National

1095 Results / Page 12 of 122

Background

National

NLC, TUC To Do Rally Feb 3 FCDA Workers

By: Esther Ayoola Naija Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) say dem wan do small wi nor go gree, wi nor go gree movement on February 3 to support Joint Union Action Committee (JUAC). Dem tuk am for joint statement wey Benson Upah of NLC and Nuhu Toro of TUC sign for Abuja. Di rally na to support strike wey workers dey for Abuja based on say gornment […]

todayFebruary 2, 2026 3

National

Grammy 2026: Full Winners List

By: Esther Ayoola Di 2026 Grammy Awards don end, and American rapper Kendrick Lamar na di biggest winner of di night, clinching five awards, including Record of di Year for him collaboration with SZA, Luther. Di major categories waka to different artistes as Bad Bunny win Album of di Year, Billie Eilish carry Song of di Year for Wildflower, and Olivia Dean collect Best New Artist. Di Recording Academy present […]

todayFebruary 2, 2026 19

National

New Tax Law Chairmo Oyedele Tell Nigerians To File Tax Returns

By: Esther Ayoola Oga Chairmo of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele don declare say di new tax law need employers and individuals to submit dia tax returns by demselves, dat employers submit reports  b4 March 31 every year. Oga tax dey tuk dis one for one online tuk wey dem organize for HR managers, CFOs, payroll and tax officers, dat, many Nigerians never dey file […]

todayFebruary 2, 2026 5

National

Defence Minister Clear Mata Dat Nigeria Fit Work With Türkiye, US Together

By: Esther Ayoola Wi Minister of Defence, General Christopher Musa (retd.), don share updates on di waka wey dem dey waka for tukiye, say Naija partnership with Türkiye nor get anything to do with our relationship with America. General Musa dey tuk dis tuk for TV sit don tuk, as im clear worries, say defence agreement with Türkiye fit spoil US support. Musa Say, so far di mata concern security […]

todayFebruary 2, 2026 8

National

President Tinubu Shake Table Declare APC Govos As Di Number One Mehn Of Dia State

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don spoil ground, say, all govos wey dey serve under di All progressives Congress na bi di oga of di party for dia states, not ministers, not Senators, not by who tey pass for di party. Vice Presido Kashim Shettima, ni be oga presido mouth piece as im go represent am for Jalingo, take welcome Governor Agbu Kefas enter di APC for […]

todayFebruary 2, 2026 3

National

President Tinubu Hail Fela, Afrobeat Legend

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, don sukilli mouth untop marras dat, Afrobeat oga, Fela Anikulapo Kuti na senior man ni be, and dat im music pass music, afta e win Grammy Lifetime Achievement Award even afta death. Inside statement wey im personally signed, Oga Jagaban describe Fela as fearless, freedom fighter, and revolutionary wey dey fight injustice through im music. Presido say Fela courage, creativity, and conviction […]

todayFebruary 2, 2026 13

National

Imams Beg Gornment, Citizens To Join Hand To Fight Terrorism

By: Esther Ayoola Islamic preachers for Nigeria like dis beg wi gornment oh, say biko nu, dat make gorment try to work closely with religious leaders to fight terrorism. Say normally everybodi suppose join hand, dat, e go hellep promote peace, stop people from turning to bad beliefs, and protect communities. Dem call on everybody make dem support dis kind teamwork to keep everywhere safe as dem run dia three […]

todayFebruary 2, 2026 8

National

Oluremi Tinubu Call For Peace, Respect Among Nigerians

By: Esther Ayoola Wi First Lady, Oluremi Tinubu say, make wi Nigerians, try to dey respect one another, live in peace, and tanda together do brotherliness, no mata our culture or belief. She yarn dis one for her message to mark World Hijab Day 2026, as she encourage pipo, make dem build better understanding and tolerance among themselves. According to di first lady, Nigeria different- tribe doings and religion suppose […]

todayFebruary 2, 2026 6

National

Wike Move Go Court Make Dem Jail FCTA Striking Workers

By: Esther Ayoola For Abuja, FCT Minister Nyesom Wike don apply to National Industrial Court make dem jail any FCTA workers wey go do strike, say na disobedience to court order. Wike say workers resume strike afta court order on January 27 wey stop di action pending final decision on di suit wey government file against dem. Di minister don also get Form 48, wey be court document wey warn […]

todayJanuary 30, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app