Sport Yarns

112 Results / Page 11 of 13

Background

OBODO NAIJA

Dangote Reveal Why E No Buy Arsenal, Choose Finish $20bn Refinery Instead

By : Jolayemi Olajide Africa richest man, Aliko Dangote, don reveal say e abandon im plan to buy Arsenal F.C. because e need di money to complete im $20 billion refinery project for Lagos. Dangote make di disclosure during one podcast interview with Nicolai Tangen, where e explain say Arsenal value na around $2 billion when e seriously dey consider takeover. Di billionaire businessman talk say at dat time, e […]

todayMay 14, 2026 40

Sport Yarns

Foden Warn Arsenal Say Many Things Fit Happen For Final Day

By : Jolayemi Olajide Manchester City star boy, Phil Foden don yarn warning give Arsenal say Premier League title race fit still go down to final match day before e clear. Foden yarn dis one with Sky Sports after dem beat Crystal Palace 3 Kondo, on Wednesday night. E yarn say, di aim na to keep pushing and to mount pressure on top Arsenal head.

todayMay 14, 2026 20

Sport Yarns

Tobi Amusan Grab Naija  First Gold for African Championships for Accra

By : Jolayemi Olajide Nigerian sprint queen Tobi Amusan don win Nigeria first gold medal for Senior Athletic Championships wey dey hapun for Accra on Wednesday. She outrun every other person for women 100m hurdles, while her fellow Nigerian Adaobi Tabugbo carry bronze medal for di same race. Na di third African Championships gold medal be this for Amusan, and Sebastian Coe personally hand am the medal. Before di race, […]

todayMay 14, 2026 18

Sport Yarns

Jake Paul Make Plans To Retire Afta Joshua Scatter Im Jaw

By: Esther Ayoola Say like dis now, Jake Paul dey plan retirement from combat sports afta di YouTuber beating from Anthony Joshua. Say di 500 wey touch back in dat December fight sti dey make im head dey shake. For dia last fight last December, Joshua knock am out brutally. Di fight leave Paul with broken jaw wey force am undergo corrective surgery. Since den, di American boxer never return […]

todayMay 13, 2026 21

Sport Yarns

Jason Collins, First Gay NBA Player, Die at 47

By: Esther Ayoola Former NBA player Jason Collins don kpai for age 47 afta im battle with brain cancer, im family announce am. According to report, say e kpai afta wetin dem describe as “valiant fight” against glioblastoma, serious brain cancer wey no get cure. According to NBA announcement wey BBC report on Wednesday, Collins first reveal for 2025 say him get di sickness afta him begin get problem with […]

todayMay 13, 2026 11

Sport Yarns

Tinubu, CAF Boss Motsepe Meet for Kenya Summit to Discuss Nigerian Football

By : Jolayemi Olajide E belike beta dey come oh as Wi oga Presido Bola Tinubu and CAF Presido, Patrice Motsepe do small two aside for Nairobi Kenya, just after di Africa Forward Summit meeting on Tuesday. For di meeting, Nigeria Football Federation president Ibrahim Gusau, former NFF boss Amaju Pinnick and CAF acting secretary-general Samson Adamu also join Motsepe and Tinubu. According to Gusau, say dem discuss how dem […]

todayMay 13, 2026 24

Sport Yarns

Team Nigeria Start Strong for Accra Athletics Grabbing  2 Medals for Opening Day

By : Jolayemi Olajide Team Naija dey represent wetin nor good for di  2026 African Senior Athletics Championship, for Accra, Ghana,  wining  two medals for opening day. Na for women discus event, Divine Oladipo wey dey do her first international outing for Nigeria carry silver medal. Another athlete, Obiageri Amaechi, also add to di success as she win bronze medal for di same event. Team Nigeria dey expect more medals […]

todayMay 13, 2026 18

Sport Yarns

Real Madrid Presido, Florentino Pérez Clear Doubters Say Im Nor Dey Resign

  By: Jolayemi Olajide Real Madrid presido, Florentino Pérez don drop micro soft word say e no dey step down,  despite all di rumors. After a trophyless season, di 79-year-old boss call emergency press conference to clear di air. Pérez come accuse some Spanish media houses say dem dey run wicked  campaign against am. Say like dis im wan contest for another team as Presido of di world biggest football […]

todayMay 13, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds