National

1100 Results / Page 44 of 123

Background

National

President Tinubu Repeat Im Order Say Make Police Officers Return To Normal Policing

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu don repeat talk again, say make police officers nor guard VIPs again and make dem return back to normal police work. E talk dis one just before e begin federal executive council meeting for state house, Abuja on Wednesday. From aproko wey reach konfam news table say, Tinubu don direct minister of interior make e work with IGP and NSCDC make dem […]

todayDecember 10, 2025 23 1

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Esther Ayoola The Pipos Democratic Parti  national chairmo, Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be  one house,  and dat 29 state chairmen tanda  gallant dey await  confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. he […]

todayDecember 10, 2025 12

National

Vice Presido Shettima Clear Tinubu Security Doings

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido Kashim Shettima don align marras say, president Bola Tinubu nor dey security matter play at all at all. Oga vice dey yan dis one for inside  NISS 18th executive intelligence management course crew for him office for abuja. Say, na about 78 guys including  commandant joseph odama, ni come  drop their final course report for VP. Shettima carry the report, yan say government dey […]

todayDecember 10, 2025 19 1

National

Senate Raise Alarm Say WAEC Wan Stress SS3 Students

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for  di Nigerian Senate, say Naija education  dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of  curriculum and  dat, SS3 students wey  go register for the exam go  write subjects wey dem never even see. Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis  […]

todayDecember 10, 2025 11

National

Wole Soyinka Drag Seyi Tinubu Like Tiger Gen

By: Rilwan Agbomeji Area don spoil for lagos oh, say senoir man, Nobel Laureate Wole Soyinka don cut chain follow Seyi Tinubu , dey ask why im go carry plenty armed security dey waka for Lagos. Soyinka yarn di matter on Tuesday for Lagos as im dey present award give poet Odia Ofeimun, say im count about 15 officers wey carry heavy guns with Seyi. Im even throw small joke […]

todayDecember 10, 2025 17

National

Rivers Govo Fubara Katapot From Pdp to Apc

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don catapot imself from di pipos democratic party to di All Progressives Congress on Tuesday. Di govo by imself, for imself and im pipo announce di move for Government House, Port Harcourt, just few days afta 17 PDP lawmakers also cross carpet to  di APC. Fubara say im even meet President Bola Ahmed Tinubu to inform am about wetin dey shelle for […]

todayDecember 10, 2025 9

National

Osun Govo Adeleke Join Accord Party

By: Rilwan Agbomeji Still on di politcal movement, Osun State Govo, Ademola Adeleke don finally comout with im full chest, say im don join Accord Party to pursue im re-election wey go shelle for  August next year. Governor Adeleke first confirmate  dis mata for im verified x page few days afta e resign from Peoples Democratic Party. For im unveiling as new member, Adeleke tuk say e don actually register […]

todayDecember 10, 2025 5

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Rilwan Agbomeji For abuja,  afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, Mama Remi  dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through […]

todayDecember 9, 2025 11

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,  […]

todayDecember 9, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app