OBODO NAIJA

770 Results / Page 33 of 86

Background

OBODO NAIJA

Peter Obi Want Make Dem Touchlight Enugu Air Runway Askident

Peter Obi don show joy after Enugu Air plane run comot from runway as e dey land for Benin Airport, and e thank God say all 68 passengers and crew members come out safe without any injury or death. For statement wey e post for X on Friday, Obi praise di pilot, cabin crew and airport emergency workers for dia fast and professional work wey hellep stop bigger gbege. E […]

todayJuly 24, 2026 13

OBODO NAIJA

US Congressman Want Make Nigeria Release Nnamdi Kanu

One United States Congressman, John James, don renew im call make Nigerian gornment release leader of di banned Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu. James make di appeal while e dey speak for di US House of Representatives on Thursday, as e tok say Kanu continued detention fit be part of religious persecution against Christians for Nigeria. Di lawmaker from Michigan refer to H.Res. 1321, one resolution wey e […]

todayJuly 24, 2026 19

president Bola Tinubu

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Expand Army Reach 12 Divisions

Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve make Nigerian Army increase from eight divisions reach 12 divisions, and make dem recruit 28,000 new soldiers. For statement wey Bayo Onanuga sign on Thursday, e tok say four new divisional headquarters go dey for Makurdi, Ilorin, Jalingo and Benin City. According to wi presdio, dis plan go hellep security agents respond to any threats sharp sharp and to make border security […]

todayJuly 24, 2026 21

OBODO NAIJA

House of Reps Pass State Police Bill

By: Yusuf Abuh House of Representatives on Thursday for Abuja don approve di State Police Constitution Amendment Bill. But dis one na after beta jogolo from some members of di minority caucus wey dey protest say di bill need beta okporlor eyes to look am wella. However, Deputy Speaker and Chairman of House Committee on Constitution Review, Benjamin Kalu, sti press hand for di bill, say di bill na one […]

todayJuly 24, 2026 14

OBODO NAIJA

President Tinubu Rake Full Paper Beta Investment Dey Come For Front

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don nack chest, say im gornment economic reforms dey show beta workings oh, with foreign investors and global eye inside naija economy Im yarn dis as im receive senior men sabi pipo from Aseyori Tinubu Research Group for State House, Abuja. Baba seyi with muscle fry mouth say plenty multinational companies don show interest to invest and partner with Nigeria and […]

todayJuly 24, 2026 16

OBODO NAIJA

Customs say viral recruitment update na fake

By : Jolayemi Olajide Nigeria Customs Service don warn say di recruitment update wey dey spread for social media na fake and no come from di agency. Customs spokesman Abdullahi Maiwada tok for X on Thursday, advise Nigerians make dem ignore di false information. E say Customs go only announce recruitment through dia official communication channels and verified social media pages. Maiwada also beg members of di public make dem […]

todayJuly 23, 2026 21

OBODO NAIJA

Federal High Court Sentence Three Kidnap Suspects To Life Imprisonment Inside Abuja

By : Jolayemi Olajide Justice Salim Ibrahim inside Abuja Federal High Court sentence three suspects on Thursday to life imprisonment for dia link to di abduction of pupils and teachers for Oyo State Oriire Local Government Area, as di judge order make di sentence start count from di date dem arrest dem. Di defense lawyer beg di court for leniency before di sentencing, happening because di convicts plead guilty and […]

todayJuly 23, 2026 21

OBODO NAIJA

South-East Govos Back Tinubu For 2027

By: Yusuf Abuh Imo State Govo Hope Uzodimma don konfamte why all di five South-East govos don agree to support President Bola Tinubu second term bid for 2027. Uzodimma fry mouth after one ogbonge meeting with all five gofnors for Imo state capital on Wednesday. Senior man Uzodinma count say all ogbonge project wey baba Seyi dey do for south east naim be di reason why dem dey support am […]

todayJuly 23, 2026 15

OBODO NAIJA

FG Promise Beta Hajj Terminal For Lagos Airport

By: Yusuf Abuh Federal Government don reassure Nigerians say e go continue to upgrade aviation infrastructure, as work to rehabilitate di Hajj Terminal for Lagos airport don progress well. Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, knack dis tori when im go inspect di upgraded terminal on Wednesday. Keyamo press tuks say di government remain committed to improving airport facilities and giving passengers beta services.

todayJuly 23, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds