OBODO NAIJA

770 Results / Page 35 of 86

Background

OBODO NAIJA

IGP Disu Warn Police Bosses Against Illegal Detention

By: Esther Daniel Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don warn Commissioners of Police across Nigeria make dem stop illegal detention of suspects, abuse of office and any form of misconduct. Di IGP give di warning during meeting wit Police Strategic Managers for Goodluck Ebele Jonathan Peacekeeping Hall for Abuja, where e remind police commanders say discipline and professionalism must remain top priority. Disu tuk say Commissioners of Police get responsibility […]

todayJuly 22, 2026 18

OBODO NAIJA

Court Say FCCPC No Get Power To Issue Telecom Licence

By: Esther Daniel Federal High Court for Lagos don rule say Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) no get legal power to issue telecommunications licences to companies wey dey provide airtime and data-credit services. Justice Ambrose Lewis-Allagoa give di judgment on Monday for Suit No. FHC/L/CS/760/2026, after court hear challenge on FCCPC approval for five firms under di DEON Regulations. According to di court, Di DEON Regulations remain valid […]

todayJuly 22, 2026 17

OBODO NAIJA

Man Carry Customer Motor Run, Police Grab Am For Kano

By : Jolayemi Olajide Adamawa Police don arrest 26-year-old Mohammed Dan-Azumi for Kano State after e allegedly carry customer 2016 Toyota Corolla Sport wey worth about ₦18 million run instead of wash am. Di motor owner report say e hand over di motor give di suspect to wash, but di man disappear with am go where e nor know. Police intelligence officers for Yola quickly launch operation, trace di suspect […]

todayJuly 21, 2026 15

OBODO NAIJA

Tinubu Don Approve New Army Battalion for Kwara

By: Esther Daniel Oga Bola Tinubu don gree make Nigerian Army open new battalion for Omu Aran, Irepodun Local Government Area of Kwara State to help fight bandits, kidnappers, terrorists and oda criminals. Kwara State Govnor, AbdulRahman AbdulRazaq, make di announcement on Tuesday through im Deputy Chief Press Secretary, Mashood Agboola. According to di govnor, di new battalion go bring more soldiers and military equipment come di area to improve […]

todayJuly 21, 2026 13

OBODO NAIJA

FCT Police Boss Warn: No Gree Make Police Search Your Phone

By: Esther Daniel Di Commissioner of Police for Federal Capital Territory (FCT), CP Ahmed Sanusi, don tell residents, especially young people, make dem no allow any police officer search dia phone during stop-and-search operations. E give di warning on Tuesday during one press conference. According to am, di Inspector-General of Police don already ban random phone searches because some officers dey abuse di practice to extort people. Sanusi say no […]

todayJuly 21, 2026 24

OBODO NAIJA

CBN Admit Say Dem Open Dollar, Pound Accounts for Alleged Fake Presidency Council

By: Esther Daniel Di Central Bank of Nigeria (CBN) don confirm say e open two foreign currency account for presidential foreign investment promotion council(PFIPC) Di confirmation come on Monday during House of Representatives public hearing for Abuja. CBN tuk say dem open di accounts after dem receive instruction from di Office of di Accountant-General of di Federation. Meanwhile, Oga Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, appear before ICPC to give […]

todayJuly 21, 2026 25

OBODO NAIJA

Atiku Knock 2026 Budget, Say E No Clear

By: Esther Daniel Former Vice President and ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don condem di 2026 Federal Budget, say e be big  attack on transparency and accountability for Nigeria democracy. For statement wey im media assist, Phrank Shaibu, release, Atiku tok say 84 percent of di entire budget dey inside just 10 Ministries, Departments and Agencies (MDAs), while ₦12.8 trillion dey under di Service-Wide Vote (SWV) for di Ministry of […]

todayJuly 20, 2026 16

OBODO NAIJA

Makinde No Get Weight for 2027 Race – Bwala

By: Esther Daniel Daniel Bwala, Special Adviser to oga  Bola Tinubu on Policy Communication, don tok say Oyo State Govor Seyi Makinde and AAC presidential candidate Omoyele Sowore no get strong political weight ahead of 2027 election. For TV siddon tuk, Bwala tok say all di political calculations no dey favour Makinde, sti add say di Oyo State govo no fit even win presidential election for im own state. Bwala […]

todayJuly 20, 2026 18

OBODO NAIJA

Ogun State King Back Adebutu for 2027 Ogun Gofnorship Race

Senior man Alake and Paramount Ruler of Egbaland, Oba Adedotun Gbadebo, don publicly support PDP gofnorship candidate, Hon. Oladipupo Adebutu, ahead of di 2027 Ogun election. Oba Gbadebo give im support  when Adebutu and im campaign team visit di Egba Traditional Council to collect  royal Avian. Di monarch praise di Adebutu family, describing dem as people wey get long history of generosity and commitment to Egbaland development.

todayJuly 20, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds