National

1294 Results / Page 71 of 144

Background

National

Oluremi Tinubu Don Call Nigerians Make Dem Renew Fight To End Hiv/Aids By 2030

Wi Oga presido wife Senator Oluremi Tinubu, don call Nigerians make dem renew their commitment to end HIV/AIDS by 2030. She talk this one for statement wey she post for her X handle to mark World AIDS Day 2025 with the theme “Overcoming Disruptions; Transforming the AIDS Response.” According to her, the day remind everybody say make we ginger our efforts to finish HIV/AIDS once and for all. She still […]

todayDecember 1, 2025 11

National

FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise

Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […]

todayDecember 1, 2025 12

National

FG Go Soon Name People Wey Dey Finance Terrorism

Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria. Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country. E add say […]

todayDecember 1, 2025 14

National

Gunmen Kill Lady Weh Dey Film Ngige Convoy Attack

One lady wey dem never take identify don shot dead while she dey record attack wey happen for convoy of Chris Ngige, former Anambra governor and ex-minister of labour and employment. Fred Chukwuelobe, Ngige former spokesperson, talk say gunmen ambush di convoy for Nkpor-Nnobi road, Idemili North LGA of Anambra on Wednesday. Chukwuelobe talk say Ngige no dey di convoy when di attack happen. “One policeman for di pilot car […]

todayNovember 28, 2025 8

National

Enugu Govt Cancel Underage Marriage, Arrest Parents, Groom & Matchmaker

Enugu State Govt don cancel marriage wey happen between underage girl, Amarachi, and adult man. Di wedding wey happen for Amufie community, Enugu Ezike, Igbo-Eze North Local Government, don show for social media, wey cause public gbege. Commissioner for Gender, Women and Children Affairs, Ngozi Eni, confirm say di state step in sharp sharp to stop di “illegal and harmful union” wey dem talk say don already happen. Di ministry […]

todayNovember 28, 2025 11

National

FG No Pay Ransom To Free Kidnapped Victims — Senate Talk

Di spokesperson for di Senate, Yemi Adaramodu, don dismiss claims say Federal Government pay ransom to free di schoolchildren wey bandits kidnap for Kebbi and Niger states. E tok dis one for Channels Television Morning Brief on Friday, as public suspicion dey rise about how recent rescue operations take happen. Adaramodu, wey represent Ekiti South, insist say government no give kidnappers any money, even though Bayo Onanuga, Special Adviser to […]

todayNovember 28, 2025 21

National

“My Wife Pregnant, Dem Wan Chop Am” – Edo Couples Cry

One Nigerian couple wey dem kidnap from Aviele Community near Auchi, Edo State don cry out for help. Dem abductors record one chilling video wey show di couple dey beg for help, dey ask dia family, friends and well-meaning Nigerians to pay di N50 million wey dem dey demand. Di husband fear sotay im talk say, “Please help us. Help us…my wife don pregnant and dem wan sleep with her. […]

todayNovember 28, 2025 23

National

“No Excuse!” – Interior Minister Drag Fire Service Officer Over Half-Filled Tank

Interior Minister Olubunmi Tunji-Ojo don drag one officer from di Federal Fire Service afta e see say water tank for one of dia trucks just half-full. Di minister talk say dis kind negligence no gree at all, especially as na harmattan season we dey wey fire fit burst anytime and fit do plenty damage. Tunji-Ojo yarn say firefighters suppose dey ready anytime, dey near areas wey dey high-risk and plenty […]

todayNovember 28, 2025 4

National

FG, States Gats Provide Free Schooling, Lagos Court Don Talk

Federal High Court for Lagos don rule say Federal Government, di 36 states, and di Federal Capital Territory get legal duty to provide free, compulsory, and universal basic education for all pikin wey dey primary and junior secondary school age. Justice Daniel Osiagor deliver di judgement on 9 October 2025 after human rights lawyer Femi Falana (SAN) and Hauwa Mustapha file di case on behalf of demself and di Alliance […]

todayNovember 28, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds