Sport Yarns

112 Results / Page 13 of 13

Background

Entertainment

Shakira Link Up Burna Boy, Tease New World Cup Gbedu “Dai Dai”

By: Jolayemi Olajide Colombia music queen, Shakira don drop  2026 World Cup gbedu, dem title “Dai Dai”, shoot small video for Brazil Maracana Stadium yesterday. Di Colombian singer wey sing 2010 “Waka Waka”,  team up with Nigerian artiste Burna Boy to produce di song. For di 67-second video, Shakira enter di  pitch of Maracana for Rio de Janeiro, after she perform free concert for Copacabana Beach last Saturday. Di song […]

todayMay 8, 2026 86

Sport Yarns

Trump Reject $1,000 World Cup Ticket, Say E Too Expensive

By: Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump don scata table say, even im sef nor go pay $1,000 ticket price to watch USA vs Paraguay for 2026 World Cup opener. Di tournament go start June 11, with US, Canada and Mexico as co-host, while USA go begin dia campaign for Los Angeles on June 12. Trump tell media say im no even know say ticket reach dat amount, but im  […]

todayMay 8, 2026 23

Sport Yarns

Aston Villa Wipe Forest 4-0, Enter First European Final In 44 Years

By: Jolayemi Olajide Aston Villa don qualify for dia first European final in 44 years, beating Nottingham Forest 4-0 for dia Europa League semi-final second leg on Thursday. Dem overturn di 1-0 first leg loss as Ollie Watkins score before half-time, while Emiliano Buendia add another one through penalty after di break. Captain John McGinn finish di job with two late goals to seal di win for Villa wey end […]

todayMay 8, 2026 24

Sport Yarns

PSG Knock Bayern Out, Qualify For Back-To-Back Champions League Final

By : Jolayemi Olajide Paris Saint-Germain don qualify for another Champions League final after dem hold Bayern Munich to 1-1 draw on Wednesday night. Ousmane Dembele naim  score first  inside three minutes after sharp counter-attack before PSG defend strongly for the rest of the match. Bayern Munich try pressure PSG  and finally Harry Kane later score equaliser, but the goal no fit save the German side. PSG carry the semi-final […]

todayMay 7, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds