OBODO NAIJA

770 Results / Page 37 of 86

Background

OBODO NAIJA

Security Operatives Rescue Kogi Students Wey Kidnappers Carry

By: Yusuf Abuh Kogi State Commissioner for Information and Communications, Kingsley Fanwo, don announce on Thursday say security operatives rescue four students, dia principal and one NECO and hoc staff wey kidnappers carry from one school for Odo-Ekina, Dekina Local Government Area. Di victims bin dey abduct on Tuesday after gunmen attack di school during examination activities. Fanwo tok say Govo Usman Ododo immediately order coordinated security operation, and heavy […]

todayJuly 17, 2026 10

OBODO NAIJA

Police Wire Call To Nigerians Say Make Everybody Surrender Dia Illegal Tools 

By: Yusuf Abuh Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don announce say Nigeria Police don begin nationwide operation to recover illegal guns ahead of di 2027 general elections. Disu yarn dis one on Thursday for Force Headquarters, Abuja, when e receive delegation from di National Centre for di Control of Small Arms and Light Weapons, wey retired Deputy Inspector-General of Police Johnson Kokumo lead come im office  . According to di […]

todayJuly 17, 2026 9

OBODO NAIJA

How Shettima Take Collect APC VP Ticket

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don present Vice Presido, Kashim Shettima with official sabificate to konfam am as APC vice-presidential candidate for di 2027 general election. Tinubu give Shettima di paper during small ceremony on Thursday for im office inside State House, Abuja. Di State House media office release 45-second video wey showing how Shettima enter Tinubu office before e receive di certificate. Dis one sef dey […]

todayJuly 17, 2026 18

OBODO NAIJA

Rescued Oyo Pupil Tuk Say Him No Dey Fear To Resume School

One 15-year-old student, Bello Hassan, wey kidnappers carry from school for Oriire Local Government Area of Oyo State, don finally tell im story after spending 56 days for kidnapper hand. Despite everything wey happen, Hassan talk say, he no dey fear to go back to school. Hassan yarn dis one for journalists on Wednesday for Ogbomoso, shortly after doctor’s discharge am from LAUTECH Teaching Hospital. E talk say after dem […]

todayJuly 16, 2026 16

INEC

OBODO NAIJA

Appeal Court Don Uphold INEC Guidelines for 2027 Election

By Esther Daniel Di Court of Appeal for Abuja don uphold di guidelines wey di Independent National Electoral Commission (INEC) put in place for di conduct of di 2027 general election. For joinbodi judgment wey di court deliver on Thursday, di Appeal Court cancel and set aside di earlier judgment wey Federal High Court give on May 20, wey bin nullify di guidelines. Justice Adebukola Banjoko, wey read di lead […]

todayJuly 16, 2026 23

OBODO NAIJA

“Enough of Condolence Visits!” 2027 Presidency Hopeful Tell Tinubu To Fix Security Now

By : Jolayemi Olajide 2027 presidential hopeful for YPP, Peter Agada, on Thursday urge President Bola Tinubu to quickly change Nigeria security system and stop di rising attacks across di country. Agada make di call for Abuja while reacting to di July 12 attack on Akpachi and Otukpo-Nobi communities for Benue State, where gunmen kill and attack residents. E accuse Federal Government of always visiting victims and making promises after […]

todayJuly 16, 2026 13

OBODO NAIJA

Gbajabiamila Drag Man Go Court, Demand N15bn Over Alleged False Bribe Claim

By : Jolayemi Olajide Chief of Staff to President Bola Tinubu, Femi Gbajabiamila, on Thursday sue Prince Adeniyi Adeyemi Matthew for N15 billion, saying di man spread false story say e demand 48 percent kickback from N27.3 billion government grant. Gbajabiamila tell FCT High Court for Abuja say di allegation no be true and don spoil im name and reputation. E dey ask di court to order di defendant to […]

todayJuly 16, 2026 16

OBODO NAIJA

Inflation Slow Small, But Food Price Still Dey Pepper Nigerians

By : Jolayemi Olajide Nigeria headline inflation rate drop small to 15.91 percent for June 2026 from 15.93 percent for May, as National Bureau of Statistics, NBS, announce di latest figures on Thursday. NBS tok say dis na di first time inflation go reduce after e rise continuously for three months since March, with di slight drop driven by lower core inflation. Despite di improvement, food inflation climb from 16.96 […]

todayJuly 16, 2026 15

OBODO NAIJA

Shettima Tuk Say Nigeria No Get Reason To Poor

By Esther Daniel Vice Presido Kashim Shettima don say Nigeria no get any reason to dey poor despite di country's rich natural resources. Speaking for one agriculture summit in Abuja, e compare Nigeria with Indonesia, saying Indonesia make more money from palm oil exports dan Nigeria earn from crude oil in 2025. Shettima also tuk di Niger Delta get huge potential for fish farming and other marine businesses wey fit […]

todayJuly 16, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds