National

1100 Results / Page 20 of 123

Background

National

President Tinubu Fix South East Roads After Years Of Abandonment

By: Esther Ayoola Minister of Works, David Umahi, say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu handiwork dey show small small for South East Nigeria afta many years of abandoned project. Umahi tuk dis one for weekend afta e inspect several federal road and bridge projects across di South East and South South regions. E say di Tinubu administration dey serious with infrastructure development and determined to complete all important road […]

todayJanuary 19, 2026 5

National

Police Catch Man Wey Help Enugu Native Doctor Kill Six-Year-Old Girl

By: Esther Ayoola Police for Anambra, like jet li don arrest one pikin wey dey work with Enugu native doctor, Obieze Ezeani wey dem dey call E Dey Play E Dey Show, for di abduction and murder of six-year-old girl, According to police tuk, tuk, SP Tochukwu Ikenga, say, Di suspect, Friday Akonobi, 28, dem catch am for Awkuzu early momo on January 17, 2026. SP Ikenga say Akonobi, join […]

todayJanuary 19, 2026 6 4

National

VP Shettima Land Davos To Lead Nigeria For World Economic Forum

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don land Davos for Switzerland to lead Nigeria delegation for 56th World Economic Forum wey go hold from January 19 reach 23, 2026. Before dis, e waka Conakry, Guinea, to represent President Bola Tinubu for di inauguration of President Mamadi Doumbouya last Friday. On arrival, Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar, Minister of Industry, Trade and Investment Dr Jumoke Oduwole, plus officials from […]

todayJanuary 19, 2026 6

National

Police Enter Bush For Osun Jaguda Boys Say Dem Kpai Ex-NURTW Boss

By: Esther Ayoola Osun Police don start investigation into di killing of former NURTW unit chairman, Kazeem Oyewole, wey suspected hoodlums allegedly Kpai for Osogbo on Sunday. Di murder cause gbege for some motor parks as people wey sabi Oyewole dey waka around dey find those wey dem think kill am. Oyewole, wey be part-time chairman of NURTW Aregbe Unit from 2018 to 2022, get attack around Elelede Junction for […]

todayJanuary 19, 2026 7

National

African Ministers Re-Elect Nigeria’s Dele Alake As AMSG Chairmo

By: Esther Ayoola African ministers of solid minerals don re-elect Nigeria Minister of Solid Minerals, Dr Dele Alake, as Chairmo of Africa Minerals Strategy Group (AMSG). Dem re-elect am for di 2026 AGM wey sup for Riyadh, Saudi Arabia, during Future Minerals Forum, afta e don first serve as pioneer chairman since 2024. Speaking on Sunday afta di elections, Alake urge African countries make dem join hand use solid minerals […]

todayJanuary 19, 2026 3

National

HEDA Carry Oyo N30bn Mata Go EFCC

By: Esther Ayoola Di Human and Environmental Development Agenda (HEDA) don carry mata go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) over how Oyo State use N30bn wey Federal Government release afta Bodija explosion for January 2024. HEDA tell aproko pipo on Sunday, say dem dey fear say di money for compensation, reconstruction, and emergency relief no enter wia e suppose enter. According to HEDA, only about N4.5bn of di fund […]

todayJanuary 19, 2026 5

National

Makinde Promise ₦5m Each, Scholarship For Forest Guards Pikins

By: Esther Ayoola Oga Govnor of Oyo state,  Seyi Makinde don announce say im go pay ₦5 million each to di families of di five Forest Guards wey Jaguda boys Kpai for Old Oyo National Park. Makinde tuk dis one when e visit Oloka Village for Oriire Local Government Area to check di place wey di incident happen. In addition, e promise to give scholarship, reach university level for di […]

todayJanuary 19, 2026 4

National

VP Shettima Enter Guinea For President Doumbouya Inauguration

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don waka comot Abuja go Guinea to represent President Bola Tinubu for Guinea Presido, Mamadi Doumbouya inauguration. Senior Special Assistant to VP on Media, Stanley Nkwocha, ni dey konfamate for statement on Friday. Say, di inauguration go happen Saturday, January 18, for GLC Stadium, Nongo, Conakry. Afta Guinea, VP Shettima go travel go Switzerland, Davos, for di 56th Annual World Economic Forum meeting.

todayJanuary 16, 2026 12

National

President Tinubu Hail Baba Bisi Akande at 87, Call Am Pillar of Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu like dis, dey cut cap for senior govo, di b4, b4 govo Osun State  and APC pioneer chairmo, Chief Bisi Akande, as e clock 87 years of age. Tinubu describe am as mentor, ally and strong pillar wey hellep build and sustain democracy for Naija. According to Oga Presido, Baba Akande follow Obafemi Awolowo political ideology and later leave im accountant work […]

todayJanuary 16, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app