National

1292 Results / Page 43 of 144

Background

National

Federal Govment Drop All Criminal Charges Against Senator Natasha

By: Rilwan Agbomeji For Abuja on Thursday, High Court don drop all criminal charges wey Federal Govment bin file against Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan, as case wey don trend nationwide finally end. Court papers show say Office of Attorney-General of di Federation drop Notice of Discontinuance, na im make judge strike out criminal defamation and oda charges against di senator. Dis wahala start because of wetin Natasha talk for […]

todayJanuary 15, 2026 8

National

Defence Minister Tell Gumi, Odas, To Comot Bodi From Jaguda Boys Doings

By: Rilwan Agbomeji Defence Minister, Christopher Musa, don go wire sms give cleric Sheikh Ahmed Gumi and odas wey dey support terrorists and bandits say make dem stop any kind support to criminals wey dey threaten Nigeria security. Speakings for Maiduguri on Wednesday, Musa talk say terrorism and bandit mata no be regional, ethnic or religious brotherhood issue. E say anybody wey dey support thief na thief, and Nigerians no […]

todayJanuary 15, 2026 6

National

FG, ASUU Sign New Deal To End Strike, Fix University System

By: Rilwan Agbomeji Wi Federal Govment and Academic Saff Union Universities don sign new agreement to improve University education and stop constant strike for di Obodo Naija. Di new deal replace di 2009 agreement and dem unveil am on Wednesday for TETFUND Conference Hall, Maitama, Abuja, with Education Minister Dr. Maruf Alausa and oda top officials present. Speakings with tori pipo, ASUU President, Prof. Chris Piwuna, talk say despite past […]

todayJanuary 15, 2026 9

National

ASUU Cry Out Over Money Mismanagement For Naija

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don open tuks on why Najia schools dey suffer, say na mismanagement of funds and weak governance for some universities across di country be di problem ASUU President, Professor Chris Pinuwa, tuk dis one for Abuja during di unveiling of di 2025 agreement between Federal Government and di union on Wednesday. Pinuwa warn say di problem dey affect accountability, stability […]

todayJanuary 14, 2026 10

National

Ekpoma Experience Peace After Anti Kidnaping Protest

By: Esther Ayoola Edo State Commissioner for Education, Paddy Iyamu, say, everywhere don calm down for Ekpoma after di plenty wahala wey follow anti-kidnapping protest for di area. U sabi say, news bin report dat,  police arrest some Ambrose Alli University students during di protest. Na ontop TV sit don tuk, Iyamu yarn dis one on Wednesday dat indeed normalcy don return to Ekpoma

todayJanuary 14, 2026 7

National

JAMB Open 2026 UTME, Direct Entry Registration

By: Esther Ayoola Joint Admission Matriculation Board, JAMB, don begin di sales of 2026 UTME and Direct Entry registration forms.= Say, Registration go start from Monday, 26th January go reach Saturday, 28th February, 2026, and di exam go hold for April. According to JAMB website, Candidates must get National Identification Number (NIN) and dem suppose dey at least 16 years old by 30th September, 2026 to fit register. If any […]

todayJanuary 14, 2026 47 16

National

How TETFund Wan Take Share ₦6.452bn Give Varsities, Polytechnics, Colleges For 2026

By: Esther Ayoola Wi Universities office wey dey share money for University Development, TETFund don share update say, dem mana, go share ₦6.452 billion give tertiary schools for dia 2026 intervention project. Executive Seko, Sonny Echono ni dey yarn dis one for Abuja on Tuesday, and  im  tuk am during one stakeholders workshop. According to am, each university go collect ₦2.525 billion, polytechnic go get ₦1.871 billion, while each college […]

todayJanuary 14, 2026 7 9

National

Peter Obi Advice FG To Stop Di New Tax Law First Say Problem Dey

By: Esther Ayoola Di 2023 Presidential candidate of Labour Party, Oga Peter Obi again don advice wi Federal Government say make pause di new tax laws wey dem just gazette, say plenty error and policy wahala full inside am. For statement wey e post for X on Tuesday, Obi tuk say tax expert wey dem call KPMG Nigeria report show problem plenty wahala for di tax reform, say dividend, non-resident […]

todayJanuary 14, 2026 12 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds