OBODO NAIJA

770 Results / Page 81 of 86

Background

OBODO NAIJA

Makinde Say No Panic As PDP Governors Dey Jump Ship

Oyo State Govo, Seyi Makinde say e no shake am say governors dey leave PDP, even though di party now get only two governors left. Zamfara Govo, Dauda Lawal announce on Monday say e don dump di party, leaving Makinde and Bauchi Governor Bala Mohammed as di only PDP governors. Makinde tuk dis one for PDP Board of Trustees meeting for Abuja, say di period na tough time for di […]

todayMarch 11, 2026 29

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order 100,000 CNG Kits To Make Transport Cheap

Wi oga Presido Bola Tinubu don wire message say make dem deploy 100,000 CNG conversion kits for next two to three weeks as option to di hike of petrol price. Dis one dey come after meeting for State House, Abuja with Ismaeel Ahmed, Chairmo of Pi-CNG. Say, Tinubu wan make CNG dey everywia, so dat transport go cheap for Nigerians.  

todayMarch 11, 2026 25

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Send FCT 2026 Budget

Presido Bola Tinubu don send 2026 Federal Capital Territory budget go Senate make dem approve am on Tuesday. Im still ask Senate make dem confirm Taiwo Oyedele as Minister of State for Finance to replace Dr Doris Uzoka-Anite. Baba also want make Senate approve Magnus Abe as chairman of Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission. Senate Presido Godswill Akpabio na im sha read all di letters for Senate floor during plenary, […]

todayMarch 11, 2026 34

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Say Nigeria Don Overcome Economic Wahala

Wi oga Presido, Bola Tinubu  say Nigeria don overcome all di economic wahala under im gornment. Im yan dis one  for Presidential Villa, Abuja, when im  host religious and traditional leaders for interfaith breaking of fast. Say like dis, state govos no dey run go bank again to take loan to pay workers salary, say, indeed all im reforms dey work wella.

todayMarch 11, 2026 26

OBODO NAIJA

Ondo Governor Warn Kidnappers And Dia Sponsors

Ondo state govo, Governor Lucky Aiyedatiwa don sama warning  say any pesin wey dey sponsor terrorism or kidnapping wey dem go catch go face prosecution. Im tuk dis one wen e meet leaders of Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN) for im office for Akure, Ondo State. Aiyedatiwa still say e dey worry am say one community don get three kidnapping cases for just two months, and dats […]

todayMarch 11, 2026 22

OBODO NAIJA

NRC Touch Light How Jaguda Boys To Beat UI Lecturer

Di Nigerian Railway Corporation (NRC) say, dem go investigate, after dem hear say Jaguda boys beat lecturer for University of Ibadan, Dr. Mikail Abdussalam, for Obafemi Awolowo Train Station, Moniya, Ibadan. NRC Managing Director, Dr. Kayode Opeifa, put for statement on Tuesday say, harassment or any bad treatment of passengers no dey acceptable railway business. Opeifa say anybody wey do anyhow wey dem catch go face disciplinary action according to […]

todayMarch 10, 2026 30

OBODO NAIJA

Godswill Akpabio Hail Nigerian Women

Senate Presido, Godswill Akpabio don congratulate Nigerian women as di world mark International Women’s Day, hail dem for dia strength and di big sacrifices wey dem dey make for family and society. For statement wey im media tuk tuk Eseme Eyiboh release, di Senate President talk say Nigerian women dey try well well every day to build better society and support dia families. Akpabio talk say im na big beneficiary […]

todayMarch 8, 2026 26

OBODO NAIJA

Beta Security Don Land – Army Chief Shaibu Yarn

Chief of Army Staff, Waidi Shaibu, don assure pipo wey dey communities wey bandit dey attack for Benue State say make dem stand fit, say dem dey tidy security wella. Shaibu tuk dis one during im first operational visit to army formations for Makurdi. E reveal say dem don already deploy more soldiers join di ones wey dey ground to support di operation. According to am, di extra troops go […]

todayMarch 6, 2026 34

OBODO NAIJA

Kano Assembly Explain Why Dem Wan Impeach Deputy Governor Aminu Gwarzo

Kano State House of Assembly don start impeachment process for Deputy Governor Aminu Gwarzo, dem dey accuse am say e dey misuse office. Dis  yawa dey sup after Governor Abba Yusuf kawa go join All Progressives Congress from New Nigeria People’s Party. Di Majority Leader, Lawal Dala, carry di motion come for plenary wey Speaker Ismail Falgore dey lead. Dala talk say dem dey do am follow Section 188 of […]

todayMarch 6, 2026 33

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds