Lagos

985 Results / Page 6 of 110

Background

Lagos

LASEMA Yarn Say No Building Collapse For Alakija

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don officially clear bad air wey dey spread for social media say one building collapse for Alakija area. LASEMA Permanent Secretary, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, konfamate dis for statement on Thursday say di report na lie and e dey mislead di public. Officials wey dem send to check di area after di news show face no find any evidence of any building collapse for […]

todayJuly 2, 2026 6

Lagos

Gbadebo Rhodes-Vivour Dey Prepare For 2027 Lagos Governorship Race

Gbadebo Rhodes-Vivour of di African Democratic Congress (ADC) don clear say him 2027 Lagos governorship ambition no depend on Peter Obi or di Obidient movement. Di politician tok dis one for one siddon tuk on Thursday, as e emphasize say e don dey build strong structure for grassroots communities. Rhodes-Vivour explain say e don work hard to connect with Lagos residents wey dey face challenges like demolition, and e believe […]

todayJuly 2, 2026 8

Lagos

Lagos Govt Drag Over 100 Road Median Traders Go Court

Lagos State Government don drag more dan 100 pipo go court within di last one year for selling on road medians and breaking environmental laws. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one on Wednesday as e supervise operation to flush out illegal traders from di Okokomaiko to Orile road median. According to di government, di operation na to clear di road once and for all so […]

todayJuly 2, 2026 8

Lagos

RESIDENTS CRY OUT AFTER FLOOD CHOP THEM

Residents for Gbagada area dey lament serious hardship as persistent flood don scatter dia house and market and people no fit comot go hustle. Many families don raise alarm say dem no dey safe again, especially wen rain start, because dem dey fear for di lives of dia children. Di people don beg government to come fix di bad roads and clear all di blocked drainage channels so dat water […]

todayJuly 2, 2026 10

Lagos

NPA Set Up Task Force To Fight Port Traffic For Lagos

Di Nigerian Ports Authority (NPA) don launch join bodi task force to tackle di traffic for Lagos port access roads. NPA tok say dem take dis step after Managing Director, Dr. Abubakar Dantsoho, hold meeting with security agencies, truck operators, freight forwarders and Lagos State Government officials to find lasting solution to di problem. According to NPA General Manager for Corporate and Strategic Communications, Ikechukwu Onyemekara, illegal checkpoints, double work […]

todayJuly 2, 2026 7

Lagos

Lagos Gornment Blame Blocked Gutter for Flood Wahala

By : Jolayemi Olajide Lagos State Gornment don drop micro soft word say flood na normal thing, but dem dey work to reduce the effect through beta drainage system. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one for tv sit down tuk on Wednesday, say no gornment fit stop rain or flood completely, but dem go try. According to am, wetin gornment fit do na to reduce […]

todayJuly 1, 2026 9

Lagos

LASEPA Lock Club And Hotel For Lagos Over Heavy Noise

Environmental agency for Lagos State, LASEPA, don cut chain follow one nightclub and hotel, say dem one use obule dey blind neighbours ear. Small tin, obule, obule, obule, ahoo Di two places wey dem seal on Monday dey for Olowora and one Suites inside Alapere, Ketu. According to di statement wey di agency post for X on Tuesday, dem warn dem about niose population but di obule just dey enter […]

todayJuly 1, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Order Gutter Cleaning To Clear Lagos Flood

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don beg residents make dem calm down after heavy rain cause ogbonge flooding for many parts of di state in di last two weeks. Gofnor Babajide Sanwo-Olu like dis don approve immediate cleaning for 28 water channels to help reduce flooding. Oga Commissioner of Environment, Tokunbo Wahab naim explain dis mata give tori pipo o Tuesday, say na heavy rain wey fall for places […]

todayJuly 1, 2026 14

Lagos

Lagos Police Kpai Jaguda Boys, Seize Hard Drugs And Weapons For AGO/FESTAC

Lagos State Police Command don go gbab five suspects wey be members of Aiye cult, say dem run di package for dia normanl  stop-and-search for Ago/Festac Bridge axis. Di Operatives gbab Emmanuel John and David Godwin inside one Toyota Camry with hard drugs, and di touch lighting of dis guys naim con lead to  police arresting Samuel Owubokiri, Adetona Seyi, and David Chigozie. Police search recover dangerous items from di […]

todayJune 30, 2026 10 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds