National

1414 Results / Page 54 of 158

Background

National

AICAN Contractors Block Ministry of Finance Over ₦4 Trillion Gbese

By: Esther Ayoola Indigenous contractors wey dey under All Indigenous Contractors Association of Nigeria (AICAN) don block Federal Ministry of Finance for Abuja on Monday. Dem dey protest say gornment never pay di over ₦4 trillion wey dem suppose pay for work wey contractors don finish. AICAN presido, Jackson Nwosu, break di mata for protest ground say dem dey face wahala like debt, say pipo wey dem dey owe dey […]

todayJanuary 19, 2026 19 1

National

VP Shettima Open Nigeria Business Meeting Centre For Davos To Collobi Investors

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don officially open Nigeria House for Davos as 2026 World Economic Forum (WEF) start for Switzerland, tuk say e go hellep attract investors enta Nigeria. He explain say na di first time wey Nigeria go get House for Davos to show di country economic opportunities. Shettima add say Nigeria House go serve as hub wey investors fit meet, discuss business, and make partnership […]

todayJanuary 19, 2026 19

National

Ilorin Enter Mourning As Chief Imam Shaykh Solih Kpai For age 75

By: Esther Ayoola Di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don announce say di Chief Imam of Ilorin, Shaykh Muhammad Bashir Imam Solih, don kpai  early mormor at di age of 75. Di Emir share dis report with tori pipo on Monday afternoon  say dem receive di news with total shock. He describe di late Chief Imam as a man of wisdom, honesty, loyalty and strong dedication to Islam and […]

todayJanuary 19, 2026 11

National

FG Drop New Housing Plan to Tackle Naija Housing Wahala

By: Esther Ayoola Federal Gornment don drop new national housing plan wey go focus on land reform, urban renewal and public–private partnership to tackle Naija housing wahala. Housing Minister Ahmed Dangiwa yarn dis one for Ilorin during di 14th National Council on Lands, Housing and Urban Development meeting. According to am, Nigeria housing problem na based say everybody dey rush come city, population increase nor be here, and high cost […]

todayJanuary 19, 2026 13

National

Oyo Police Start Bush-Combing After Gunmen Kpai Police Officer

By: Esther Ayoola Police for Oyo State don start bush-combing operation to find kidnappers wey carry one Indian expatriate and oda criminals for di state. Police tuk, tuk, Olayinka Alayande, yarn dis one on Monday, say crime don dey reach critical stage for  Oyo State. E say police dey review dia security plans to stop kidnapping and other bad activities for all 33 local governments. News carry say, gunmen kill […]

todayJanuary 19, 2026 9

National

FG Open 2026 Scholar For Petroleum Postgraduate Students

By: Esther Ayoola Federal Gornment don start to dey collect applications for 2026 Petroleum Technology Development Fund (PTDF) Scholarship, wey go send Nigerian postgraduate students go UK, Germany, France, and Malaysia. Office of di Special Adviser to the President on Social Media, Dada Olusegun, ni post for X on Monday. According to di post, Scholarship dey for MSc and PhD students wey dey study oil and gas-related courses. Beneficiaries go […]

todayJanuary 19, 2026 19

National

Uba Sani Console Family Of Bandit Attack Victim For Kaduna

By: Esther Ayoola Kaduna state govo, Uba Sani, don go pay visit to di 44 nigerian army reference hospital for Kaduna, where e console di survivors of di recent jaguda bandit attack wey sup for im state, Sarah Achi and her daughter after dem regain freedom from kidnappers, say jaguda boys kpai her husband, Venerable Edwin Achi. Anglican Archbishop of Kaduna Province, Most Revd. Timothy Yahaya, follow di Governor go […]

todayJanuary 19, 2026 14

National

Tinubu Order Tell Security To Act Fast On Kano Woman, 6 Pikins Wey Kpai For Kano State

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don order full investigation into di killing of housewife Fatima Abubakar and her six pikin for Chiranci community, Kano State, on Monday. Im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk say di President belle nor sweet am at all for di mata, call am barbaric. Tinubu Sha praise police for di quick arrest of di main suspects. Him don direct […]

todayJanuary 19, 2026 24

National

President Tinubu Fix South East Roads After Years Of Abandonment

By: Esther Ayoola Minister of Works, David Umahi, say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu handiwork dey show small small for South East Nigeria afta many years of abandoned project. Umahi tuk dis one for weekend afta e inspect several federal road and bridge projects across di South East and South South regions. E say di Tinubu administration dey serious with infrastructure development and determined to complete all important road […]

todayJanuary 19, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds