obodo oyinbo

429 Results / Page 14 of 48

Background

obodo oyinbo

Naija and Türkiye Sign Big Deal to Take Mining to Next Level

By : Jolayemi Olajide Naija and Türkiye don sign fresh agreement for Istanbul to join hand work for solid minerals and mining mata. Nigeria Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, naim use im yamchop mouth break di news say Baba Tinubu support di movement. Alake say di country don ready to work with the Turkish gornment to change how they dey manage mining, train pipo, and bring beta development. […]

todayMay 26, 2026 11

obodo oyinbo

How Israel Heavy Bombing Kpai 11 Pipo For Lebanon

By : Jolayemi Olajide Israeli air strikes don go kpai at least 11 pipo and wound 15 others inside eastern Lebanon, as the small peace agreement between them dey face big trouble.The attack block di village of Mashghara inside Bekaa Valley on Monday night, and Lebanon government news konfam say everywia scatter.Prime Minister Benjamin Netanyahu tuk say im give order make army drop heavy bomb join after Hezbollah pipo do […]

todayMay 26, 2026 13

obodo oyinbo

Tragedy For Philippines, Four Kpai As Nine-Storey Building Collapse

By: Esther Ayoola Emergency officials for Northern Philippines don stop de two-day rescue operation to find at least 12 pipo wey dem believe say dey trap inside one collapsed building. Dis nine-storey building collapse put for one hotel near Angeles City on Sunday, and e don kill four pipo so far, including one Malaysian man and two construction workers. According to report, dem bin dey get hope say dem go […]

todayMay 26, 2026 10

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Warn Say AI Fit Bring Modern Slavery

By : Jolayemi Olajide Pope Leo XIV don call for better control of artificial intelligence, warning say di fast-growing technology fit create new forms of slavery if dem no handle am well. For him first encyclical titled “Magnifica Humanitas,” di Pope warn against di global race to build more powerful AI systems just for political and business dominance. He present di document for Vatican alongside AI experts including Christopher Olah, […]

todayMay 25, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Insist Say Iran Deal Still Need More Time

By : Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump don drop micro soft word again oh,  say confusion sti gadima, dat  Iran nor gree peace deal oh. Na im  workers for White House naim dey porpori dis mata  on sunday,  say, as dem dey look am with corner eye, say di final agreement fit take some days before e go  set. According to wetin one Al Jazeera reporter for Washington, DC […]

todayMay 25, 2026 12

obodo oyinbo

China Back Cuba, Tell US Not To Use Red Eye Follow Any Country

By : Jolayemi Olajide China don backup Cuba say di way United States take drag cuba 94-year-old former leader, Raul Castro, go court over murder case, nor make brain at all. Di US dey worry Castro say im join hand take shoot down two civilian planes for 1996, plus say he plan to kill American pipo. China foreign ministry tatafo, Guo Jiakun, fry mouth say US nor suppose do like […]

todayMay 22, 2026 16

obodo oyinbo

UN Enter DRC Sharpaly With Medicine To Rascal New Ebola Outbreak

By : Jolayemi Olajide United Nations agencies don enter eastern Democratic Republic of Congo (DRC) with emergency medicine and body cover to block di new Ebola virus make e no spread. UN tatafo person, Stephane Dujarric clear matas say Ituri province na di main base where di sickness don cover. And dat to make di waka easy, di UN peacekeeping group (MONUSCO) don release four motor and one helicopter to […]

todayMay 22, 2026 13

obodo oyinbo

Belle Dey SweetSake of Say Trump Wan Follow Am Yarn

By : Jolayemi Olajide Taiwan Presido, William Lai Ching-te don talk say him belle dey sweet am to yarn with US Presido, Donald Trump, say na move wey fit scatter over 40 years diplomatic protocol and fit vex China. Trump tell tori pipo on Wednesday say e go call Lai, as White House dey plan to sell heavy weapons and arms package giv Taiwan. Since Trump return from im meeting […]

todayMay 21, 2026 12

obodo oyinbo

Marco Rubio Call For New Relationship Between United States

By : Jolayemi Olajide United State Secretary of State, Marco Rubio don bring new proposal for relationship between United States and Cuba, as e talk say dem fit give $100 million food and medical support. For video message wey e send go Cuban people on Wednesday, Rubio talk say dis plan fit open new door between Washington and Havana as di money go hellep solve food and drug wahala wey […]

todayMay 21, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds