Lagos

1135 Results / Page 6 of 127

Background

Lagos

FG Go Lock Lagos-Calabar Road In 2 Weeks

By: Ayobami Dada Federal Controller of Works for Lagos State, Olufemi Dare, yarn on Monday say di Federal Government fit close di Lagos section of Lagos-Calabar Coastal Highway within two weeks if drivers and oda road users no obey safety rules. Dare tok dis was as e go for inspection of di highway for Lagos on Monday, following order from Works Minister David Umahi because of safety problems, vandalism and […]

todaySeptember 22, 2026 15

Lagos

Lagos Goment Warns Say Adulterated Palm Oil Full Market

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don warn pipo say contaminated palm oil dey enter markets across di state, as LASCOPA urge consumers make dem dey careful. Dr Nurah Oseni from Auchi Polytechnic explain for Lagos State Food Safety Conference say some sellers dey use harmful dyes, recycled cooking oil and other adulterants to change di colour and quality of palm oil. Oseni advise consumers say make dem no depend […]

todaySeptember 21, 2026 23

Lagos

Lagos Put Body For Patient Safety Untop Non-Communicable Disease

By: Ayobami Dada Lagos Gornment don renew promise to make treatment safer for people wey get non-communicable diseases, as experts dey call for stronger regulation and better healthcare system. Special Adviser to Gofnor on Health, Dr Kemi Ogunyemi, tok say people wey dey live with NCDs need safe, effective and consistent care throughout dia lifetime, adding say patient safety must dey inside every stage of healthcare delivery. Other health stakeholders, […]

todaySeptember 21, 2026 14

Lagos

Jaguda Boys Attack Woman SUV For Festac

Nor be small tin for FESTAC, Over 20 jaguda boys gather on top one woman SUV inside Festac Town on Thursday after one okada rider crash enter her car. Eyewitnesses stand look like film until one good Samaritan run go call police make dem come chase dem away. As by di time wi package dis report, lagos police command never fry mouth, so di full gist never come out.

todaySeptember 18, 2026 16

Lagos

Lagos Lawyers Back Gorment Waka To Stop Street Begiebegie

By: Mariam Ajayi Lagos lawyer association don back di new law wey gornment wan use clear beggars and agbero boys commot for road. Lagos NBA Chairmo, Oga Uchenna Akingbade, naim sorosoke dis mata  inside one public hearing ontop di 2026 Street Urchins Prohibition Bill. Di lawyer boss cry out say di wahala long  pass  Lekki-Epe expressway, as e beg gornment make dem sharp-sharp declare total emergency for all those area […]

todaySeptember 18, 2026 13

Lagos

Lagos Taskforce Vow To Deal With Road Blockers, Okada

By: Ayobami Dada Lagos Taskforce don warn road users and anybody wey dey block public roads or do things wey fit put people life for danger say enforcement go increase for di state. Di Taskforce Chairman, CSP Adetayo Akerele, talk dis one on Wednesday for di agency 2026 Stakeholders’ Engagement Programme wey hold for Safety Arena, Bolade-Oshodi, Lagos. Akerele say dem go enforce di law against okada riders wey dey […]

todaySeptember 17, 2026 15

Lagos

Lagos Lawmakers Konfamate 12 Pipu Wey Gofnor Sanwo Olu Nominate

By: Ayobami Dada Di Lagos State House of Assembly on Tuesday don konfamate 12 pipu wey Lagos State Gofnor, Babajide Sanwo Olu send as nominees to serve for two gorment commissions and one agency for di state. Na di Chairman of di committee, Hon. Mojeed, present di report and talk say di committee carefully check di nominees based on dia qualifications, how dem perform during screening and dia conduct. E […]

todaySeptember 17, 2026 12

Lagos

Nobody Kpai For Di Askident Wey Happun For Otedola Bridge

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don rescue everybody wey involve for di serious askident  wey happen for Otedola Bridge, inward Berger, on Wednesday afternoon, as nobody kpai for di askident. Na two trucks, one trailer, one white Honda car and one Lexus dey involved for di askident as initial check show say one container truck develop mechanical problem as e dey move, di driver kon lose control, jam […]

todaySeptember 17, 2026 13

Lagos

Lagos Assembly Mourns Former Member Kamal Olorunoje

By: Mariam Ajayi Di Lagos State House of Assembly don mourn former member, Honorable Kamal Owolabi Olorunoje, wey kpai on Tuesday morning. Na Honorable Lanre Afinni, wey dey represent Lagos Island Constituency 2, announce di death for Plenary on Tuesday, tok say Olorunoje represent di same constituency for di 3rd Assembly before e later serve for Lagos State Civil Service Commission. Di House kon stand up to observe one minute […]

todaySeptember 16, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds