Sports

443 Results / Page 2 of 50

Background

Sports

Super Eagles To Buy Waka To Rabat For AFCON Semis

By Ebi Oboko Unto update for AFCON, say Super Eagles go waka from Fes go Rabat on Monday afternoon for dia semi-final match wey dem go play against AFCON 2025 host Morocco. Team media officer Promise Efoghe na im yan one. On Sunday, Super Eagles don return Fes and dem do recovery session by 6:15pm for Saardienne football complex. Now, all the players and officials go travel to Rabat,  ready […]

todayJanuary 12, 2026 8 2

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 7

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 10 2

Sports

New Chelsea Boss Rosenior Face FA Cup Test

By: Esther Ayoola Liam Rosenior go start im first match as Chelsea manager dis weekend when e carry di Blues go face second-tier Charlton for FA Cup third round. Di FA Cup match dey tagged risky, as football pundits warn say small clubs fit shock big teams anytime. Tottenham manager Thomas Frank dey London dey fight to save im job, afta di team show poor form for Premier League. Meanwhile, […]

todayJanuary 9, 2026 6 1

Sports

I Go Pay Super Eagles Bonus If FG Fumble – Ndidi

By: Esther Ayoola Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, don yarn say if FG no pay team dia 2025 AFCON bonuses before Saturday, e go pay dem by imsef. FG, through Minister Doris Uzoka-Anite, don promise say dem go fast-track payment Thursday–Friday. Ndidi tuk say e dey push team to train well since second game, and e don promise players and staff say e go cover di bonuses if government fail.

todayJanuary 9, 2026 9

Sports

Anthony Joshua Pay Tribute Giv Im Padi Dem Wey Kpai For Motor Crash

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don pay heartfelt tribute to im two padi, Latif Ayodele and Sina Ghami, wey kpai for car crash on December 29 for Naija. AJ get small wunjury inside di accident, hospital discharge am, return back England, then later come back attend dia burial for last Sunday. E call dem “brothers” and “great men”, tuk say na only afta di crash,  e sabi how special dem […]

todayJanuary 9, 2026 3

Sports

CAF To Run WAFCON Draw 2026 Fixtures For Morocco

By: Rilwan Agbomeji Confederation of African Football (CAF) share update say di Women African Cup Of Nations  2026 final draw go hold for Rabat, Morocco on Thursday, January 15. According to CAF official post on X, Di draw go start 2pm local time (1pm GMT) For di same day, CAF go announce winners for Women Coach of di Year, Interclub Player of di Year, and Women Club of di Year […]

todayJanuary 8, 2026 6

Sports

FG Promise To Clear Super Eagles Bonus, Say Money Go Enter Friday

By: Rilwan Agbomeji Unto update for di Super Eagles bonus marra, say, Federal Government don  agree to  approve money for di Super Eagles match bonus wey concern AFCON 2025. Minister of State for Finance, Doris Uzoka-Anite, tuk say players go begin see di money for dia bank accounts from today or tomorrow. Before now, Super Eagles players bin threaten say dem no go travel for dia quarter-final match because allowance […]

todayJanuary 8, 2026 3

Sports

Adesanya Say E Nor Dey Enter Go Boxing

By: Rilwan Agbomeji UFC former two-time middleweight champion Israel Adesanya don share update on how im wan waka, say e nor go switch go boxing afta e finish for mixed martial arts (MMA). E yarn dis one during one Question & Answer session for Thailand, say e wan finish e career for UFC. Adesanya tuk say, e bin think about boxing small because of money, but e feel say MMA […]

todayJanuary 8, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app