Politics

139 Results / Page 10 of 16

Background

Politics

First Lady Launch Women Support For Baba Re-election!

First Lady Senator Oluremi Tinubu don launch one new political group wey dem dey call Tinubu Torchbearers (TTB) for Abuja on Wednesday June 3, to start solid mobilization for President Bola Tinubu re-election work. Mama Tinubu charge all di APC women leaders make dem carry di "Renewed Hope Agenda" story go down to di grassroots, wards, and polling units across di country. She yarn say women na di heartbeat of […]

todayJune 4, 2026 15

OBODO NAIJA

Datti Baba-Ahmed Leave Labour Party Finally For PRP

By : Jolayemi Olajide Yusuf Datti Baba-Ahmed don waka comot from Labour Party enter Peoples Redemption Party (PRP). Im tuk dis one for one podcast on Wednesday, say Peter Obi suppose first settle Labour Party gbege before e im piante comot di party. Datti clear mata say e no be Obi shadow, na im own mind dey guide am. Normal say goat dey follow farmer, nor mean say goat go […]

todayJune 3, 2026 21

Politics

Governor Fubara Brother eye di top political seat for Rivers

By : Jolayemi Olajide Ambassador Blessing Fubara Senior, Governor Siminalayi Fubara senior bro, don declare for Port Harcourt say im dey kamkpe for the Rivers governorship race under NDC flag. The man yarn dis one with im yamchop mouth give tori pipo say he carry full energy come to restore peace for rivarians Fubara Senior dey drop this hard tuk, after Im younger Bro Sim face beta frustration for di […]

todayMay 28, 2026 17

OBODO NAIJA

How Senator Adeola Take Use 300k Votes Take Win Ogun APC Governorship Ticket

By : Jolayemi Olajide Senator wey dey represent Ogun West, Solomon Adeola, don win di APC ticket to contest for di 2027 governorship election for Ogun State. Oga Chairmo of di primary election committee, Wale Ohu,  naim announce di result for Abeokuta afta Adeola pack 304,055 votes, while his opponent, Abayomi Hunye, get zero vote. Out of di 305,287 voters wey come out to vote inside di 20 local government […]

todayMay 22, 2026 18

OBODO NAIJA

Governor Oyebanji And 11 Others Sign Peace Paper For Ekiti Election

By : Jolayemi Olajide  Baba govo of Ekiti State, Biodun Oyebanji on Thursday don promise say everywia go soft and peace go reign before, during, and afta di June 20 governorship election for Ekiti State. Oyebanji tuk dis one for Ado-Ekiti inside one meeting wia im and 11 other governorship candidates sign peace paper for di election. Di National Peace Committee and INEC naim  arrange di peace meeting, and big […]

todayMay 22, 2026 30

OBODO NAIJA

Road Clear For Ogundu Chinda, After Fubara, Others, Comot For Rivers Governorship Race

By : Jolayemi Olajide Di road don clear well-well for di 10th National Assembly lawmaker wey dey represent Obio/Akpor Federal Constituency, and kinsman of FCT Minister Nyesom Wike, Ogundu Chinda to carry di governorship ticket of All Progressives Congress (APC) for Rivers State. Di road clear after Governor Siminalayi Fubara, Alabo George-Kelly and Tonye Cole comot dia body from di APC Governorship primary race wey go hold on Thursday. Fubara, […]

todayMay 21, 2026 14

OBODO NAIJA

NNPP Threaten Say Dem Go Do Mass Protest Over Inec Screening Delay

  By: Jolayemi Olajide di New Nigerian pipos party don threaten mass protest for Abuja say if INEC nor stop delaying dia primary screening across Nigeria. Di party oga, Dr. Boniface Aniebonam, dey claim say INEC's slow action dey cause heavy political tension and dey ground dia internal preparations nationwide. NNPP warn say although dem pause protest before to stop hoodlums, dia patience don finish small, small. Dem dey demand […]

todayMay 21, 2026 20

OBODO NAIJA

Tinubu Appoint Professor Segun Aina As New Jamb Registrar

By: Jolayemi Olajide President Bola Tinubu don appoint Professor Segun Aina to replace Professor Is-haq Oloyede as JAMB Registrar when im final tenure expire on July 31, 2026. Professor Aina, wey go turn 40 in July, na expert for digital infrastructure and examination systems from Obafemi Awolowo University. Di Presidency note say Aina get deep experience for admissions management dating back to im NYSC days with di board. E go […]

todayMay 21, 2026 18

OBODO NAIJA

Natasha Akpoti-uduaghan Collobi Pdp Kogi Central Ticket

By : Jolayemi Olajide Senator Natasha Akpoti-Uduaghan don collobi di Peoples Democratic Party candidate for Kogi Central senatorial ticket for di 2027 general elections. Na Thousands of supporters across 57 wards comout in dia konfam her candidacy during a party primary on Wednesday. U sabi say, di Senator don do one term and dis one sef go be di second time wey she go do di senator tin for her […]

todayMay 21, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds