National

1288 Results / Page 36 of 144

Background

National

President Tinubu Land Ankara For State Visit

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don land for Ankara, capital of Turkiye, for state visit. Im plane touch ground around 9:03pm, local time, and Turkish gornment pipo wey Minister of Education, Yusuf Tekin lead, ni welcome am for Airport. Nigerian embassy pipo for Turkiye, including Chargé d’Affaires Ambassador Zayyad Abdulsalam, join receive President Tinubu. Untop corner, corner yarnings with tori pipo, Yusuf  say Baba seyi  entering […]

todayJanuary 27, 2026 6

National

APC Konfamate Dat Shettima Remain Tinubu Running Mate For 2027

By: Esther Ayoola Di All-Progressives Congress don clear mata say APC nor get plan to change Vice Presido Kashim Shettima as Bola Ahmed Tinubu running mate for 2027. Na APC publicity secretary, Felix Morka, tuk dis one for TV sit don tuk on Monday. According to Morka, law nor permit dem to start serious election mata for now but di yarnings of changing oga vice presido, na okpata yarnings.

todayJanuary 27, 2026 8

National

Abba Yusuf Explain Why Im Rejoin APC For Kano

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf, don officially return back to All Progressives Congress (APC) on Monday for Coronation Hall inside Kano state gornment House. Big party leaders like former APC National Chairman and former-Kano State govo, Abdullahi Ganduje, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, and Minister Yusuf Ata receive am alongside otherleaders. Governor Yusuf tuk say, im decision na because, e wan work more closely with Federal Gornment […]

todayJanuary 27, 2026 6

National

Court To Decide Minister Wike Fate Today

By: Esther Ayoola National Industrial Court for Abuja don fix today (Tuesday) to give ruling for one case wey FCT Minister, Nyesom Wike, and FCT Administration carry go court against leaders of Joint Union Action Committee (JUAC). Justice E.D. Subilim hear argument from both sides before e adjourn di mata for last sitting. Wike and FCTA dey ask court, make e stop JUAC Chairman Rifkatu Iortyer and Secretary Abdullahi Umar […]

todayJanuary 27, 2026 8

National

CDS Insist Army Must Dey People-Centred, Protect Civilians

By: Esther Ayoola Di Chief of Defence Staff, Gen. Olufemi Oluyede, don repeat tuk say Nigerian Armed Forces go dey people-centred, ethical, and accountable. Im yan dis one for Human Security and Gender Advisers Course wey hold for Abuja through Maj.-Gen Ibrahim Lassa. Gen. Oluyede tuk say, security wahala dey complex, with terrorism, communal fight, transnational crime and humanitarian issues wey dey affect ordinary people everyday. According to Oluyede, di […]

todayJanuary 27, 2026 4

National

Soludo Shut Onitsha Market One Week Over Sit-at-Home

By: Esther Ayoola Anambra State Govo, Professor Chukwuma Soludo, for Onitsha on Monday don order im mehn to lose Onitsha Main Market for one week say traders no follow state gornment order to ignore Monday sit-at-home. Soludo give di directive during on-site visit to the market as e move with aides and other government officials. He warn say dem fit extend the closure if traders still refuse to comply, as […]

todayJanuary 26, 2026 16

National

Governor Adeleke Drop Report Card, Say Former Govo Dey Block Progress

By: Esther Ayoola Osun state govo, Ademola Adeleke don show report card on why Osun state local gorment council never truly see beta change, wey dem desire, say na former gorment ni dey frustrate dem Di Govo yarn dis one for TV sit don tuk on Monday, giving report of di state of things for Osun ahead of di Osun state governorship election Im say All progressives’ councillors for di […]

todayJanuary 26, 2026 8

National

First Lady Tell Nigerians To Protect Environment

By: Esther Ayoola First Lady, Senator Oluremi Tinubu, for Abuja on Monday, don wire wire message to every Nigerians, say  make wi try our best to protect our environment and keep everywhere clean. She tuk dis one  as dem di world dey mark International Day of Clean Energy 2026, with theme “Clean Energy for People and Planet.” Senator Oluremi explain say make everybody dey use renewable energy and sustainable technologies […]

todayJanuary 26, 2026 6 1

National

Naija Health Workers Blame Gorment For Strike

By: Esther Ayoola Di Joint Health Sector Union (JOHESU) for Naija don tell Nigerians on Monday make dem hold Federal Gornment responsible ugly health wahala for di country on why health workers strike JOHESU explain say dia main demand, say na implementation of report on adjustment of Consolidated Health Salary Structure (CONHESS) to improve health workers’ pay. National Secretary, Martin Egbanubi, yarn for one Media sitdon tuk tuk say dem […]

todayJanuary 26, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds