OBODO NAIJA

770 Results / Page 82 of 86

Background

OBODO NAIJA

How FAAN Change Cashless Policy Follow Tinubu Directive

According to update from wi international airport say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu no really cancel di cashless policy wey Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) introduce, but say, make dem adjust am to make life easy for Nigerians. U sabi say for FEC meeting on Wednesday, Aviation Minister Festus Keyamo bin  say, Baba Seyi  order, make dem stop di policy immediately. Addressing tori pipo for Lagos on Thursday, […]

todayMarch 6, 2026 29

OBODO NAIJA

Four Police Officers Chop Sack Over Owode-Onirin Market Killings

Four police officers don lose dia job after dem go involve demselves  for di killing of seven traders for Owode Onirin market, Lagos, for August 2025. Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, na im dey align di mata give tori pipo on Thursday, say dem take part for di unlawful killings. Jimoh explain dat, di traders dem kpai during fight wey hapun between landgrabbers and traders for Owode-Onirin area. Jimoh  […]

todayMarch 6, 2026 30

OBODO NAIJA

First Lady Charge Wives Of Govos To Hellep Grassroots Pipo

First Lady, Senator Oluremi Tinubu don charge state First Ladies to show workings, ensure say dem, dey hellep pipo wey nor too get and ensure economic stability. Mama Oluremi dey hammar dis mata for di first quarter meeting of di Renewed Hope Initiative coordinators on Thursday. she challenge dem make dem take bold action to hellep dia states.

todayMarch 6, 2026 24

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Order To Stop Airport Cashless Policy

Wi oga Presido, Bola Tinubu don order make dem immediately stop di cashless payment system wey dey operate for federal airports. Dis decision come out after meeting of di Federal Executive Council on Wednesday. According to Aviation Minister Festus Keyamo, plenty passengers dey miss dia flights because di system dey cause serious delay. And dat like dis Because of di suffer, suffer wey Nigerians dey face, di Presido say make […]

todayMarch 5, 2026 36

OBODO NAIJA

Dangote Raise Petrol Price, Pump Fit Hit N1,000 Per Litre

Dangote Petroleum Refinery don raise dia factory price of petrol from N774 to N874 per litre. National Publicity Secretary of di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, Chinedu Ukadike, na im share dis update on Monday. Based on dis, Say petrol fit cost between N980 and over N1,000 per litre for motorists depending on wia dem dey across Nigeria. Ukadike explain say di increase na because of di wahala for […]

todayMarch 3, 2026 56

OBODO NAIJA

DSS Arrest Man Wey Get Connect To Di Attack On Peter Obi For Benin City

Di Department of State Services, DSS don arrest one man, Udeme Monday Stephen, wey dem dey suspect say e plan di attack wey hapun for Benin City, Edo State, against 2023 presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, on February 24. U sabi say, Jaguda boys attack Obi and some ADC chiefs wey bin dey do meeting to welcome former governorship candidate Olumide Akpata join dia party. According to report, […]

todayMarch 3, 2026 33

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Direct Private Sector To Package Naija Gas infrastructure

Wi oga Presido, Bola Tinubu don clear wi Infrastructure Concession Regulatory Commission say make dem run di National Gas Infrastructure Command Centre (NGCC) as Public-Private Partnership (PPP) way, say gorment nor wan put serious money for di project. DG of di commission, Dr Jobson Ewalefoh, na im dey conversate dis mata inside for dia first Project Steering Committee meeting. NGCC na big national plan wey go monitor and manage Nigeria […]

todayMarch 2, 2026 38

OBODO NAIJA

2 Kpai, 14 Wunjor As One 3-Storey Building Collapse For Lagos

Lagos State Emergency Management Agency, (LASEMA), don rescue six pipo afta one building collapse for House 29, Oriwu Street. Di workers wey dey di site na labourers, and di building collapse happen around 4 pm, cause still dey under investigation. Untop yarnings with tori pipo, Lagos State Police tuk, tuk, Benjamin Hudenyin, konfamate say na two pipo don kpai and dem recue 14 and  carry dem go Lagos Island General […]

todayMarch 2, 2026 27

OBODO NAIJA

Wike Defend FCT Election Curfew, Say President Give Im Blessings

Nyesom Wike don talk say di curfew wey dem put for Federal Capital Territory before di council election na correct decision. For one media chat for im office on Monday, im say as “governor” of di FCT, im get power to declare curfew, and say Bola Tinubu sef approve am. Wike clear mata say di February 21 area council election go well beta style and di security measure no be […]

todayMarch 2, 2026 34

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds