National

1427 Results / Page 25 of 159

Background

National

NDLEA CEO Marwa Clear Security Agencies To Join Hand Against Insecurity

By: Esther Ayoola Oga chairmo and CEO of NDLEA, Mohamed Buba Marwa sef don scata mouth say, all security agencies and civil society need joinbodi for dis fight against insecurity for obodo Naija. Im yarn dis one for Abuja during opening ceremony of Army War College seminar wey focus on how to close intelligence gap among agencies. According to am, if agencies dey share correct informate with each other, e […]

todayApril 10, 2026 19

National

President Tinubu Mourn Soldiers As Terrorists Attack Borno Camp

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don show deep sadness as soldiers from 29 Task Force Brigade under Operation HADIN KAI lose dia lives for terrorist attack wey hapun for Benisheikh, Borno State. Baba Seyi put dis one for im news tuk yesterday, sending condolences to di military pipo and families of di soldiers. U sabi say, Defence Headquarters konfam say dis attack hapun early Thursday morning and […]

todayApril 10, 2026 22

National

Osun Assembly Call For Clean, Free Election For 2026

By: Esther Ayoola Osun House of Assembly don raise concern say make di governorship election wey go happen on August 15 dey free, fair and credible. Dem tuk dis one afta INEC move dia Resident Electoral Commissioner, Mutiu Agboke, go Ondo State. Speaker of di Assembly, Adewale Egbedun, say, whoever INEC go put for di state must follow Constitution and Electoral Act wella. E sti tuk say di sudden change […]

todayApril 10, 2026 17

National

Makinde, PDP Faction Waka Go See ADC For Abuja To Show Support

Oyo State Governor, Seyi Makinde, together with some members of di Turaki-led faction of di Peoples Democratic Party (PDP), don waka go see African Democratic Congress (ADC) leaders for Abuja. Makinde talk say di visit on Wednesday na to show support for ADC leadership and to discuss matter wey dey affect Nigeria democracy. According to Makinde, dem come through consultation and solidarity to help strengthen democratic process for Nigeria.

todayApril 9, 2026 18

National

Why Jos Youths Protest For Plateau Attack Victims

By: Esther Ayoola Say nor be small gbage, as Some youths for Jos North, Plateau State, block di burial ceremony of di Jos attack eviction wey bin dey sup for ECWA church. Wetin con cause di jogolo, dem say, security men arrest three boys wey allegedly bin dey defend di area from di jaguda boys wey come scatta area. Afta plenty protest, army release di three youths, and dem begin […]

todayApril 7, 2026 22

National

Abuja Court Slam 20-Year Jail On Boko Haram Suspect

By: Esther Ayoola Justice Binta Nyako for Federal High Court, Abuja, don sentence some group for jaguda boys wey dem catch terrorism on Monday to jail, some dey get 10 years, some 20 years jail. Sharing di ogbonge update with tori pipo, DPP Rotimi Oyedepo tuk say one of dem, Hamatu Modu, na Boko Haram, wey dey supply di terrorist food. Defence lawyer Aliu Abubakar no fight di case, and […]

todayApril 7, 2026 22

National

Resident Doctors Suspend Strike As Gornment Promise To Pay Arrears

By: Esther Ayoola National Association of Resident Doctors (NARD) on Tuesday announce say dem don suspend dia planned strike afta dem meet with Federal Government of Naija for Abuja. NARD say, gornment don promise to pay outstanding salaries, hazard allowance, and improve doctors welfare, wey be di main reason why dem decide give dialogue another chance. Di suspension come afta emergency meeting of NARD National Executive Council, where dem review […]

todayApril 7, 2026 20

National

Shettima Drop Assurance Again Say Naija No Go Fail

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don promise again oh say make Nigerians nor too worry body about security, say very soon all di gbege go be tins of di past. Oga Vice presido yarn dis one for di final day of di National Police Day parade for Abuja, saying dat reform plus unity go hellep push things forward. Shettima make am clear say everybody gat support police and […]

todayApril 7, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds