National

1427 Results / Page 18 of 159

Background

National

President Tinubu Do Small Cabinet Change, Edun To Pass Baton Oyedele

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve small cabinet reshuffle wey affect two ministers for Federal Executive Council. Minister of Finance, Wale Edun, go hand over to Taiwo Oyedele wey go become new Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy. Also, Minister of Housing and Urban Development, Ahmed Musa Dangiwa, go hand over to Muttaqha Rabe Darma wey don dey nominated as minister designate. […]

todayApril 22, 2026 21

National

VP Shettima Tuk Why Mehn Need Explain President Tinubu Policies

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don go tell Naija tuk, tuk pipo say make dem dey rep dis kontri wella, break down gornment policies, so dat mama Nkechi and baba Bayo go understand for market. Di vice presido yarn dis one for Kaduna during NIPR Week 2026, where dem gather Tuk, tuk pipo from different places, celebrate dem. According to Shettima, Baba Seyi reforms nor go make complete […]

todayApril 22, 2026 16

National

President Tinubu Declare Say No Shakement For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don make am clear say, e nor get how as e go be, say democracy for Naija go stand  fit,  no mata di intimidation. Im yarn dis one when im receive big delegation from Enugu State, wey Peter Mbah carry come State House. Tinubu praise Mbah for di work wey im dey do to fight insecurity and improve health, education, and infrastructure […]

todayApril 22, 2026 17

National

Why Adeleke Make Afro Star Davido Head of Im Re-Election Campaign for Youths

By: Esther Ayoola Afro beat star, Davido don take new role as head of youth mobilisation for Accord Party campaign council for Osun State. Say na im uncle, Governor Ademola Adeleke, na im appoint am as dem prepare for di August 2026 governorship election. Davido share di news for im X page, unto how dem wan take run a smooth campaign and secure victory. According to reports, say na based […]

todayApril 22, 2026 16

National

Yul Edochie Dismiss Peter Obi 2027 Ambition

By: Esther Ayoola Nollywood actor and politician, Yul Edochie, don scarra mouth say Peter Obi nor go fit become President of Naija for dis present time. Edochie yarn dis one for im X page on Tuesday, where e tuk say Obi political strength no strong reach. E sti go ahead press tuk say wetin Obi dey do with African Democratic Congress no go work, say na “dead on arrival” and […]

todayApril 21, 2026 28

National

Police Start Rescue Waka Afta Jaguda Boys Anyhow Doings For Lagos–Benin Highway

By: Esther Ayoola Edo State Police Command don tuk through dia tuk, tuk, ASP Eno Ikoedem, on Tuesday say dem dey run coordinated operation to rescue passengers wey kidnappers carry afta attack for Lagos–Benin Express Road near Iguobazuwa. She explain say di incident happen on April 18, 2026, when suspected gunmen stop public transport motor, open fire, and kpai di driver before dem take control of di situation. Police say […]

todayApril 21, 2026 21

National

Jonathan Defend Him Tenure, Knock Atiku Over Criticism

By: Esther Ayoola Former Presido Goodluck Jonathan don reply di 2023 PDP presidential candidate say im try im best when im dey power as presido. Di Senoir Statesman put dis one for news statement on Tuesady, afta Atiku Abubakar go criticize Bayelsa Man for TV sitdon tuk. Atiku bin say Jonathan no get enough experience dat time and say im make many mistakes as presido.   Meanwhile, Atiku dey contest […]

todayApril 21, 2026 16

National

Transport Workers Hail Abiodun As APC Ogun East Consensus Candidate

By: Esther Ayoola For Ogun State, National President of okada riders, Adebayo Samsudeen, don hail All Progressives Congress (APC) decision to support Governor Dapo Abiodun as consensus senatorial candidate for Ogun East ahead of 2027 elections. Adebayo, for statement wey im release on Tuesday, tuk say di decision match di hope of di people because of Abiodun leadership wey him describe as purposeful and practical for di past seven years. […]

todayApril 21, 2026 15

National

BREAKING: FG Drag Retired Generals, Police Inspector Go Court Over Alleged Terror Plot

By: Esther Ayoola Federal Gornment, through Office of di Attorney-General of di Federation (AGF), say dem don file 13-count charge for Abuja Federal High Court against six people, accusing dem of planning to wage war against Naija and carry out terrorism. Say di charge, na Director of Public Prosecutions, Rotimi Oyedepo (SAN), sign am. Di accused na retired Major General Mohammed Gana, retired Naval Captain Erasmus Victor, Inspector Ahmed Ibrahim, […]

todayApril 21, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds