Sports

529 Results / Page 2 of 59

Background

Sports

Anthony Joshua Set To Return To Boxing For July

By: Esther Ayoola Anthony Joshua dey plan return to boxing for July afta e survive serious car askident for Naija wey kpai two of im close friends, Sina Ghami and Latif Ayodele. Im promoter, Eddie Hearn, sha tell reporters say, di man never ready physically yet. Di March fight wey im suppose fight and fight with Tyson Fury dey cancel because of  say im never ready for fight. However, Joshua […]

todayFebruary 24, 2026 2

Sports

Sesko Fire United To Fourth with 1-0 Win Over Everton

By: Esther Ayoola Manchester united fine form don continue as Benjamin Sesko come off di bench helping im team beat Everton 1 kondo for Monday night Premier League football match. Dis win sti keep Michael Carrick unbeaten, since e start to coach United. Sesko neva start any of Carrick six games but e dey fire wetin nor good, since Ruben Amorim comot for Manchester for January. Di Slovenian, wey score […]

todayFebruary 24, 2026 5

Sports

Why Galatasaray Dey Struggle To Pay Osimhen And Im Team Mates

By: Esther Ayoola Reports say Galatasaray dey struggle to pay players salary for Turkey, including Nigerian striker Victor Osimhen, because of dia high wage bill. According to Turkish newspaper, say Some players never collect dia salary for di past two to three months. Afta dem beat Juventus 5–2 for home last week, Galatasaray lose 2–0 away to Konyaspor, and dis don make pipo dey touch light dia frequency. Osimhen, wey […]

todayFebruary 24, 2026 5

Sports

Arsenal Eze & Gyökeres score Twice, Hammer Tottenham 4-1

By: Esther Ayoola Arsenal face show wetin nor good for London derby, two players, Eberechi Eze and Viktor Gyökeres, score two goals each as dem hammer Tottenham 4-1 for Sunday Premier League match. Eze start di scoring for 32nd minute, but Tottenham quick come back as Randal Kolo Muani score 122 seconds later. Afta half-time, Gyökeres show im form with fine goal from outside di box. Both Eze and Gyökeres […]

todayFebruary 23, 2026 4 2

Sports

Four Premier League Players Face Racist Abuse For Social Media

By: Esther Ayoola Wolves striker Tolu Arokodare and Sunderland winger Romaine Mundle, say, fan drag dem wetin nor gud, do dem racist untop social media. Dis dey come afta Burnley midfielder Hannibal Mejbri and Chelsea defender Wesley Fofana sef receive abuse afta dem draw 1-1 for Stamford Bridge. Wolves don express dia frustration say belle nor sweet dem as bad belle pipo racially abuse Arokodare afta im miss penalty and […]

todayFebruary 23, 2026 7

Sports

NPFL Matchday 27: Rivers United, Enyimba Draw 1-1 As Plateau United Carry 4-1 Win Against Shooting Stars

By: Esther Ayoola Unto results for Matchday 27 for di 2025/2026 NPFL, Rivers United and Enyimba play 1-1 draw for Adokiye Amiesimaka Stadium on Sunday. Abiodun Joseph score first for Enyimba for 28th minute, but Aniekeme Okon equalize two minutes before half time. Ikorodu City still dey top table even though, dem draw 1-1 with Bayelsa United as Olanrewaju Molade score afta Ettah Ikoi open di scoring. Plateau United carry […]

todayFebruary 23, 2026 4

Sports

Kamaru Usman Drop Retirement Plan

By: Esther Ayoola Kamaru Usman don make am clear say e go only retire only afta e win both welterweight and middleweight UFC titles. Aproko pipo bin tuk say Kamaru don near retirement afta e loss to Leon Edwards and Khamzat Chimaev, but Usman shock everybody afta beating  Joaquin Buckley. U sabi say, Na im dey chase senior fighters like Conor McGregor and Amanda Nunes untop di wining of belts. […]

todayFebruary 20, 2026 16

Sports

President Tinubu meet Sports Commission Oga, Promise More Support for 2026

By: Esther Ayoola Chairmo of National Sports Commission, Shehu Dikko, on Thursday don go visit oga Presido Bola Tinubu for Presidential Villa for Abuja to clear am how sport perform for 2025 and plan for 2026. Afta di meeting, Dikko tell State House tori pipo say di visit na normal routine, because na direct to di  President, di commission dey report. According to am, baba seyi promise to continue supporting […]

todayFebruary 20, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app