insert_link National Senate Wan Tag Kidnaping As Terror Work By: Rilwan Agbomeji For Wednesday for Abuja, We Senate don run mata again katapot change for di 2022 Terrorism Act say, moving forward, any jaguda wey do kinaping, whether na money take support oh, or na u spiderman wey give informate, or ur work na to hide victim, any how any how so far u dey involve say na death penarity now ooo. Di bill show bodi for di house […] todayDecember 4, 2025 8
insert_link National Sowore Face Court Over Anti-Tinubu Post, Comot On Self-Recognition By: Rilwan Agbomeji Na big gbege shele for Abuja on Tuesday as Omoyele Sowore, land Federal High Court, dey face DSS on top wetin im yarn for post on social media say President Bola Ahmed Tinubu na “criminal.” Di mata serious as DSS drag am for five counts of criminal defamation, and even Meta (Facebook) plus X Corporation (Twitter) join di hot gbege as co-defendants. DSS yarn say Sowore dey […] todayDecember 3, 2025 5
insert_link National Edo Assembly Don Drag 2Baba Wife Come Over Marital Gbege By: Rilwan Agbomeji Edo Assembly don call Natasha Irobosa, Egor lawmaker, make she run go Ethics Committee within one week afta her gbege with 2Baba dey trend hot hot for everywhere. Speaker Blessing Agbebaku tok say wetin 2baba babe do dey disgrace House name and she gats clear herself. Di whole mata don turn hot gist for TV and social media. Assembly yarn say members suppose dey behave well, no […] todayDecember 3, 2025 4
insert_link National Tinubu, Otti Dey Push For Kanu Release! By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don receive Abia Govo Dr. Alex Otti for presdo Villa, Abuja on Tuesday, but di agenda no clear for public yet. Sources yarn say di meeting fit get connection with effort to release IPOB leader Mazi Nnamdi Kanu, wey dem jail for Sokoto prison dey serve life sentence. Dia visit follow Governor Otti own recent waka go Sokoto meet Kanu, wey di matter dey […] todayDecember 2, 2025 7
insert_link National Army Rescue 12 Kidnap Victims As Boko Haram Scatter For Borno! By:Alice Iduh Troops of Operation HADIN KAI don rescue 12 kidnapped people 7 women and 5 pikin wey Boko Haram carry when dem dey travel for Gwoza–Limankara Road on November 14. Army yarn say na for Mandara Mountains, Borno State, dem rescue dem on Sunday after dem run coordinated attack under Operation Desert Sanity IV and Diligent Search. Di soldiers, 26 Task Force Brigade with hunters, vigilantes, and Hybrid Forces, […] todayDecember 2, 2025 8
insert_link 1 National Tinubu Pick Ex-Cds Musa As New Defence Minister After Badaru Quit By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don drop fresh nomination as e pick former Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, to take over Defence Ministry after Mohammed Badaru step down on Monday. Na through letter wey presdo send give Senate Presdo Godswill Akpabio for Abuja, dem take announce di new pick and confirm say Musa na di man to run Defence waka next. General Musa,wey be 58 years old, […] todayDecember 2, 2025 12 1
insert_link National Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat […] todayDecember 2, 2025 7
insert_link National Oluremi Tinubu Don Share 10,000 Sanitary Pads Give Jigawa School Girls By: Esther Ayoola Oga presido wife, Lolo Oluremi Tinubu, don share 10,000 sanitary pads give girl students for Jigawa State. Di gesture come at di time wey stakeholders and UNICEF dey shout make girls take care of themselves during menstruation. According to aproko, this move dey twin with Jigawa State Government ongoing support for women health, as dem dey join hand fight poverty for di region. As she dey talk […] todayDecember 2, 2025 3
insert_link National Tinubu Aide Abubakar Resigns on Health Grounds, President Accepts Letter By: Esther Ayoola Minister of Defence, Mohammed Badaru, don resign from him post with immediate effect, say e no do again and that him no dey feel fine. E write letter give President Tinubu wey carry the resignation and e date am December 1. Special Adviser to the President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, yan this one to TV sidon talk on Monday. Presidential spokesman talk say Abubakar resign […] todayDecember 2, 2025 4