National

1427 Results / Page 22 of 159

Background

National

INEC Chairmo to Lead Big Tuk on Nigeria Election Mata for April 29

Chairmo of Independent National Electoral Commission, INEC, Prof Joash Amupitan,  say like dis  dey prepare body to deliver  keynote speech for one big stakeholders meeting wey go talk about Nigeria election process. Di programme dem title am, Law Corridor, one Abuja law firm, naim dey organise am and dat e go shelle  April 29, 2026 for Abuja. According to report,  say big men and women from political parties, civil society […]

todayApril 17, 2026 22

National

President Tinubu Tuk Why Im Nor dey Fear for Di 2027 Election

Wi oga Presido, Bola Tinubu don scata mouth again oh,  say e no dey fear any opposition, as e describe dem as pipo wey just dey make noise and wey nor understand law. E yarn dis one during meeting with Renewed Hope Ambassadors leaders from all 36 states for State House, Abuja on Thursday. Say Na oga of APC govos group, , Hope Uzodimma, wey be DG of the ambassadors, […]

todayApril 17, 2026 19

National

Wike Blast Atiku, Call Am Serial Election Loser

FCT minister Nyesom Wike don blast former VP Atiku Abubakar, call am serial contestant wey dey always lose election. Dis one come after Atiku tuk  for interview say 2027 go be im last chance to run for president and label Bola Tinubu gornment as di worst. Na wia  Wike go inspect project for Abuja, wike take answer  Atiku, say di former vice presido  norbi sincere man, with wetin e tuk […]

todayApril 17, 2026 22

National

APC Chairmo, Yilwatda Press Tuk on Party Structure

APC National Chairmo, Nentawe Yilwatda, don clear mata say  nothing spoil  if more politicians  join di  APC  from opposition side. Im yarn dis one For one media chat wey happen for Abuja, Yilwatda say APC get solid system to manage different interests as membership dey grow. E still add say the party don already prove say dem sabi handle problems, so size nor mata at all.

todayApril 17, 2026 17

National

Akpabio Say Terror Attacks Na Plan To Shake Tinubu Government

Senate Presido Godswill Akpabio don finally tuk wetin do Naija, say all di recent terrorist attacks wey dey hapun for di obodo naija na plan by some people to distract President Tinubu. Im yarn dis one for Abuja during di opening of Naija Revenue Service headquarters. Akpabio even tuk say afta Tinubu win 2027 election, di bomb blasts go stop, say na pipo dey sponsor am.

todayApril 15, 2026 19

National

Vice Presido Shettima Go Greet Governor Nasir Idris For Di Death Of Kebbi Speaker

Vice President Kashim Shettima, on behalf of President Bola Ahmed Tinubu, don go promise families of security officers wey dem kpai for Shanga area of Kebbi State say gornment go stand by dem. Im say di courage and sacrifice of di soldiers and police no go be in vain at all. For condolence visit wey he carry go meet Governor Nasir Idris for Birnin Kebbi, he sti mourn di death […]

todayApril 15, 2026 19

National

President Tinubu Launch New NRS Headquarters For Abuja

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu say, like dis NRS don enter new phase of beta money management, stronger institutions, and economic progress. Baba seyi dey yarn dis one as im go commission new Naija Revenue Service headquarters for Abuja. E say di reforms wey im gornment dey do, dey show beta workings, and dat di country dey move from uncertainty enter “better hope” gradually. Tinubu sti add say di […]

todayApril 15, 2026 18

National

How 28-Year-Old Man Allegedly Kill Him Two Sisters, Daughter For Ondo

Police for Ondo State don start investigation afta one 28-year-old man, Femi Agbeye, allegedly kpai two of im sisters and im 5-year-old pikin for Okitipupa GRA. According to report, di mata start April 8 for dia family house for Doctor’s Road, as reports tuk say di man enter inside, lock door, then carry out di attack. As tori pipo touch light eye witness frequency, dem say, everything hapun inside di […]

todayApril 14, 2026 17

National

Presido Tinubu Hold Emergency Security Meeting Wit Service Chiefs

Wi oga Presido, Bola Tinubu don hold closed-door meeting for Presidential Villa, Abuja with Chief of Defence Staff Olufemi Oluyede and one French General. Say di meeting, na part of beta collaboration to tackle Naija security wahala wey dey ground. Di President sti do emergency security meeting,  join all service chiefs and intelligence heads wey dey di country.   People wey attend include Army, Navy, Air Force chiefs, DSS, NIA […]

todayApril 14, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds