National

1294 Results / Page 47 of 144

Background

National

Kwankwaso: I Go Only Join Party If Dem Give Me Top Slot

By: Esther Ayoola National leader of di New Nigeria Peoples’ Party (NNPP), Senator Rabiu Musa Kwankwaso, don say e go only join any political party for 2027 election if dem offer am presidential or vice-presidential ticket. Kwankwaso tuk dis one on Thursday during one Kwankwasiyya gathering wey hold for im residence for Miller Road, Kano, while e dey address ongoing political realignments ahead of di next general elections. E explain […]

todayJanuary 9, 2026 14

National

Ogun Teen Drown Die for Swimming

By: Esther Ayoola Ogun State Police don call for better safety for all recreational centres and swimming pools across di state after 17-year-old boy drown die. Police Public Relations Officer, Babseyi Oluseyi, tuk dis one on im X page on Wednesday, say di warning dey follow recurring drowning incidents for Ogun. Di police spokesman explain say di teenager lose im life during one recent swimming-related accident, wey happen inside di […]

todayJanuary 9, 2026 10

National

I No Declare Presidential Race – Datti Baba-Ahmed

By: Esther Ayoola Former vice-presidential candidate of Labour Party,  Datti Baba-Ahmed,  don clear air say e never declare interest to contest presidency. E tuk dis one on Friday during one media sitdon tuk tuk, say some people twist wetin e tuk. According to am, e no make any announcement at all; e just tuk say e still dey inside Labour Party. E explain say di clarification come because political speculation […]

todayJanuary 9, 2026 13

Entertainment

Ned Nwoko Yarn Say Regina Daniels Negative Drug Test No Mean Anything

By: Esther Ayoola Senator Ned Nwoko on Thursday, yarn say Regina Daniels negative drug test no mean anything, say na temporary abstinence. E post for im X page say recovery no be social media show, and no fit come from just one test result. According to am, short break no solve di real gbege as recovery need time, honesty and professional support. Di statement come from im media team, and […]

todayJanuary 9, 2026 7

National

Edo State To Vaccinate 2.2 Million Pikin For Measles-Rubella Inside Just 10 Days

By: Esther Ayoola Edo State dey plan to vaccinate 2.2 million pikin between 9 months and 14 years against Measles-Rubella as part of Nigeria Integrated Mass Vaccination Campaign. Dr Eseigbe Efeomon, Director of Disease Control and Immunization for ESPHCDA, yarn dis one for Benin City during parley wey dem organize for journalists. Di campaign don start for Northern states Oct 4–27, 2025, and Southern states go run Jan 20 – […]

todayJanuary 9, 2026 7

National

INEC Open Phase Two For Voter Registration For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don drop message for all Lagosian phone, wey never register with INEC, to go do dia voter registration. Resident Electoral Commissioner (REC) for Lagos, Ayobami Salami, ni on di message on Thursday. Say, Di first phase of voter registration end December 10, 2025, but di second phase don start since January 5, 2026, and dey happen for all local government areas […]

todayJanuary 8, 2026 17 2

National

ADC Swear For New Chairmo To Do Constitution Review

By: Rilwan Agbomeji National Chairmo of Africa  Democratic congress, David Mark, don  go swear  Senior Lawyer,  Etigwe Uwa (SAN)  say make im do  Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja. Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles. Im say di party […]

todayJanuary 8, 2026 7

National

Afenifere Don Raise Alarm As Terror Attacks Dey Plenty For Yorubaland

By: Rilwan Agbomeji Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria. For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025. Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo […]

todayJanuary 8, 2026 8

National

US Immigration Gbab Ghana Former Finance Minister Ken Ofori-Atta

By: Rilwan Agbomeji Say US Immigration don gbab Ghana  former Finance Minister, Ken Ofori-Atta, wey dem dey find am for Ghana over corruption matter. According to report, di 66-year-old man dey America since January last year for medical treatment, including prostate cancer surgery. You Sabi say, last year February, Ghana authorities declare am fugitive and later charge am for corruption for November. Im lawyers confamate di arrest, say US Immigration […]

todayJanuary 8, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds