National

749 Results / Page 4 of 84

Background

National

Defence Minister Declare Say New Generals Must Fight Security Wahala

By: Rilwan Agbomeji Di minister of defence, Gen. Christopher Musa (rtd), don tell newly promoted Nigerian army generals make dem bring fresh and better strategies to tackle security wahala for di country. E talk dis one during di decoration ceremony of 28 major generals for Abuja. Musa remind dem say Nigerians dey watch dem and dey expect results, and di security challenges na everybody own, so dem must face am […]

todayDecember 11, 2025 6

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e […]

todayDecember 11, 2025 6

National

President Tinubu Set Up Committee To Pay Contractors Gbese

By: Alice Iduh Wi oga presido bola tinubu don   konfam one  ministerial committee  wey go help  settle di over n4 trillion debt wey gornment dey owe more than  2,000 contractors for di obodo nigeria. Presido  adviser on media and publicity, bayo onanuga,  ni share di  update after federal executive council meeting for abuja. According to onanuga, contractors don dey shout, our moni eh, oh our money and dey protest wi […]

todayDecember 11, 2025 4

National

Fubara Explain Why Im Move To Di APC

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don explain why im cartapot enter di All Progressives Congress, say, im dey carry plenty personal and political wahala because e refuse tell im own side of di tori wey dey cause gbagan for di state. Di governor yarn dis one as e commission di newly expanded Ahoada–Omoku Road for Rivers West, road wey Julius Berger build and wey be part of […]

todayDecember 11, 2025 3

National

Tinubu Open Plan Say Im Wan Use Sea Resources Take Create Jobs

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don drop mata again say contri pipo go join bodi use sea and mami water resources take boost economy, create work, and bring long-term progress. Vice presido Kashim Shettima talk di matt for presidential villa during meeting with senior executive course 47 from national institute for policy and strategic studies. Tinubu direct all ministries and agencies make dem check NIPSS report […]

todayDecember 11, 2025 4 1

National

President Tinubu Ginger Area Say Make Forest Guards Dey Carry Gun

By: Rilwan Agbomeji To deal with all di jaguda bois for inside di obodo Naija, wi oga Presido Bola Tinubu don vex oh, approve forest bodi guards across Naija say dem dey carry kalachi as part of new plan to fight banditry, kidnapping and illegal mining for rural areas. Di announcement come afta Federal Executive Council meeting for Abuja on Wednesday, where Tinubu talk say security matter don reach level […]

todayDecember 11, 2025 11 1

National

Senate Argue About Di Removal Of Police Escort

By: Rilwan Agbomeji Na beta agument shelle for di Nigeria senate on Wednesday,  say  Senator Abdul Ningi cry out as dem collect im escort afta Presido Tinubu order make dem withdraw police from VIPs, while many ministers, big men and entertainers still dey move with police. Ningi ask why di directive no dey affect everybody and say National Assembly no suppose be di only pipo to suffer change. As di […]

todayDecember 10, 2025 9 1

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Rilwan Agbomeji Di Pipos Democratic Parti  National Chairmo,  Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be one house, and dat 29 state chairmen tanda gallant dey await confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja on Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. […]

todayDecember 10, 2025 7

National

Drama As Senate Presido, Akpabio Wish Natasha Akpoti Hapi Birthday

By: Rilwan Agbomeji Small drama happen for senate on Tuesday, e shock  every bodi like konfam shock shock say  Senate President Godswill Akpabio dey celebrate im 63rd birthday con still wish senoir woman Senator Natasha Akpoti-Uduaghan. Say im birthday, na di birthday of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey represent Kogi-central, wey dey 47. As e dey normal for Senate, Akpabio call all di lawmakers wey dey celebrate am to specially recognise […]

todayDecember 10, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app