National

1288 Results / Page 37 of 144

Background

National

House, Minority Caucus Gbege Over Tax Law Report

By: Esther Ayoola Na beta gbege ni burst between House of Representatives and Minority Caucus over committee wey dem create to investigate changes for di  Nigeria tax laws. Chairmo of di Minority Caucus committee, Afam Ogene, warn say if dem dismiss di interim report, e go ginger anyhow doings  and weaken National Assembly. House deputy tuk, tuk, Philip Agbese, dey complain say, wetin dem dey report, say other event don […]

todayJanuary 26, 2026 10 38

National

PDP, ADC, LP Knock APC As Kano Govo Jump Party

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Parti, Africa Democratic Congress and Labour Party, say, like dis, dey squeeze wetin nor good for dia face dat All Progressives Congress don finish Nigeria following di defection of Kano State Govo, Abba Yusuf. Di opposition parties tuk say di Kano state Govo move dey smell, and dat na moral failure, and norbi real politics be dat. Untop yarning with tori pipo on Sunday, Labour […]

todayJanuary 26, 2026 11 42

National

President Tinubu Arrange Bags For Türkiye Business Movement

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu go Kawasaki from Abuja dis Monday, go for state visit for Türkiye to boost relations between Nigeria and Türkiye. Na oga presido tuk, tuk, Bayo Onanuga, tuk dis one on Sunday, say di visit na to discuss security, education, social development, innovation, and aviation matas. Dis visit dey follow Turkish Presido, Recep Tayyip Erdogan official visit to Nigeria for October 2021 […]

todayJanuary 26, 2026 9 20

National

Amosun Backs Tinubu Second Term, Says Na South Turn Till 2027

By: Esther Ayoola Former Ogun State Govo and Senator, Ibikunle Amosun don put backings for President Bola Ahmed Tinubu for di 2027 election. Amosun tuk dis one on Sunday for Ake Pavilion, Abeokuta, during im 68th birthday, say afta  North rule Nigeria for eight years under late President Muhammadu Buhari, na South turn. E say make Nigeria respect power rotation, and allow South complete another four years to make am […]

todayJanuary 26, 2026 9 19

Lagos

Discos Comot Hand For FG Free Meter Tuk

By: Esther Ayoola Electricity Power distribution companies, don pull shirt dey laugh wi federal gorment say, di tuk wey Minister of Power, Adebayo Adelabu, yarn dat prepaid meters na free for customer, say na yeye tuk. Operators wey carry aproko wey nor  mention name because of  fear,  tell tori pipo, oga  minister just yarn for political reason and e no ask other pipo wey dey involved, like installers and meter […]

todayJanuary 26, 2026 9

National

National Power Grid Collapse For First Time In 2026

By: Esther Ayoola Say Naija National Power Grid don collapse again on Friday, record first system collapse for 2026, just weeks afta similar incident for December 29, 2025. Power sector officials say di collapse happen nationwide because of technical faults, poor maintenance of transmission lines, and fluctuation for a power generation. Electricity generation crash from over 4,500 megawatts go as low as 24 megawatts by 1:30pm, according to system checks. […]

todayJanuary 23, 2026 7 1

National

President Tinubu Approve New Ambassadors, Send Oke Go France, Are Go US, Dalhatu Go UK

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu, don approve di posting of four ambassador-designates out of di 68 wey Senate confirm last year. According to statement from Special Adviser Bayo Onanuga, Ambassador Ayodele Oke go run marras with France and Colonel Lateef A-re go be United States America. President also name Ambassador Amin Dalhatu as High Commissioner to United Kingdom. Tinubu don even direct Ministry of Foreign Affairs make dem […]

todayJanuary 23, 2026 7

National

UNDP, Operation Hadin Kai Join Hand To Boost Recovery For North East

By: Esther Ayoola United Nations Development Programme (UNDP) and Joint Task Force North East, Operation Hadin Kai don go do beta collabo to strengthen security for North east. Say dem ma don ready to take down any jaguda boy wey nor know imself Dis talk happen for Maiduguri when Head of UNDP North-East Office, Charles Nash, lead im team go pay courtesy visit to Theatre Commander, Maj.-Gen. Abdulsalam Abubakar, with […]

todayJanuary 23, 2026 7

National

Ogun Police Gbab Eight Suspected Armed Robbers

By: Esther Ayoola Ogun State Police Command like commandos don go arrest eight suspected armed robbers wey dey responsible for violent attacks and hijacking of trailer trucks along Papalanto–Ilaro and Owode–Idiroko axis. Police tuk, tuk, Oluseyi Babaseyi konfamate di arrest for Abeokuta, di state capital, and say di operation na sharp doings by di police. Babaseyi say, dem recover one hijacked trailer truck carrying 900 bags of cement plus one […]

todayJanuary 23, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds