lagos

Lagos Government Promise Better Flood Control For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Government don wire ogbonge new year promise say dem go take flood control and drainage work for 2026, to di next level based on di praise dem get for flooding season for 2025. Special Adviser to Governor on Environment, Olakunle Rotimi, ni share share dis update inside di Annual Zonal Awards of Emergency Flood Abatement Gang and Drainage Enforcement Gang for Alausa, Ikeja. Im say […]

todayDecember 30, 2025 3

Lagos

Lagos APC Go Start E-Registration For 20 Local Government Areas

By: Rilwan Agbomeji Lagos State APC don announce say dem go start electronic registration and revalidation for party members across di state. Di e-registration exercise go run from January 5 reach January 28, 2026 for all 20 local govment areas of Lagos. APC Lagos Chairman, Pastor Cornelius Ojelabi, talk dis one for end-of-year briefing with journalists for Lagos. E talk say di move dey meant to strengthen di party structure […]

todayDecember 29, 2025 10

Lagos

Lagos Gorment Clear Lagos–Badagry Expressway For New Year Celebration

By: Esther Ayoola Lagos state gonment decide say dem wan enter di new year clean,  say dem don start to clear plenty rubbish wey  pile up for Lagos–Badagry expressway to reduce waste pollution for di state. Commissioner for environment and water resources, Tokunbo Wahab,  share dis update for X  post on Sunday, say kontri man and women need stay healthy,  say like dis dem don carry kapila and survel enter […]

todayDecember 29, 2025 9

Lagos

Overspeeding Motor Kill 9-Year-Old Pikin, Injure Four For Lekki

By: Esther Ayoola Unto matters for Lekki area, say one unkown driver go jam  five pikins  with im koropke, kabu kabu motor for Lekki, Lagos, afta im motor lose control. According to report, say di driver bin dey drive wawa speed, jam di innocent children wey dey dia own, Igboa. From statement wey fall out from di area Controller General of di Lagos State Fire and Rescue Service, Margaret Adeseye, […]

todayDecember 29, 2025 4

Lagos

Tinubu, Sanwo-Olu, Other Big Men Celebrate 73rd Eyo Festival For Lagos

By: Esther Ayoola Over di weekend, nor be small flex for wi oga Presido, Bola Tinubu, Imo State Governor Senator Hope Uzodimma and other big people joinbodi with Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu  flex, say dem dey celebrate di 73rd Eyo Festival for Lagos on Saturday. Di festival wey people dey call Adamu Orisa play, shelle  for Tafawa Balewa Square, if you see di agbada wey wi oga presido dek, […]

todayDecember 29, 2025 7

Lagos

PDP Lagos Set 19-Member Caretaker Committee

By: Rilwan Agbomeji Di People’s Democratic Party, PDP for Lagos, don inaugurate 19 people caretaker committee wey go run di party marras for di state. Di party talk say di Congress for zone, ward, Local and National levels go hold on January 9, 2026. Di inauguration happen dis week under di leadership of PDP National Chairmo, Hon. Abdul-Raman Mohammed, represented by PDP deputy national secretary, Engineer Adedeji Doherty. Doherty tell […]

todayDecember 26, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app