obodo oyinbo

429 Results / Page 13 of 48

Background

obodo oyinbo

America, Iran Exchange Fire Again As Hormuz Tension Dey Rise

By : Jolayemi Olajide   Nor be small high tension wire for di middle east, dat  America and Iran dey test power again  around Strait of Hormuz over the weekend. Normally  di two both country agree ceasefire. According to US Central Command (wey dem call Centcom) dem do self defence  against Iranian military targets after Iran based on dem say dem say, go  shoot down one American drone for international […]

todayJune 1, 2026 13

obodo oyinbo

Israel Capture Beaufort Castle As Di War Enter New Level For Southern Lebanon

By: Esther Ayoola Say like dis, Israel military don take over di strategic Beaufort Castle for southern Lebanon. Prime Minister Benjamin Netanyahu call dis one big “turning point” for dia attack on Hezbollah. Dat Isreal ground troops sti dey move enter deeper, inside Lebanon, pass di original boundary wey be Litani River. UK, France and Germany don criticize Israel latest military move, while Israel army sti dey tell more people […]

todayJune 1, 2026 10

obodo oyinbo

Iran Clear US Dat Dia Hand Nor Go Dey Any Deal Wey Nor Go Respect Iran Right

By: Esther Ayoola Iran chief tuk, tuk person, don declare say dem no go accept any deal with United States unless e fully protect rights of Iranian pipo. According to report, Donald Trump bin send tougher new proposal go back to Tehran. For di Iran pipo, dat any change for di agreement wey nor follow go spoil everytin and di Strait of Hormuz go remain close, dis one mean say […]

todayJune 1, 2026 14

obodo oyinbo

Russian Drone Crash Enter Romania Apartment, Wunjure Two Pipo

By : Jolayemi Olajide Romania and dia NATO frens  don  cut chain after Russian drone go  jam  Romanian airspace and crash for apartment building for eastern town Galati, wunjure two pipo. Na Romanian Foreign Ministry tuk dis tuk,  say di incident wey hapun during overnight attack on  Ukraine,  say e spoil international law. According to Authorities say dem track the drone before e finally crash ontop  per house, cause fire.

todayMay 29, 2026 7

obodo oyinbo

Israeli Airstrike Kpai 10 Pipo for Gaza, Even Children Nor Escape am

At least 10 pipo, including five childrenis, na im kapi after Israeli airstrike hit one residential building for Gaza City. Israel military talk on Thursday say dem carry out di strike as part of operation to target “two central Hamas terrorists” for Northern Gaza. Di suspected target of di attack na Hamas battalion commander Imad Asleem, wey reportedly kpai together with im teenage daughter Israa, dem later bury dem on […]

todayMay 29, 2026 12

obodo oyinbo

13 Kpai For China Highway Crash

By: Esther Ayoola At least 13 people don die and 3 others injure after minibus jam truck for highway accident wey happen for Henan province, central China, early Thursday morning. China traffic police tok say di crash happen for G40 expressway near Nanyang city, as di bus carry 16 people instead of 9 wey am suppose carry. According to di police, di bus jam truck for di major road wey […]

todayMay 28, 2026 9

obodo oyinbo

Fire For Kenya Girls School Dorm Kill 16

By: Esther Ayoola Fire wey catch girls dormitory for Utumishi Girls Academy for Nakuru County, Kenya, don kill at least 16 people while 73 others dey hospital. Police source wey tuk to AFP say di fire start around 1 o’clock early Thursday morning as more than 220 girls bin dey sleep for di hostel. Emergency workers, ambulance people and rescue teams quickly reach di school to help victims and carry […]

todayMay 28, 2026 9

obodo oyinbo

Israel Fire Southern Lebanon, Kpai 31 As People Dey Run For Dia Life

Israeli army don go kpai  at least 31 pipo and wunjure 40 others for southern Lebanon on Tuesday, say  dem launch heavy air and ground attacks across di area. Dis na according to Lebanese health officials, say  Israeli military also warn residents for several towns and villages for southern and eastern Lebanon make dem commot immediately. Dat dem ma take down all  Hezbollah fighters, like say dis fighters nor be […]

todayMay 27, 2026 10

obodo oyinbo

Iran Vow To Fight Back As US Bomb Dia Base

Iran don point finger say United States America dey misbehave, say why dem go break di ceasefire agreement wey dem get. Iran say dem nor dey fear anybody, dat, dem go look America eye ball to eye ball, tell dem word, dat which kind nonsense say, dem agree something den America con dey do sometin different. Say US  go drop bomb for dia missile sites and boats. Tehran Supreme Leader, […]

todayMay 27, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds