National

1294 Results / Page 48 of 144

Background

National

Dele Momodu: Atiku No Go Step Down For Obi For 2027

By: Rilwan Agbomeji One Former presidential candidate and Atiku Abubakar close friend, Dele Momodu, don clear marra, say Atiku no go withdraw from 2027 presidential race to support Peter Obi. Momodu talk dis oneĀ  on Thursday while e dey react to political talk for Nigeria, say Atiku join ADC for November 2025 afta e comot from PDP so e fit secure party ticket for 2027 election. According to am, Atiku […]

todayJanuary 8, 2026 8

National

Breaking: Rivers Assembly Start Waka To Comot Govnor Fubara From Office

By: Rilwan Agbomeji Rivers State House of Assembly don start impeachment process against Governor Siminalayi Fubara and im deputy, Ngozi Oduh. During plenary wey dem show live for Television on Thursday, Speaker Martins Amaewhule preside as Majority Leader, Major Jack, read di allegations of gross misconduct against Fubara. Twenty-six lawmakers sign the notice, say di mata involve serious wahala against di Nigerian Constitution. Amaewhule tuk say dem go serve Governor […]

todayJanuary 8, 2026 43

National

Senator Oshiomhole Jim Jim Di Bodi For Okpekpe 10km Race

By: Rilwan Agbomeji Na former Edo State Govnor and current senator for Edo North, Comrade Adams Oshiomhole, say im don dey do jim jim di bodi for Okpekpe International 10km Road Race wey go hapun for May 2026. For one video wey don spread like kolta, Oshiomhole show as e dey waka train with im Okpekpe white T-shirt, show say e cover 8.92km for 85 minutes and burn 492 calories. […]

todayJanuary 8, 2026 15 4

National

NERC: Togo, Niger, Benin Dey Owe Naija N25bn Gbese For Electricity

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) don share update say Togo, Niger, and Benin dey owe Nigeria about N25 billion for electricity wey dem buy from Nigeria grid. NERC tuk dis for dia Third Quarter 2025 report, wey show say di three countries suppose pay $18.69 million but dem don only pay $7.125 million, leaving $11.56 million unpaid. Di regulator explain say di debt dey because these international […]

todayJanuary 8, 2026 19

National

Court Put Ice Block For Malami, Sons 57 Properties

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make government hold 57 properties wey dem say get link with former Attorney-General, Abubakar Malami, and two of im pikin dem, Abdulaziz and Abiru-Rahman. Justice Emeka Nwite give di order afta EFCC carry ex parte application come court on Tuesday. EFCC talk say di properties, wey value reach about N213.2 billion, be money from illegal activities. Dem say di properties […]

todayJanuary 8, 2026 29 4

National

Govnor Makinde Arrange Im Mehn To Rascal Di Jaguda Boys Wey Attack Oloka

By: Rilwan Agbomeji Oyo State Govo, Seyi Makinde, don condemn di attack wey kill five forest guards for Oloka Village. E talk say di people wey do am go dance ayagayagayagayo, face justice. Di Govo press tuk say na cross-border attack ni hapun, and security agencies don dey work to catch di criminals. E beg residents, especially for Oriire LGA and border areas, make dem remain calm as normalcy don […]

todayJanuary 8, 2026 16

National

NLC Presido knack Akpako Untop New Tax Law

By Ebi Oboko Oga Presido of Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero, don knock the new tax law,Ā  say,Ā  workers nor sabi wetin dey hapun and dat e go put more load on poor pipo. E tuk dis one for Abuja during book launch of former NLC presido Hassan Summonu and im 85th birthday celebration. Ajaero say gornment sideline workers for di tax reform marra, even though na dem dey pay […]

todayJanuary 8, 2026 16

National

Jaguda Bandits Say Enter Area For National Park Office For Oyo, Kill Five

By: Esther Ayoola Gunmen wey people dey suspect say na bandits attack National Park Service office for Oloka, inside Oriire Local Government Area of Oyo State, around 9 p.m. on Tuesday. Konfam gather dat, di jaguda boys enter late for night and attack di office, though reason for di attack never clear. Oyo State Police tuk tuk, Olayinka Ayanlade, confirm di attack, but say police still dey

todayJanuary 7, 2026 11

National

FG Clear Scholarship Marras For Morocco student

By: Esther Ayoola Federal Gornment don scarra tuk say dem abandon Nigerian students wey Morocco on scholarship, say dem nor abandon anybody, di information na false and misleading. Dis one come from statement wey Director of yanings for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, release. According to Minister of Education, Dr Tunji Alausa, all Nigerian students wey dey on valid Federal Gornment scholarship under di Bilateral Education Scholarship Programme before […]

todayJanuary 7, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds