south west

102 Results / Page 11 of 12

Background

Lagos

Governor Sanwo-Olu Ginger Lagos Storytellers to Do More

By Ebi Oboko Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy. The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move […]

todayJanuary 7, 2026 28 2

Lagos

Two Kpai, Six Wunjor For Lagos Road Accident

By Ebi Oboko Unto badness wey sup on new year day, say na Two people na kpai and at least six others wunjor for different road accident wey happen for Lagos on New Year’s Day. According to Lagos state Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) oga, Adebayo Taofiq, say, one crash happen for Iyana Itire, Oshodi side, when Volkswagen commercial bus jam Toyota Sienna, wey make two people die. For […]

todayJanuary 2, 2026 31 2

National

Ondo Govo ginger mehn police to Guide Area

By  Ebi Oboko Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA. The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026. Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so […]

todayJanuary 2, 2026 19

Lagos

Lagos First Lady Waka Hospital To Welcome Lagos First Pikin Dem For 2026

By Ebi Oboko First Lady of Lagos State, Dr Ibijoke Sanwo-Olu, on Thursday waka go different public hospitals for Lagos to welcome the first babies of 2026. She and Deputy Govo wife, Oluremi Hamzat, celebrate three newborns, Baby Oluwadare, Baby Adegeye-Abiodun and Baby Daramola for Ibeju-Lekki, Imota and Gbagada General Hospitals with prayer and gift presentation. Dr Sanwo-Olu tuk say pikin wey dey come for beginning of new year, na […]

todayJanuary 2, 2026 39 2

Lagos

New Year Fire Scarra Four Shops for Ikotun, Lagos

By Ebi Oboko Unto 2026 new year  day  updates, Say Four electronics shops for one building wey nia Transport Company for Ikotun, Lagos, don burn down early mormor for New Year Day. According to report Everything for di shops, including washing machines, TVs and generators, don destroy. Di cause of di fire, nobodi know, but people dey suspect say na faulty electric circuit. And as the time Konfam news package […]

todayJanuary 1, 2026 20

south west

Southwest States Join Hand Launch “Joint Show Of Force” To Tackle Highway Banditry

By: Esther Ayoola Oyo, Ogun and Lagos states don join hand launch joint security operation to stop banditry and wahala for highways and towns for southwest. Di operation, wey dem call “joint show of force,” dey target high-risk roads like Lagos–Ibadan expressway make commuters, residents and businesses safe, as police begin di exercise from Lagos side go Ojoo, Ibadan on Monday. CP Fatai Owoseni (RTD), special adviser to Governor Seyi […]

todayDecember 23, 2025 22

south west

Governor Adeleke explain say im sti love PDP

By: Alice Iduh Osun State Governor, Ademola Adeleke,  don reacts to tuk say im  abandon Pipos democratic party  after im use dem climb, now don run go  Accord Party. Ontop yanings for tv sit down tuk, the govo say im nor abandon any parti, say in fact,  im still love PDP, but wahala inside the party push am to find better platform for him 2026 re-election. Adeleke say he try […]

todayDecember 11, 2025 38

south west

Adeleke Dey Block PDP Governorship Pick — Sani

By: Alice Iduh DI Peoples’ Democratic Party chieftain Umar Sani don accuse Osun State Govo, Ademola Adeleke, say na him dey block PDP from choosing who go run for govo as election dey near. Sani talk on Friday say Adeleke dey chase im own political interest and no send PDP matter, even talk say di govo dey use PDP inside wahala take hold ground because of signature wey Independent National […]

todayDecember 5, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds