Sports

802 Results / Page 8 of 90

Background

Sports

Mo’ Salah Celebrate Birthday For World Cup

Unto World cup updates, Belgium and Egypt play 1-1 draw for dia World Cup opener on Monday, as Belgian second-half equaliser spoil Mohamed Salah birthday wey turn 34. Emam Ashour naim score first for Egypt early for first half inside Seattle. Romelu Lukaku enter as substitute, naim con force Egypt player Mohamed Hany to score own goal wey level di match. With di result, Egypt still dey find dia first […]

todayJune 16, 2026 13

Sports

Edo Queens Lift NWFL Title After Dem Hold Bayelsa Queens

Edo Queens don win Nigeria Women Football League (NWFL) 2025/26 title after dem draw goalless with Bayelsa Queens for final Super Six match for Port Harcourt. Di result give dem enough point to carry di trophy as dem already dey on nine points before the game and just need one point to seal am. Na coach Moses Aduku team second league title in three years, showing say dem still strong […]

todayJune 15, 2026 13 15

Sports

Japan Snatch Late Draw As Dem Hold Netherlands

Japan show strong fighting spirit for di FIFA 2026 world cup, coming back twice to force Netherlands play 2-2 draw for dia opening  match for Texas on Sunday. Netherlands captain Virgil van Dijk naim score first with fine header, but Keito Nakamura quickly equalise for Japan. Crysencio Summerville later put di Dutch ahead again with a beautiful goal after one hour of play. As Netherlands begin feel say dem don […]

todayJune 15, 2026 10

Sports

Okocha Collect Special FIFA Award

Super Eagles legend Augustine ‘Jay-Jay’ Okocha don collect one special “Superior Player of the Match” award from FIFA for im beta doings against Spain wey im show for di 1998 World Cup. Di award, wey Michelob ULTRA and Copa90 collabo give am, na to honor players wey show dem-sef for World Cup games before di official Player of di Match award start for 2002. Di senior play naim post for […]

todayJune 12, 2026 19 2

Sports

Bellingham Tuk Wetin Spoil England Euro

By: Shalom Ovie England midfielder Jude Bellingham don talk say Three Lions squad dey more united and connected as dem prepare for dis summer World Cup. Im say na beta wire, coach Thomas Tuchel to connect di quard compare Euro 2024, wey some tins no go well. According to Jude, too much expectation from fans and outsiders contribute to di problem.

todayJune 12, 2026 12

Sports

South Africa Finish With 9 Men 

Mexico don show workings, start dia 2026 World Cup journey with 2–kondo win over South Africa for opening match wey hapun for Estadio Azteca. Na so south Africa players eavy for ground, nor fit carry body for di game, na so Mexico take advantage, three red cards come out, make South Africa finish with nine players for field. Julian Quinones naim score di first goal for di tournament while Raul […]

todayJune 12, 2026 7

Sports

Mboko Knee Injury End Serena Queen’s Club Comeback Run

By: Shalom Ovie Serena Williams comeback for Queen’s Club doubles don jam rock oh, as her partner Victoria Mboko don withdraw from di tournament. Williams and Mboko bin win dia first-round match on Tuesday, as Serena return to tennis after four years break.Dem suppose face Leylah Fernandez and Laura Siegemund for quarter-final on Thursday Mboko pull out after she injure her left knee during her singles match against Karolina Pliskova […]

todayJune 11, 2026 13 7

Sports

Portugal Beat Super Eagles

Nigeria super eagles fall hand and leg go  lose 2-1 to Portugal for international friendly match. Pedro Neto open naim open di scoring for Portugal before Akor Adams equalise for Super Eagles to make am 1-1. Later, substitute Francisco Conceição bend one fine shot enter net to restore Portugal lead and seal di win. Di result mean Portugal go enter di World Cup with back-to-back victories.

todayJune 11, 2026 12

Sports

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome

Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite di rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more dan 100 fans celebrate am […]

todayJune 10, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds