National

1294 Results / Page 49 of 144

Background

National

Regina Daniels Do Drug Test

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Regina Daniels don break silence on recent controversies wey dey surround her life by undergoing drug test. She reveal dis one on her Instagram page on Wednesday, talk say e follow months of personal struggles and public scrutiny. According to Daniels, di past few months don heavy, nearly overwhelm her, and e make her rethink plenty things for her life. She explain say di decision […]

todayJanuary 7, 2026 18

National

FG: NARD Dispute Na Structural Issue

By: Esther Ayoola Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am. Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release. Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with […]

todayJanuary 7, 2026 7

National

Palace Aide Stop Woman Shake Olu of Warri Hand

By: Rilwan Agbomeji One viral video don show how an aide to di Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III, gently stop one woman wey wan shake di monarch hand for palace lounge. Di 47-second clip wey start trend on Tuesday show di Olu dey waka with im entourage wey dey wear traditional red and white Itsekiri attire. According to palace custom, any subject wey wan greet di Olu no fit […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

NASENI Launch Youth Tech Innovation Program

By: Esther Ayoola Federal Gonment don share ogbonge update say dem wan turn Nigeria to global tech house and like dis, dem don officially launch di movement wey dem dey call Di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) Future makers initiative across obodo Naija. Executive Vice Chairmo and CEO of National Agency for Science and Engineering Infrastructure, Khalil Suleiman Halilu, unveil di programme during event wey hold for […]

todayJanuary 7, 2026 9

National

Wetin You Need Sabi About Bank Charge

By: Esther Ayoola Chairmo of di Chartered Institute of Taxation, Abuja District, Ben Enamudu, don clear  Nigerians say, nobodi dey tax anybodi bank balances under di new tax reform. Untop yanings with news tuk tuk pipo on Tuesday, Enamudu, say only some electronic transfers dey attract ₦50 stamp duty. Im say, na wrong tori wey dey spread dey make people fear unnecessarily, say bank go collect tax from account balance. […]

todayJanuary 7, 2026 7

National

Chief Of Army Staff Promise Say Army Go Do All E Fit Do To Stop Terrorist Wahala

By: Esther Ayoola Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Waidi Shaibu, don drop update say Naija  Army go do everything wey human fit do to stop di plenty terrorist attacks for Niger State and other parts of di country. E tuk dis one dis week for Minna, Niger State, during di opening of di 2026 Doctrine and Training Conference for Army Doctrine and Training Command. According to am, di Army dey […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

BREAKING: Court Giv Malami ₦500 Million Bail Con Sti Tell Am Make E Nor Travel

By: Esther Ayoola Justice Emeka Nwite of Federal High Court for Abuja don grant former Attorney General, Abubakar Malami, bail of ₦500 million with two sureties. Di make di judgement on Wednesday say di sureties must get landed property for Asokoro, Maitama or Gwarinpa, and dem go submit dia travel documents to di court. Court also order make Malami drop im international passport and no comot Nigeria without court permission. […]

todayJanuary 7, 2026 16

National

Police Confamate Release of Six Vigilantes Wey Army Arrest For Edo

By: Esther Ayoola Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State. Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State. According to police statement wey come out on Tuesday 6th […]

todayJanuary 7, 2026 11

National

Atiku No Go Step Down, Drag Tinubu

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don tuk say e no go step down for African Democratic Congress (ADC) presidential race. E still accuse President Bola Tinubu say dey try put hand for opposition matter. Atiku, through im media adviser Paul Ibe, call Nigerians make dem no allow All Progressives Congress (APC) scare or weaken opposition. Dis tuk come as people dey speculate say Atiku dey under pressure […]

todayJanuary 7, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds