National

1427 Results / Page 27 of 159

Background

National

Fear Return For Jos Afta Plateau Curfew Lift

By: Esther Ayoola Tension don burst for Jos, Plateau State again, few hours afta di gornment commot dia 48-hour curfew wey dem put afta di Sunday night attack for Anguwan Rukuba. Eyewitnesses tuk say small-small wahala don start again for different part of Jos, however no bad report say person wunjur or kpai yet. Traders wey just start dia business today run because of fear, as everywia dey rowdy. Plateau […]

todayApril 1, 2026 19

National

Court Clear Turaki, PDP Chairman Arrest Warrant

One ogbonge Abuja High Court on Wednesday don vacate di bench warrant wey dem issue for March 26 for Kabiru Turaki, a factional PDP National Chairmo. Turaki appear for court today, tuk say e return from outside di country, na him lawyer, Chris Uche SAN, yan am wetin dey play. Uche apologise to court say both him and Turaki dey respect court mata wella. Justice Peter Kekemeke grant di request […]

todayApril 1, 2026 25

National

EFCC Nab Abuja Agent Over N288m Fake Property Deal

Economic and Financial Crimes Commission don arrest one Abuja house agent, Hajia Adama Adamu, over alleged property scam of N288 million. EFCC tuk say dem catch Adama Adamu  tru dia  Ilorin zonal officers afta person send petition complain. Dem say, she collect di money from one Alhaji Tanko Yawale, promise say she go help am buy property for Abuja. But afta she collect di money, EFCC say she no fit […]

todayApril 1, 2026 20

National

El-Rufai Show Face For Court As Im Bail Mata Continue

By: Esther Ayoola Former Kaduna governor Nasir El-Rufai don show face for Federal High Court Kaduna dis morning around 9 o’clock as dem continue hearing for im bail matter. Say di Court dey under heavy security as police and Department of State Services officers full everywhere. Yesterday, Justice Rilwan Aikawa shift di case because defence and prosecution lawyers get some legal wahala to settle. El-Rufai lawyers first tuk say make […]

todayApril 1, 2026 20

National

Doctors Threaten To Enter Strike Over Colleague Attack For Ogun

By: Esther Ayoola Nigerian Association of Resident Doctors don raise alarm on Tuesday say danger don dey increase for health workers safety for Naija. For statement wey dia Presido, Mohammad Usman Suleiman, sign, dem say, di latest attack hapun for Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital. NARD condemn di act, say di attack na shocking and barbaric act wey violate human dignity and endanger doctors for work.   Dem explain say […]

todayApril 1, 2026 20

National

Court Adjourn El-Rufai Corruption Case Again

Say nor be small gbege for court as Former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai show face for Federal High Court for Kaduna on Tuesday over alleged corruption case wey ICPC carry come. During di sitting, na so Rufai lawyer, Ukpon Akpan, cut chain follow Justice Rilwan Aikawa say make im step aside for di case dat di judge dey bias but later withdraw di request. Based on di jogolo, di […]

todayMarch 31, 2026 28

National

Tinubu Message National Assembly To Increase 2026 Budget To ₦67.4 Trillion

Wi oga Presido, Bola Tinubu don write National Assembly make dem increase di 2026 budget by ₦9 trillion, from ₦58.4 trillion go ₦67.4 trillion. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for Senate floor on Tuesday. Tinubu tuk say di increase go hellep manage gorment mata wella . E also say e go cover past legal commitments, manage gornment debt, and fund few important projects without stress for domestic […]

todayMarch 31, 2026 22

National

Oga Presido Tinubu Send Letter Of $6B Foreign Loan To Senate

Wi oga Presido Bola Tinubu, don enter senate again dey ask dem to approve $6 billion loan from outside to help run gornment. Na for two separate letters request  him send to Senate President Godswill Akpabio and naim im put dis one and dem read during Tuesday’s plenary. For one letter, e dey seek $5 billion from Abu Dhabi Bank to hellep finance budget. For another letter, e ask for […]

todayMarch 31, 2026 16

National

New Ogun Cp Ojajuni Officially Report For Duty Post

Ogun State new Police Commissioner, Bode Ojajuni, don resume work yesterday for Ogun State say im go ensure law and order Di CP say im go make sure say im officers respect pipo rights and follow law and rules. Ojajuni con sti beg bed di public make dem dey respect police and join hand with dem to fight crime

todayMarch 31, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds