OBODO NAIJA

30 Results / Page 2 of 4

Background

OBODO NAIJA

Fubara Impeachment Wahala – ALDRAP Storm Rivers High Court

By: Rilwan Agbomeji Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) don carry serious marras go Rivers State High Court, beg make dem sharply stop Rivers State House of Assembly from continuing di impeachment wey dem start against Govnor Sim Fubara. For di suit wey dem file on February 10 with number RHC/427/CS/2026 through lawyer S. O. Abang, dem drag plenty big names join including di Attorney-General, Speaker Martins Amaehule, […]

todayFebruary 15, 2026 12

OBODO NAIJA

Jaduga Boys Attack Tungan-Makeri, Kill 6 Pipo

By: Rilwan Agbomeji Gunmen wey dem suspect say na bandits don kill six people for Tungan-Makeri and burn police station for Konkoso, both for Borgu Local Government Area of Niger State. Di attack start around 8:00 p.m. Friday night when more than 200 armed men storm di village, dey shoot anyhow and set many houses on fire. Residents tuk say di attackers operate for hours, kill six people and force […]

todayFebruary 14, 2026 4

OBODO NAIJA

Make Valentine Pipo No Drink and Drive – Plateau FRSC

By: Rilwan Agbomeji Federal Road Safety Corps for Plateau State don drop strong warning to Valentine pipo, say make dem no try drink and drive or do any kain dangerous behaviour for road during celebration. State Sector Commander, Adelaja Ogungbemi, tuk dis one for statement wey Public Education Officer, Peter Longsan, sign on Saturday. According to am, di warning follow directive from di Corps Marshal to make sure say maximum […]

todayFebruary 14, 2026 5

OBODO NAIJA

Turkish Official Defend Tinubu Fall Wahala – Abike Dabiri

By: Rilwan Agbomeji Di palava wey burst for Naija over President Bola Tinubu small stumble during im official visit to Türkiye, Turkish officials don wave am comot hand, call am silly, according to Chairman of Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa. Dabiri-Erewa yarn dis one on Wednesday as she dey answer one post for X from Oguntoye Opeyemi wey talk about how Naija media carry di marras. She talk say, […]

todayJanuary 29, 2026 10

OBODO NAIJA

We No Giv Order Say Make Tear Gas Scatter Protesters – Lagos Lawmakers

By: Rilwan Agbomeji Lagos State House of Assembly don clear members of di House say dem no get any hand for alleged order wey talk make dem fire teargas and arrest protesters for di Assembly gate on Wednesday. No forget say plenti protesters jam di Assembly gate on Wednesday to show say dem nor happy with di demolition wey State Govment do for Makoko area. Di clarification dey inside statement […]

todayJanuary 29, 2026 5

OBODO NAIJA

Jaguda Boys Gbab Youth Leader For Tinubu-Shettima Campaign

By: Rilwan Agbomeji  Jaduga boys wey people dey talk say na bandits don kidnap Ambassador Bashir Isa Gusau, North-West Youth Leader for Tinubu/Shettima campaign for Zamfara State. Di mata first show for public afta security analyst Bakatsine post am for X on Thursday. According to di post, pass 30 Jaguda boys waka enter Gusau house for Gusau town, gbab am as di gbebe dey happen. Gusau family dey distressed like […]

todayJanuary 29, 2026 7

OBODO NAIJA

Minister Wike Warn Striking Workers Make Dem Go Back To Work

By: Rilwan Agbomeji Oga Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don sama beta warning to di striking Federal Capital Territory workers, say make dem behave oh or face legal problem wey get odour. Wike yarn dis on Tuesday as e talk to journalists, afta National Industrial Court order say make di strike stop. According to Wike di court ruling must stand, and dat any person wey dem catch go […]

todayJanuary 28, 2026 17

OBODO NAIJA

Employ 200 Judges Enter Court – Presido Tinubu Yarn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu say, don go send message give wi Senate to  propose 200 more judges for Court of Appeal and Federal High Court. Tinubu say di plan na to make di judiciary strong wella and reduce di plenty cases for court. Dis request dey inside two different bills wey dem read for Senate plenary on Tuesday by Senate President, Godswill Akpabio, as lawmakers resume […]

todayJanuary 28, 2026 10 5

OBODO NAIJA

Shettima Welcome Govo Mutfwang Enter APC

By: Rilwan Agbomeji Vice Presido Kashima Shettima don officailly welcome Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, enter di All Progressives Congress, praise am say na leader wey sabi welfare and peace. You sabi say, Konfam bin report dat Mutfwang dump di Pipos Democratic Parti three weeks ago because of di katakata for di party. For di welcoming ceremony for Jos on Tuesday, Shettima tuk, tuk heaven and earth,  say Mutfwang get […]

todayJanuary 28, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app