National

1100 Results / Page 27 of 123

Background

National

Govnor Makinde Arrange Im Mehn To Rascal Di Jaguda Boys Wey Attack Oloka

By: Rilwan Agbomeji Oyo State Govo, Seyi Makinde, don condemn di attack wey kill five forest guards for Oloka Village. E talk say di people wey do am go dance ayagayagayagayo, face justice. Di Govo press tuk say na cross-border attack ni hapun, and security agencies don dey work to catch di criminals. E beg residents, especially for Oriire LGA and border areas, make dem remain calm as normalcy don […]

todayJanuary 8, 2026 15

National

NLC Presido knack Akpako Untop New Tax Law

By Ebi Oboko Oga Presido of Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero, don knock the new tax law,  say,  workers nor sabi wetin dey hapun and dat e go put more load on poor pipo. E tuk dis one for Abuja during book launch of former NLC presido Hassan Summonu and im 85th birthday celebration. Ajaero say gornment sideline workers for di tax reform marra, even though na dem dey pay […]

todayJanuary 8, 2026 13

National

Jaguda Bandits Say Enter Area For National Park Office For Oyo, Kill Five

By: Esther Ayoola Gunmen wey people dey suspect say na bandits attack National Park Service office for Oloka, inside Oriire Local Government Area of Oyo State, around 9 p.m. on Tuesday. Konfam gather dat, di jaguda boys enter late for night and attack di office, though reason for di attack never clear. Oyo State Police tuk tuk, Olayinka Ayanlade, confirm di attack, but say police still dey

todayJanuary 7, 2026 11

National

FG Clear Scholarship Marras For Morocco student

By: Esther Ayoola Federal Gornment don scarra tuk say dem abandon Nigerian students wey Morocco on scholarship, say dem nor abandon anybody, di information na false and misleading. Dis one come from statement wey Director of yanings for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, release. According to Minister of Education, Dr Tunji Alausa, all Nigerian students wey dey on valid Federal Gornment scholarship under di Bilateral Education Scholarship Programme before […]

todayJanuary 7, 2026 6

National

Regina Daniels Do Drug Test

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Regina Daniels don break silence on recent controversies wey dey surround her life by undergoing drug test. She reveal dis one on her Instagram page on Wednesday, talk say e follow months of personal struggles and public scrutiny. According to Daniels, di past few months don heavy, nearly overwhelm her, and e make her rethink plenty things for her life. She explain say di decision […]

todayJanuary 7, 2026 18

National

FG: NARD Dispute Na Structural Issue

By: Esther Ayoola Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am. Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release. Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with […]

todayJanuary 7, 2026 6

National

Palace Aide Stop Woman Shake Olu of Warri Hand

By: Rilwan Agbomeji One viral video don show how an aide to di Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III, gently stop one woman wey wan shake di monarch hand for palace lounge. Di 47-second clip wey start trend on Tuesday show di Olu dey waka with im entourage wey dey wear traditional red and white Itsekiri attire. According to palace custom, any subject wey wan greet di Olu no fit […]

todayJanuary 7, 2026 5

National

NASENI Launch Youth Tech Innovation Program

By: Esther Ayoola Federal Gonment don share ogbonge update say dem wan turn Nigeria to global tech house and like dis, dem don officially launch di movement wey dem dey call Di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) Future makers initiative across obodo Naija. Executive Vice Chairmo and CEO of National Agency for Science and Engineering Infrastructure, Khalil Suleiman Halilu, unveil di programme during event wey hold for […]

todayJanuary 7, 2026 9

National

Wetin You Need Sabi About Bank Charge

By: Esther Ayoola Chairmo of di Chartered Institute of Taxation, Abuja District, Ben Enamudu, don clear  Nigerians say, nobodi dey tax anybodi bank balances under di new tax reform. Untop yanings with news tuk tuk pipo on Tuesday, Enamudu, say only some electronic transfers dey attract ₦50 stamp duty. Im say, na wrong tori wey dey spread dey make people fear unnecessarily, say bank go collect tax from account balance. […]

todayJanuary 7, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app