Lagos

Obi: Niger Youths Na Country Biggest Asset

todayAugust 13, 2026 6

Background
share close

By :Kofoworola Olayinka

Peter Obi don describe Nigerian youths as Nigeria’s greatest asset as e celebrate International Youth Day on Wednesday.

Im post on X, di former Anambra govo say gornment must invest more for education, skills, healthcare, technology and better jobs.

Obi also yarn say make young Nigerians no japa leave di country before dem fit fulfil dia dreams.

Im cite two young pilots wey fly am to Bauchi as proof say age no be barrier when youths get opportunity to learn, work and lead.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds